Nigeria: Glaucoma na disease wey fit blind everybodi

Wia dis foto come from, TONY KARUMBA/AFP
Open-angle glaucoma worry pass for West Africa and every Nigeria person fit turn blind sake of am.
Dr Ugochukwu Eze, wey dey work for National Eye Centre Kaduna, say, glaucoma na disease wey dey kill small-small wire dem wey connect our eyes with our brain. Once di wires die, di eye don go be dat.
Open-angle Glaucoma na "silent thief" wey dey make pipo blind for west Africa.
Wen e happen, di person no go fit see wetin dey for dia side. E go be like say you dey look inside tunnel to see.
Tori be say, na only 1.8 million pipo out of 180 million Nigerians know say dem get dis disease.
Glaucoma patients care initiative say, dis number na just di beginning, as plenty pipo wey get am no even know say dem get am.

Wia dis foto come from, AFP
Andrew Gani Ikilama di executive director for Knowledge for di Blind Initiative Kaduna say, di sickness no get sign until person no fit see well, so di best thing na to dey do eye checkup.
Sabi people for Nigeria national blindness and visual impairment survey say, Nigerians wey don reach from 40 years, na dem fit get glaucoma pass.
End of Di one wey oda users dey read well well
Scientist never chook eye to know why Nigeria people get am plenty, but dem say every Nigerian dey at risk to get am.
Five things you suppose know
- Glaucoma be like tief. Tief no dey give announcement. E no dey give warning.
- E dey run for family. If one family memeber get am, make others go dey check dia eye.
- Person wey don reach 60 years dey more at risk.
- Glaucoma no get cure. But dem fit control am through eye drop or if person lucky through operation.
- Even if glaucoma make you blind, you fit still continue you life.











