Atiku win PDP presidential ticket wit 371 votes
PDP presidential primary election 2022 as e dey happun for Abuja.
Live Coverage
Una bye-bye!
Na here we go march break ontop our live coverage of di PDP convention.
But before we go, we leave una wit dis video of Atiku victory speech afta dem announce am as di party presidential flagbearer for di 2023 elections.
Bye-bye!
Breaking, Atiku get 371 votes
Former Vice President of Nigeria, Atiku Abubakar get 371 votes.
Breaking, Wike get 237 votes
Govnor of Rivers state Nyesom Wike get 237 votes for di PDP Convention for Abuja.
Vote sorting dey go on
Delegates don vote finish and dem don begin count di vote.
Watch live here how e dey happun.
Delegates don begin vote

Delegates don begin vote for PDP national convention wey dey happun for Abuja.
Abia state na di first set of delegates wey cast dia votes dem be 17 in number.


Breaking, Tambuwal step down from PDP presidential race

Wetin we call dis foto, Sokoto state govnor, Aminu Tambuwal Cheers and roar for di Venue of di PDP national Convention as Govnor of Sokoto State, Aminu Tambuwal announce say im dey step down and ask im supporters to queue behind Atiku Abubakar for di interest of nation building.
ICYMI: Live from di venue of di PDP convention
D ground don set now for di convention of Nigeria main opposition party PDP.
Di convention dey happun for National Stadium, Abuja, Nigeria capital.
Watch, video of how tins be dia some hours ago.
More aspirants show for venue of PDP convention

Wetin we call dis foto, Former Nigeria Vice President and presidential aspirant Atiku Abubakar 
More aspirants don land for di venue of di PDP national convention for Abuja.
See pictures of some of di latest our tori pesin take eye see.

Wetin we call dis foto, One of di aspirants, Govnor Aminu Tambuwal 
Wetin we call dis foto, Presidential aspirant Bukola Saraki Wike don show, Fotos show as Govnor Wike land di venue

Rivers state and one of di presidential aspirants for PDP Govnor Nyesom Wike don show for di venue of di convention.

IYCMI: Our exclusive interview wit Govnor Wike, one of di presidential aspirants
Wetin we call dis Video, Wike on 2023 presidential race: 'I no go step down for any consensus candidate' We bin siddon wit Rivers state Govnor Nyesom Wike.
E tok to us about why e come out and im expectation as to who go win di ticket.
Watch di video.
More pictures from venue of di convention

Dignitaries and leading figures as well as presidential aspirants don begin arrive di Velodrome of di MKO Abiola Stadium Abuja, di venue of di Peoples Democratic Party Special Convention.

Wetin we call dis foto, Senator Ademola Adeleke and delegate from Osun state So far, Chairman of the Convention Committee, Senator David Mark, di govnor of Akwa Ibom State, Udom Emmanuel, Benue State govnor, Samual Ortom, di govnor of Abia State, Okezie Ikpeazu, and former Benue State Governor, Senator Gabriel Suswam.

'We hope to elect pesin wey get di capacity to rescue Nigeria'
Some national delegates for di PDP 2022 National Convention say dia goal na to elect credible Presidential candidate wey go represent di party for di 2023 general elections .
Dem say dem want a credible and capable candidate wey go unite di party and rescue di kontri from misrule and build a beta kontri wey Nigerians go dey happy wit.
For im reaction to INEC extension of the deadline for party to submit dia candidate by 6 days, former Govnor of Benue state Gabriel Suswam say e no happy as e say e make dem not to include dia own statutory delegates.
Live from di venue of di PDP Convention
Delegates and oda party members don dey di National Stadium wey be venue of di PDP convention as dem dey wait for di event to kick-off.
Our reporter torchlight how tins be live from di venue short while ago.
Watch di video.
Delegates don begin arrive, PDP dismiss postponement rumour,

Wetin we call dis foto, Di delegates sidon for dia state cubicle Delegates don begin arrive di National Stadium, Abuja for di big day.
Na afta dia accreditation to vote to elect di candidate wey go be di party flag bearer for di 2023 general election.
Na 810 national delegates go cast dia vote.
One each from di 774 local goment area of Nigeria plus di three ad hoc delegates.
Dem go choose from 13 aspirants wey don dey waka di kontri to woo di delegates for vote.
Di PDP for statement on Saturday say di rumour wey dey fly upandan say e fit postpone di national special convention na lie.
And dat party dey go ahead wit di special convention alias PDP Presidential primaries 2022.

Wetin we call dis foto, PDP delegate ready to elect di presidential candidate of di party 
Wetin we call dis foto, Di delegates na 810 
Wetin we call dis foto, PDP say di party no dey contemplate to postpone di convention Heavy Security for National Stadium venue of PDP Convention,

Wetin we call dis foto, Those wey dem accredit don di enta di venue of di PDP National Convention Combined security forces dey ground for di National Stadium venue of di PDP presidential convention.
Di security dem block di main entry of di convention to ensure say na onli those wey get accreditation get right to enta di venue.
Meanwhile everytin don set pending di arrival of di 810 delegates

Wetin we call dis foto, PDP Officials don begin arrive di Velodrome for National Stadium 
Wetin we call dis foto, Security dey screen pipo for venue of PDP convention. Onli accredited pipo dem di allow inside One more aspirant drop presidential ambition hours to primaries
One presidential aspirant of di Peoples Democratic Party (PDP), Mohammad Hayat-Deen don withdraw from di 2023 presidential race.
Hayat-Deen drop dis one for letter wey im address to di PDP chairman, Iyiochia Ayu on May 27 2022.
Oga Hayat-deen tok say di exercise dey obscenely monetized”, and e go against im personal principles, among oda reasons.
Di former Managing Director of FSB International Bank decision land days after a former Governor of Anambra State, Peter Obi,withdraw from di presidential race and resign from di PDP.
But unlike Obi, Hayatu-Deen promise to remain for di party.
Now wit Hayatu-Deen withdrawal, di total number of aspirants wey wan be president under di platform of di PDP don be 13.

Wia dis foto come from, BBC Hausa
Welcome
Good morning and welcome to BBC Pidgin live coverage of PDP presidential primary election 2022 wey dey lhold today 28 May for Abuja.until tomorrow.
Ontop dis page you go see minute by minute update as e dey happun.

