Inec suspend further collation of results for Abia and Enugu states
Inec dey announce results for di govnorship elections for 28 states and State House of Assemblies for 36 states for Nigeria.
Live Coverage
Helen Oyibo and Victor Ezeama
PDP Sim Fubara win Rivers state govnorship election
NNPP Abba Kabir Yusuf make history as e win Kano govnorship poll
State by state breakdown of 2023 governorship election results wey hold for Nigeria
Una Good Night!
Na here we go match break for our coverage of di governorship election.
So far, Inec don announce results for 24 states. Two dey suspended while di remaining two dey inconclusive.
Check our website for more ontop reactions from di election and no forget to scroll down to catch up on how di result collation and announcemnet waka.
Una bye bye!
INEC declare Uba Sani of APC winner of Kaduna state govnorship election
Why INEC declare Adamawa State Governorship election inconclusive
Borno State governorship election result

Wia dis foto come from, Governor of Borno State
Prof Babagana Zulum na Borno state Govnor elect.
APC - 545,542
PDP - 82,147
LP - 1,517
Breaking, APC Rev. Fr. Alia na di govnor-elect of Benue state

Wia dis foto come from, Rev. Fr. Hyacinth Iormem Alia/Twitter
All Progressives Congress (APC) candidate, Rev. Fr. Hyacinth Alia, don win di Benue State govnorship election.
According to di results wey Inec announce, Alia get di highest votes to beat im closest rival, Peoples Democratic Party candidat Engr Titus Uba, wey be di curent Speaker of Benue assembly.
Alia get 473,933 votes to win, Engr Uba wey get 223,913 votes.
Di margin between di two parties na 251,020 votes.
Alia get di majority of di votes for 17 local goment areas out of 23 LGAs.
Inec only announce results from 22 out of di 23 LGAs for di state.
Di electoral commission no announce Kwande LGA wia election no hold sake of printing error wey dem discover for some of di ballot sheets.
Chimaroke Nnamani don witdraw from PDP

Wia dis foto come from, Twitter/Chimaroke Nnamani
Di former Governor of Enugu state and Senator wey dey represent Enugu East Senatorial District, Chimaroke Nnamani, don formally witdraw im membership wit di Peoples Democratic Party (PDP).
Inside statement wey im release on Monday, di Senator also tank pipo of im constituency for all di support wey dem bin give am over di years.
E say im bin consult wit im “associates and constituents” and from di consultation im don decide to leave PDP sake of “irreconcilable differences wit di national leadership of di party.
E as im dey move on, e hope say di pesin wey dey come afta am go build on di small contributions to di developments wey im do for im constituency
Di Chairman of Senate Committee on Cooperation & Integration in Africa/NEPAD maintain say im get connection wit di President-Elect Bola Ahmed Tinubu and promise to continue to partner wit am.

Wia dis foto come from, Twitter/Chimaroke Nnamani
Buhari don return to Abuja afta Govnorship election

Wia dis foto come from, Nigeria presidency
Nigeria President Muhammadu Buhari don return to Abuja di kontri capital.
Buhari return to Abuja afta im go take part for di governorship and State House of Assembly elections.
Di Nigeria leader vote for im hometown, for Daura, Katsina state.
Breaking, Prince Bassey Edet Otu win Cross Rivers state Govnorship election

Wia dis foto come from, Ben Ayade
Wetin we call dis foto, Gov Ben Ayade(l) and Prince Bassey Edet (r) Prince Bassey Edet Otu na di Govnor elect of Cross Rivers state.
Inec declare Prince Otu of di All Progressives Congress winner afta im beat Sandy Onor of Peoples Democratic Party.
Di APC candidate poll 258, 619 to beat his closest competitor of PDP wey get 179, 636 votes.
EU say 'obstruction and violence limit di will of voters'

