"Make una check my head if I follow Obasanjo movement" - Wole Soyinka
Popular Nigerian writer and Nobel Prize winner, Professor Wole Soyinka, don talk say make Nigerians try check im head if im follow any political movement wey former President Olusegun Obasanjo dey lead for 2019 elections.
Soyinka still blast di standard of education for Nigeria when im talk say some of di kain graduates wey dey di country now dey do like people wey no get sense.
Im say na time for youths to rule Nigeria and im dey ready to support dem make di country for beta.

