Afcon 2019: Super Eagles fit win di cup - Joseph Yobo
Superpowers for African football go begin gree-die for Egypt on Friday, for who go be baba for Nations Cup. Former Nigeria captain Joseph Yobo, dey im kontri back to win di cup.
Yobo wey be di last Nigerian captain to lift di cup for 2013, siddon yan wit BBC Pidgin and say if Super Eagles players carri one mind enta di competition, di cup go "return home."
