Fruit garden market traders for Port Harcourt say dem loss evritin for Thursday fire
Traders for di fruit garden market for Port Harcourt di Rivers State capital for south south Nigeria, say dem loss plenti tins for di fire wey burn di market on Thursday night.
Most of dem say dem just stock up dia shop within di week before di fire come happun.
Rivers State govnor Nyesom Wike bin go see how di fire happun come tell di traders sorry. Im say di goment to do sometin for di traders and say dem go also rebuild di market.