Nigeria give citizenship to 286 foreigners

Live updates of top tori dem from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. BBC Pidgin Minute

  2. 'Dem need to apologise': Africans on di monarchy

  3. Police dey drag man to court over Queen coffin incident

  4. Day-by-day guide from now to Queen Elizabeth II burial

  5. How Son Heung Min hattrick help Tottenham thrash Leicester City

  6. Queen Elizabeth eight grandchildren stand vigil around her coffin

  7. Harry go stand vigil at Queen coffin in uniform

  8. Eyewitnesses tok how Chinese man allegedly murder im girlfriend for Kano 

  9. Man chop accuse for lying-in-state queue sex assaults

  10. Nigeria military allege say Amnesty International dey support terrorists

  11. From swans to London streets -Di Queen inheritance for King Charles III

  12. “I go make extra consultations, and I go get back to you” - Nigeria President Muhammadu Buhari on Asuu strike as e meet wit Pro-Chancellors of Universities

  13. Una bye-bye

    Na for hia we go match break until next Monday wey we go bring una ogbonge tori from Nigeria, West Africa and di rest of di World.

    Follow us also for live updates on di burial of Queen Elizabeth di second wey go shele on Monday, 19 September, 2022.

  14. Ghana Marburg outbreak officially don dey over

    Marburg outbreak

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Dem first detet di Marburg virus for di city of Marburg inside Germany for 1967

    Ghana don declare say di recent outbreak of di Marburg virus don dey afta 42 days without anibodi wey test positive.

    Di authorities first alert di public to di outbreak of di highly infectious disease, wey dey related to Ebola, for July afta dem record two deaths.

    One of dos reports come turn out to be incorrect diagnose.

    In all, three pipo contract di virus and two die: one papa and im 14-month-old pikin.

    Di third pesin - di mama - recover and later test positive in August.

    Almost 200 contacts of di three infected pipo na im authorities follow up but none get any symptoms.

    "Ghana dey safe," Ghana Health Service Director General Dr Patrick Kuma-Aboagye tell journalist for Accra on Friday.

    E come tank di World Health Organization (WHO) and oda partners wey help di kontri to deal with di outbreak.

    "Upon say we no get experience before now wit di disease, Ghana response dey rapid and robust," AFP news agency quote wetin WHO Africa head Dr Matshidiso Moeti tok.

    Dis na di second time wey dem dey identify Marburg for West Africa.

    One confam case bin happn for Guinea last year, but dem declare dat outbreak over for September, five weeks afta dem discover di case.

  15. Mali warn Ecowas to comot hand from Ivorian soldiers mata

    Mali

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Mali military goment don criticise Ivory Coast say dem ask di West African regional bloc, Ecowas to help secure di release of 46 Ivorian troops wey dem detain for Bamako since July.

    For one statement wey di goment release on Thursday, Mali say di soldiers’ detention na "purely legal and bilateral" mata and warn make Ecowas no dey involved.

    Dem say Mali goment no go keep quiet for any blackmail or intimidation.

    Mali reaction dey come one day afta di Ivorian national security council decision to refer di mata to Ecowas so dat dem go fit organise extraordinary meeting of heads of state on di crisis.

    Col Abdoulaye Maiga, wey be Mali interim prime minister and goment spokesperson, tok say di authorities don show to Ecowas say dis na legal mata between di two kontris.

  16. Nigeria and Morocco don sign gas pipeline agreement

    Nigeria and Morocco

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Morocco and Nigeria don sign one agreement to build one major pipeline transporting gas from southern Nigeria and across di Sahara - going through 13 African kontries.

    Di 7,000km (4,300-mile) link - wey originate from Brass Island - go connect with di Maghreb European Pipeline for Northern Morocco.

    Nigerian National Petroleum Company (NNPC) boss Mele Kyari for di signing ceremony for Rabat, di Moroccan capital say di project go improve living standards and reduce desertification for West Africa.

    Last November, Algeria stop to dey use one pipeline wey go through Morocco to Spain, and dis deprive Moroccans of both gas and transit fees.

    NNPC tok say di project go also supply gas to West African kontries and provide new export route to Europe and dey expected to supply about three billion cubic feet of gas per day.

    But e no dey clear yet wen di project go complete.

    Di signing of di agreement dey come for time wey global energy crisis dey very bad afta Russia invasion of Ukraine.

    European kontris dey find ways to reduce dia dependence on Russian gas.

  17. Industrial court adjourn case between FG and Asuu

  18. Cardi B Rapper plead guilty to strip club assault charges

    Cardi B

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Di rapper accept plea deal one day before her case bin dey due to come to trial

    Cardi B don admit to two offences as fall-out from one fight wey happun for one strip club, na part of one deal wey mean say she go avoid trial and possible jail time.

    Di Grammy-winning rapper, wey dem born as Belcalis Almanzar, plead guilty to third-degree assault and second-degree reckless endangerment, and dem sentence am to 15 days community service.

    Authorities dismiss ten oda charges.

    "I don make some bad decisions for my past wey I no dey afraid to face and own up to," she tok in side statement.

    For court, di 29-year-old admit to organising and participating in two attacks on employees of di Angels nightclub for New York for 2018.

    According to authorities, di incidents grow out of one fight between Almanzar and two sisters - one of wey she believe say dey get affair with her husband, di rapper Offset.

  19. Flood displace over 3000 pipo for Northern Nigerian state

    331 houses destroy

    Wia dis foto come from, NEMA

    Di National Emergency Management Agency (Nema), Sokoto Operations Office don visit pipo wey flood displace for some communities for Kebbi state.

    Flood disaster bin affect some communities of Bagudo and Bunza Local goment for di Northwestern state.

    Officials of Nema visit di communities wia di incident happun to carry out di need assessment.

    Di assessment team discover say more dan 3,125 persons dey affected, 331 houses destroy, 1,239 pesins dey displaced and water cover over 2,656 hectres of cultivated farmland.

    331 houses destroy

    Wia dis foto come from, NEMA

    Wetin we call dis foto, Di flood destroy 331 houses destroy
    331 houses destroy

    Wia dis foto come from, NEMA

  20. Wetin dey happun today wit Queen Elizabeth burial?

    • Na di second full day of Her Majesty lying-in-state. Long queue don continue to grow along di River Thames for central London, with hundreds of thousands wey dey expected to come pay dia respects to di late Queen ahead of di funeral on Monday
    • King Charles go travel go Wales later, dis wan go complete im tour of di home nations. Alongside Camilla, di Queen Consort, dem go host reception for Cardiff Castle, and hear condolences from di Welsh parliament
    • Later dis afternoon, di King go meet Faith Leaders for Buckingham Palace
    • For 19:30, di Queen four children - Charles, Anne, Andrew and Edward - go stand vigil for 15 minutes around her coffin for Westminster Hall