Aidan Dumuje Abili: Meet di fastest swimmer wey pipo dey call bullet

Wetin we call dis Video, Meet Aidan Dumuje Abili di fastest swimmer wey pipo dey call bullet

Aidan Dumuje Abili na di fastest swimmer of im age category inside Lagos, Nigeria.

Abili dey train six days a week, and he don make up im mind to become di next Michael Phelps (di fastest swimmer for di world).

Di 8-year-old boy dey fast sotey im friend dey call am ‘bullet’.

So far no Nigerian don ever win Olympic medal for swimming, but hum wan change that.

Video Producers: Dan Ikpoyi, Gift Ufuoma