My wedding plan: Woman versus man formula for di sweetest jollificate
All over di world, wedding ceremony dey very important for many levels.
For di couple, na dia dem begin special journey together as man and wife.
But wedding ceremony no be small thing to plan because e common make man and woman no too see eye to eye on di ingredients wey dey make di best wedding.


