This Is Nigeria: Wetin Falz tok inside di video

Falz a.k.a. Falz di bahd Guy, drop one powerful video wey tok plenti tins wey dey happen for Nigeria.

Di musician song na copy of di song 'This Is America' wey Childish Gambino do wey look as im kontri get plenti palava

As soon as di video drop, na so di internet catch fire wit all di different message wey dey inside.

Make e for no loss, see some of di tins wey Falz torchlight for di video.