Trafficking of girls: 50 trafficked girls return from Lebanon. Wetin we know

Naptip at the hotel monitoring their evacuation

Wia dis foto come from, NAPTIP

Read am in 1 mins

Di 50 traffick Nigerian girls wey just return from Lebanon go pack enta NAPTIP shelter for Abuja afta dia mandatory 14 day isolation.

Di girls dey among di 69 Nigerians wey come back from Lebanon wit di epp of di Lebanese goment.

Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama wey announce di evacuation for im twitter handle say di evacuation dey possible because of di logistics and financial support from di Lebanese goment and Lebanese community for Nigeria.

Di oga kpata-kpata of NAPTIP, Julie Okah Donli say law enforcement agents including officers from di agency dey ground for di hotel wia di girls dem dey.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Naptip at the hotel monitoring their evacuation

Wia dis foto come from, NATIP

E say afta dem don cari dem go di Naptip shelter, di goment go launch investigation to find out those behind di trafficking of di girls.

" We go soon start to profile those wey test negative as soon as dia covid 19 test results comot'

" investigations go follow and di rehabilitation and empowerment of di girls go also start in line wit our partners' she explain.