Fela Anikulapo Kuti: Five Nigerian musicians wey dia music dey inspired by Fela

Fela Anikulapo Kuti fit don die twenty two years ago but apart from di pipo wey dey bear im name, im blood still strong for Naija music.

Fela Kuti for concert

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem bin born Fela Anikulapo Kuti for 15 October, 1938 for Abeokuta, South-Westen Nigeria. E bin dey popular for im activism both on and off di stage wey make am bin get serious gbege with di goment. Di kain of music wey im sing get plenti pidgin flavour inside wey make di Nigeria spirit travel all ova di world. E die for August 2, 1997. Till now, di wahala e dey tok about still dey Nigeria; And dis na some top musicians don dey cari im blood for dia music.
Burna Boy for di video of Anybody

Wia dis foto come from, Instagram/@burnaboy

Wetin we call dis foto, Nigerian music sensation, Damini Ogulu wey stage name na Burna Boy get physical connect to Fela Kuti as im grandpapa bin dey manage di legend at some point for im career. Plenti times for di course of im career, e don sample songs from Kuti join im gbedu so e go enta bodi and "African Giant" no dey any different. In fact, e fit be im most Fela-rised body of work as of now.
Asa dey play guitar

Wia dis foto come from, Instagram/@asaofficial

Wetin we call dis foto, Nigerian international jazz singer Asa wey real name na Bukola Elemide na artist wey dey sing for Yoruba but get beta French following, e be like she no dey send anybodi wen she dey write her songs. International tori pipo don describe di musician say e be like she get some Fela for bodi. Her music from Fire on di mountain to Jailer don dey tok plenti societal palava wey dey worry.
Wizkid for di Ryal Albert Hall

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Wizkid wey real name na Ayodeji Ibrahim Balogun don tok before for interview say na insult to compare am to Fela because Fela na im Inspiration. Time dey for im career wey im bin dey use style to dress like Fela. In fact e don tell tori pipo say im plan im whole performance for 2017 Royal Albert Hall Concert based on di inspiration.
Nneka

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nneka na musician wey be say anytime she sing, na concious music dey comot from her mouth, like wetin Fela Anikulapo Kuti bin dey do wen im still dey. She don tok plenti times say one of her biggest inspiration na di afrobeat legend.
Falz for im video, 'This is Nigeria'

Wia dis foto come from, Youtube Falz

Wetin we call dis foto, Nigerian musician, Falz wey real name na Folarin Falana don dey follow join for social conversation since but na wen im release di album wey im call "Moral Instruction" wey im follow sample plenti Fela song even use di artist wey Fela bin dey use for im album covers. Di album tok from police kill-kill to corruption and religious oppression. Tori be say Falz papa na pikin of ogbonge Nigerian lawyer Femi Falana wey bin be lawyer to Fela wen e bin dey alive.