Ibtihaj Muhammad dey show di first Barbie wit hijab

Wetin we call dis Video, Ibtihaj Muhammad dey show di first Barbie wit hijab

Barbie dolls sef don dey wear hijab!

US Muslim Olympian Ibtihaj Muhammad bin show di first Barbie wey nack hijab. Dem make di doll to resemble her.

Dis doll-baby na to troway salute for di American fencer, wey bi di first US woman wey wear Islamic head-tie wen she dey compete for Olympics.

Ms Muhammad win one bronze medal for Rio last year as part of di US fencing team.