'Na here dem kill former Nigeria President Murtala Mohammed'

Wetin we call dis Video, Di place where dem kill former Nigeria President Murtala Mohammed

13 February 1976, wey be 42 years ago, former Nigeria military head of state, Gen. Murtala Mohammed die on im way to office for Dodan Barracks, Ikoyi Lagos.

Lt. Col Buka Suka Dimka, na im lead di ambush to assassinate General Murtala Mohammed ontop coup wey no later work out.

Today statue stand for where im fall to remind people of wetin happen dia, but no be everybody sabi so.