APC don declare Sanwo-Olu winner of Lagos Primary

Wetin we call dis Video, Mr Sanwo-Olu defeat current Lagos govnor Akinwunmi Ambode for APC primary

Nigeria ruling All Progressives Congress don announce say na Babajide Sanwo-Olu win Tuesday primary for Lagos, southwest Nigeria.

Chairman of di panel wey supervise di election, Clement Ebri, tok say Mr Sanwo-Olu defeat current govnor, Akinwunmi Ambode as get vote pass am.

Na di first time since 1999 wey ruling party for Lagos no gree nominate current govnor for second term.