You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Sagbokodji Island community for Lagos say dem neva see light for ova 100 years
Sagbokodji na island for Apapa Lagos State, south west Nigeria. Pipo for dis community neva see goment light before upon say dia area no far from town.Di village dey ten minutes away from di CMS area for centre of Lagos and na only boat pesin fit use go dia as no bridge lead to di community.
Head of all CDA chairmen for di community, Solomon Akojenune say "we neva see light for dis place since ova 100 years. Na inside darkness we dey sleep."
Tori be say di community don dey since dem do Nigeria amalgamation for 1914 and till now, no light.Dem no get drinking water, no single tared road dey dia and dia health center no get doctor and drugs.
Producers: Sarah Tiamiyu, Andrew Gift and Joshua Akinyemi.