‘Pipo dey feel say I no know wetin I want for life’ - Angela Omodia

Wetin we call dis Video, ‘Pipo dey feel say I no know wetin I want for life’

Bouncer work for Nigeria na one work say pipo believe say na for man but dat one don dey change as women too don dey enta di work.

Angela Omodia na one of di female bouncers for Lagos and she follow BBC News Pidgin yarn how she take start di work and di gbege wey she dey face for di work.

Angela na graduate of Catering and Hotel management and she don dey do di bouncer work for ova 10 years and she say ‘if I die and get opportunity to come back, I go still like to do dis work’.