Retirement Hell: Why many Nigerian pensioners no fit see dia pensions collect
BBC Africa Eye go undercover to torchlight Nigeria pension system wey dey corrupt and no dey work, and wey put many elderly pipo for condition wia dem dey sick wit no money, yet dem go give politicians big retirement packages.
Reporter Yemisi Adagoke travel to Cross River State to meet "Ghost Pensioners" - elderly pipo wey di state say dem don die, so as not to give dem dia pensions.
Some of dem dey forced to rely on financial support from dia relatives and collect bad treatment from state officials wey dem dey beg to give dem back dia pensions.