Emeka Abugiri: Meet di blind mechanic
Di challenge wey im dey face no be di end of im life.
Dat na di tori of Emeka Abugiri, di blind mechanic wey no allow im condition stop am from doing wetin im love to do, fixing different kain engines from cars to okada to generator wey spoil.
Emeka wey from Enugu Ezike wey dey Nsukka local goment for Enugu state south east Nigeria, na married man wit seven pikin dem.

