Ajegunle school wey dey collect plastics as school fees

Wetin we call dis Video, Plastics for school fees

One school for Ajegunle Lagos south-west Nigeria dey accept empty bottles from parents and guardians in exchange to pay dia pikin school fees.

Morit International School for Ajegunle Lagos, start di Recycles Pay Education project to reduce di financial palava wey di parents dey face.

BBC tori pipo: Faith Ilevbare and Abdulwasiu Hassan