Wia dis foto come from, EU/TWITTER
Di European Union Election Observation Mission for Nigeria say "Obstruction and organised violence limit di free expression of di will of voters.
Na wetin di Chief observer Barry Andrews tok about di govnorship and House of Assembly elections.
On March 18, election hold for 28 states for di kontri to elect govnors and state lawmakers.
Di newly elected officials go lead dia pipo for di next four years.
Tori be say violence and voter intimidation happun for most states for di kontri wey di election happun on Saturday.
EU say say di violence happun despite efforts by civil society to promote democratic standards.
Di foreign observers say ‘’Some states abuse di power of incumbency wey give undue advantage to di party in power.’’
Dia tok dey come as Inec don declare results for most of di 28 states wey election take place.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
'I no regret contesting election'
APC win Ebonyi govnorship election

Wia dis foto come from, Leo Ekene Oketa (SA Media to Governor Elect)
Inec declare Francis Nwifuru of di All Progressives Congress (APC) di winner of di 2023 governorship election for Ebonyi State.
Nwifuru na di current Speaker of di Ebonyi State House of Assembly.
E get total of 199,131 votes, while di PDP candidate, Ifeanyichukwuma Odii, dey follow am for back
wit 80,191 votes.
Di candidate of di All Progressives Grand Alliance (APGA), Bernard Odo, come third wit total of 52,189 votes.
APC na di ruling party for Ebonyi and wit Nwifuru win, e go continue to remain in power.
Abia state Inec suspend result collation till Tuesday
Abia state electoral officer, Professor Nnenna, don announce say collation of results for di state govnorship results go remain suspended till on Tuesday 21 2023.
Prof Nnenna make dis announcement afta Inec announce di suspension of result collation of results for two states, Abia and Enugu.
According to Professor Nnenna ,dem get di order from Inec national headquarters to suspend collation of results from Obingwa local goment area of di state afta jaguda pipo invade dia office dia.

Wia dis foto come from, Inec
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
NNPP present Kano guber result sheet to dia leader, Rabi'u Musa Kwankwaso

Wia dis foto come from, Rabi'u Musa Kwankwaso (Twitter)
NNPP don present dia cetified result sheet to di leader of di party Rabi’u Musa Kwankwaso of di NNPP.
Govnor-elect Abba Kabir Yusuf, get more dan one million votes to win di seat.
But APC wey get di second highest votes say dem still dey study di results and soon dem go tok wetin dia position be on di election.
ADP - 9,402
APC - 89,0705
NNPP - 1,019,602
PDP - 15,957

Wia dis foto come from, Rabi'u Musa Kwankwaso (Twitter)

Wia dis foto come from, Rabi'u Musa Kwankwaso (Twitter)
Breaking, APC Umar Mohammed Bago don win to become Niger state govnor-elect

APC candidate, Umar Mohammed Bago, don win di govnor seat for Niger state.
According to Inec, APC get 469,896 votes to defeat PDP Isah Liman Kantigi wey get 387,476 votes.
Di election contest wey occur mainly between APC and PDP see Umar Mohammed Bago win 20 local goment areas out of 25 LGAs while PDP collect di remaining five.
Breaking, PDP Caleb Mutfwang declared govnor-elect of Platuea state

Wia dis foto come from, Twitter/Caleb Mutfwang
Inec don declare Caleb Mutfwang, winner of di governorship election for Plateau State, North central Nigeria.
Mutfwang win di majority of di votes cast across di 17 LGAs of di State.
Declaring di results for Inec state office, Miango Road, Kufang, Jos, today, di Returning Officer and Deputy Vice Chancellor of Federal University, Lafia, Prof. Idris Amali, say Mutfwang of di PDP score total votes of 525,299 to defeat im closest rival, Nentawe Yilwatda of di ruling All Progressives Congress (APC), wey score 481,370 votes.
Breaking, Sheriff Oborevwori of di PDP na di govnor-elect of Delta state

Wia dis foto come from, Facebook/ Sheriff Oborevwori
Inec Returning officer for di Delta State govnorship election don declare di Peoples Democratic Party candidate as winner of di election.
PDP Sheriff Oborevwori win di All Progressive Congress party candidate Senator Omo-Agege wit 120,005 votes.
Oborevwori get 360,234 while Omo-Agege follow am for back wit 240,229.

Wia dis foto come from, bbc
