Body positivity: 'Stop to dey hide your stretch marks and big belle'
Msendoo Victoria na Naija babe wey dey live for Florida, USA.
She be actress plus voice artist wey break internet during lockdown afta she ask African women all ova di world to stop to dey shame for dia body.
Victoria dey ginger Africa women to accept and celebrate di body wey life give dem becos stretch mark na art.
She begin make video about how women gatz feel positive about dia bodi afta her family tell her make she lose weight or she no go see husband marry.
Producer: Faith Oshoko
Video: Dan Ikpoyi



