Beyoncé: Meet Papi Ojo, di Nigerian boy wey teach Beyoncé how to Gbese and do di Legwork

Wetin we call dis Video, Meet Papi Ojo, di Nigerian boy wey teach Beyoncé how to Gbese and do di Legwork

Nigerian dancer Stephen Ojo don achieve one of im biggest dreams for life afta im dance inside di music video of ogbonge singer, Beyoncé.

Stephen wey pipo as Papi Ojo no only dance inside Beyoncé latest song, “Already”, im also teach di singer how to do di famous Nigerian dance steps, di Legwork and di Gbese.

Stephen wey believe dis na just di starting point for am, dey ginger oda young dancers for di country to dey post correct content for social media because dem no know who dey watch for corner.