You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Dem say I go sleep for under bridge' - Speed painter
Kanmi Biniut na doctor and im broda Tolu na economist wey dey work for bank. Di two start art company wey dem dey call Pencils n Brushes. Dem dey do speed paintings - wey pesin go start and finish painting sharp-sharp.
Di artistes do oda tins like pencil art and graphic design for occasions and events.
Di brodas say dem no happy as dia country pipo no dey respect artistes so dem wan use dia work show Nigerians say di job na correct job wey get 'glitter'.