You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Morocco defeat defending champions Nigeria on penalties to book Wafcon 2022 final place

Defending champions Nigeria dream to win tenth Wafcon title don end afta dem lose 5-4 on penalties to hosts Morocco.

Live Coverage

Helen Oyibo and Tamara Ebiwei

  1. Thank you and bye-bye

    We thank una for following our live update of tonight semi-final match wey see hosts Morocco defeat defending champions Nigeria on penalties.

    Di Atlas Lionesses go jam Banyana Banyana of South Africa for Saturday fina.

    Meanwhile, Nigeria go meet Zambia on Friday to determine who finish third place.

    You fit read our Morocco vs Nigeria match report for here:

    Until next time, bye-bye.

  2. 'Una make us proud'

    Moroccans no fit contain dia joy as dem witness di Atlas Lionesses make history.

    Dis na di first time wey dem go make di final of di Women Africa Cup of Nations.

    Not only dat, di Moroccan Women also qualify for next yeat World Cup.

  3. How Nigerians react to Super Falcons defeat

    Even though dia team lose for penalties, Nigerians feel 'proud' of dia performance.

    Di Super Falcons go need pick demsef up ahead of next year World Cup wey dem don qualify for.

    Nigeria, South Africa, Morocco and Zambia na dem don book automatic qualification for di 2023 Women World Cup wey Australia and New Zealand go host.

  4. 'We fight bravely'

    Dia dream to win di title for record 10th time don end but Nigeria take dia defeat in good faith.

  5. Morocco react to win

    Morocco celebrate dia first Wafcon final for dia history.

  6. No 10th Wafcon victory for Nigeria

    Before dis tournament start, Nigeria be dey hope to win Wafcon for di tenth time.

    #Goforten na wetin di Super Falcons bin don dey ginger wit, but tonight semi final defeat don end dat dream of winning di tournament again.

    Dis defeat fit see di end of players like Onome Ebi international career as di 38th year old fit retire afta di third place match.

  7. Morocco defeat na my ‘worst match’ -Nigeria goalkeeper

  8. Morocco go meet South Africa for Wafcon 2022 final

    Hosts Morocco don book dia place for dis year Wafcon 2022 final afta dem beat defending champions Nigeria 5-4 on penalties.

    Di Atlas Lionesses go meet South Africa for Saturday final

  9. Ayane kick see Morrocco win on penalties

    Morocco striker Rosella Annie Ayane shoot straight down di middle to win di match for Morocco.

    Morocco 5-4 Nigeria

  10. Gift Monday score Nigeria fifth kick

    Left footer Monday score for Nigeria.

    Morocco 4-4 Nigeria

    if Morocco score dia next kick dem don win.

  11. Nesryne score for Morocco

    Elchad Nesryne score Morocco fourth kick.

    Morocco 4-3 Nigeria

  12. Plumptre score for Nigeria

    Ashley Plumptre draw Nigeria level.

    Morocco 3-3 Nigeria

  13. Redouane score three out of three for Morocco

    Defender Redouane score three out of three kicks for Morocco.

    Morocco 3-2 Nigeria

  14. Reginna score for Nigeria

    Reginna Otu score for Nigeria.

    Morocco 2-2 Nigeria

  15. Chebbak score for Morocco

    Morocco captain Ghizlaine Chebbak send Nnadozie go di wrong way.

    Morocco 2-1 Nigeria

  16. Save!

    Morocco goalkeeper save Onomonu kick

    Morocco 1-1 Nigeria

  17. Amani score her kick

    Amani go take Morocco first penalty.

    She score.

    Morocco 1-1 Nigeria for penalty shootout.

  18. Morocco vs Nigeria Penalty shootout

    Nigeria na dem go take di first kick.

    Rita Chikwelu scores!

    Morocco 0-1 Nigeria

  19. End of extra time

    120' Full time, dis semi final go enta penalties.

    Morocco 1-1 Nigeria

  20. 118' Gift Monday make rare run into di Morocco half, she pass give Onumonu wey later lose di ball.

    Two minutes more before end of extra time.

    If e end like dis na penalty go settle am.