Olu of Warri coronation: Ogiame Atuwatse III tok about im journey to become king and oda controversy wey follow before im coronation

Wetin we call dis Video, Olu of Warri exclusive

For dis exclusive interview with BBC Pidgin, di 21st Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III tok about im journey to becoming king, controversies wey follow and im plan to lead.

Di king wey bin speak with BBC Pidgin just before im coronation clear di air on di mata of di controversy of di missing crown.

"First of all wen you say di crown, several crowns dey, plenty crowns dey, you know exactly which one?

"Because dem get label too. So wen you put out dat kain tori you need to be careful.

"I fit no know say dem carry one of di crowns, so if I say now say no crown dey miss, pesin fit come out to say;

"Actually dat particular one, maybe pesin no dey pay attention and dem break di window come carry am from di glass case where e bin dey.

"And dis na police mata too and part of am dey court too so dat na my response to dat."

Di prince also add say di mata no go in anyway affect di coronation ceremony of Saturday, 21, August, 2021.

"E no go anyway affect di coronation, Warri pipo dey very dramatic and animated.

"And I tink say dis process na very dramatic and animated one.

"In all humility I tink say e go do very well as Nollywood feem." E tok.