Why Segun Arinze do film wey na only him dey inside

Wetin we call dis Video, Segun Arinze na di star, lead character and only actor for 'So Far Away' the movie

Di Nigerian film industry alias Nollywood don land wit tear rubber feem wey no be like any oda for market.

'So Far Away' na di tori of police officer wey travel go Abuja, Nigeria capital to write promotion exam, as im dey return back house for Enugu for di south east na so kasala burst.

Di upandan waka of di officer, as im dey hurry to sort out wahala wey hold am for neck na di koko of 'So Far Away'.

Wetin dey make dis feem extra special be say na only one pesin dey inside di movie from start to finish.

Uche Agbo wey produce and direct di feem tok say e dey important make Nollywood begin dey grow, dey experiment wit new ingredients.

Im say im get confidence Nigerians go watch di feem sake of say dem dey pack cinemas steady to watch oda tins wey no be just comedy.

''Pipo bin tell me say e get di kain feem Nigerians dey like to watch but if we no show dem somtin different how we go know wetin go work or no go work if we no change our style,'' na so Agbo tell BBC Pidgin.

One man feem

Wia dis foto come from, Uche Agbo

Wetin we call dis foto, Segun Arinze say im experience for theatre productions helep am for dis feem

Ogbonge actor Segun Arinze na di actor wey play di only character inside dis feem and im say na di sweet script wey di producer/director write, ginger am to join di production.

Arinze say, ''l see myself inside di character, di way im dey take behave from start to finish na wetin make me decide say l wan act inside di feem''.

Arinze say dis na di first time im go do movie wey na only him dey inside and di role challenge am.

But e sweet am for belle to work on dis project because evri tin make sense weda na di crew, producer/director style and odas.

Dem use seven days shoot 'So Far Away' for Abuja and sake of say na one man feem di production crew by force by fire dey avoid to jam pipo for road.

''We go wait oooo, till road clear before we comot, sharperly shoot'' na so Arinze tok.

Uche Agbo

Wia dis foto come from, Uche Agbo

Wetin we call dis foto, Arinze say im flow wella wit producer/director Uche Agbo

How Arinze take play one-man feem wella?

Arinze say di two tins wey helep am play di character wella, na di 'intelligence' of di actor and di theatre experience wey im bin don get before.

Arinze tok say, ''l cari my mind go back to di time wen l dey do stage production, l imagine how l dey relate wit oda actors, na di strategy l use for di feem''.

But Arinze say di way im young director, Uche Agbo connect na wetin complete di strategy finish and na why di feem make plenti sense.

Agbo tok say im dey flow well wit Arinze sake of say im dey very flexible as professional actor, weda na im physique, voice or di way im humble, Arinze na di man.

''Segun dey ready to do anytin if di tori make plenti sense'', na so Agbo tell BBC Pidgin.

Agbo say one tin wey go surprise pipo wella na di way di feem go end.

''Nobodi fit predict di end'' na so Agbo tok.

Story by: Busayo Iruemiobe

Camera: Gift Ufuoma