You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

America president elect Joe Biden don promise to unify di kontri afta im win Donald Trump for election

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Who be Joe Biden di new America president-elect?

  2. Na here we go march break

    Na here we go end our live coverage of di US presidential election.

    We thank all of una wey join and tanda with us.

    No forget to follow us ontop our website and social media (Facebook, Twitter, Instagram) for di latest tori from di continent and around di world.

    Bye-bye!

  3. Which world leaders never congratulate Biden?

    World leaders don dey send messages to congratulate Joe Biden. See di messages wey Boris Johnson, Benjamin Netanyahu and odas send give Biden here.

    But Mexican President Andres Manuel Lopez Obrador don say e dey too soon to congratulate Biden and say im go wait for "all legal issues" in di US election to get head.

    So, which oda pesin we never hear from? Some ogbonge pipo dey wey never open mouth - maybe dem still dey arrange di perfect tin to tok...

    Kim Jong-un of North Korea

    Vladimir Putin of Russia

    Saudi Arabia rulers

    Xi Jinping of China

    Recep Tayyip Erdogan of Turkey

    Jair Bolsonaro of Brazil

    Viktor Orban from Hungary

  4. Trump go accept say e lose for election?

    Di US bin get history of presidential candidates wey lose wey gree for publicly say dia opponent defeat dem since 1986, when William Jennings Bryan send short brief telegram to winner William McKinley to say "congratulations".

    Since then every candidate don follow di tradition - no matter how tight or hot di election - and usually e no dey pass hours after polls don close.

    But no law dey ground for pesin to concede and di Trump campaign don indicate say dia candidate no plan to accept di results.

    Soon after dem announce Biden victory, Trump release a statement wey tok say: "Dis election dey far from over." Di president never speak for public since dem announce di numbers, but he repeat im claim say voter fraud happen inside one of im tweet, wey Twitter sharpaly mark as "disputed".

    Dis dey different to John McCain speech after e lose to Barack Obama for 2008.

    Hillary Clinton deliver her speech for 2016 even tough her election battle against Trump na one of di ones wey hot pass for history.

    She say she congratulated am and tok say she hope say im go be "successful president for all Americans".

  5. Trump set to join di list of one-term president club

    Donald Trump loss mean say e dey set to join club wey e no go dey happy to be member of - Dat na di single-term president.

    Trump na di first president since George HW Bush to lose re-election campaign.

    Since 1933, only Bush, Jimmy Carter and Gerald Ford - and now Trump - dem don beat for general election even as dem dey inside office for White House.

    George HW Bush time for office coincide with di fall of di Berlin Wall and im popularity increase during di first Gulf War.

    But sake of di continue economic recession under im watch, e break one pledge not to raise taxes and dis come provoke serious bad belle from within im own Republican party. With Ross Perot, wey be third-party candidate, splitting di vote for di 1992 election, Bush attempts to win re-election no succeed as Democrat Bill Clinton block am.

    Jimmy Carter- now 96 years old -na di e only living man wey knows wetin e dey like to lose afta your first term. E no dey lucky enof to take office for di time wen di global economy dey for katakata, while Gerald Ford- wey enta office afta Richard Nixon resignation - only get two and a half years to make impact, according to Larry Sabato, director of tdi Center for Politics inside University of Virginia.

  6. Which states US still dey wait to hear results from?

    BBC project Joe Biden victory on Saturday afta e secure Pennsylvania and dat state push am pass di 270 electoral votes wey im need. Dem also project say na im go win Nevada too.

    All dis projections dey based on di unofficial results from states wey don already finish counting dia votes, and di results wey dem dey expect from states like Wisconsin wia di count still dey go on.

    Pennsylvania, Wisconsin and Michigan na di only states wey don "flip" diis election, all from Republican to Democrat.

    But we still dey wait to hear di results from four states - and more flips fit come from dia:

    Alaska- Donald Trump dey ahead with nearly 63% of di vote to Biden 33%, with 56% of di vote wey dem don count. E win Alaska for 2016.

    North Carolina- Trump dey in front with 50% of di votes to Biden 48.6%, with 98% of di vote wey dem don count. Trump also win dis state for 2016.

    Arizona- Biden dey ahead of Trump here by 49.5% to 48.9%, with 97% of votes wey dem don count. If Biden win, dis go be anoda flip to di Democrats, as Trump bin win am for 2016.

    Georgia- Biden dey also narrowly ahead of Trump by 49.5% to 49.3% and 99% of di votes wey dem don count. Again dis state - inside di South - fit be flip, aftar Trump secure am for 2016.

    With all dis in mind, Trump don promise to contest di election results on several fronts. We already know say dem wan do recount for Georgia, wia di margins dey tight, and Trump want di same recount for Wisconsin.

    Counting of votes for some state still continue and results no go official until final certification, wey dey happun for each state .

  7. What if Trump no agree say Biden win am?

    Donald Trump don bin tok before say e go contest di results. If im efforts to do so no dey successful, di pressure on am to publicly agree say Biden win am go increase.

    Di concession phone call from di cansidate wey dey loss to di one wey dey win na respected tradition of American politics but no be say e dey compulsory.

    For 2018, for instance, Democratic governor candidate Stacey Abrams claim voter fraud and intimidation and neva agree say Brian Kemp, her Republican opponent win am.

    Dis kain tin neva happun for modern presidential race, however. But as e dey for Georgia, as long as election result dey legally processed and certified, di machinery of goment go move on, regardless of wetinTrump fit do.

    While Trump no need to agree say Biden win am, or even pretend and attend Biden inauguration, e get some legal obligations. E must authorise im administration to make di logistical preparation for Biden team to take ova. Dis na something, according to Trump officials, di president don already do.

    Donald Trump enta di presidency as ordinary candidate wey no dey fear to break di long-established norms and traditions. If e like, e fit still comot office di same way too.

    Dem write am for US Constitution say di new term of office begin on 20 January in di afternoon. So expect to see Joe Biden and Kamala Harris wey dem go inaugurate on 20 January 2021, even if Trump refuse to show face.

  8. Dejected Trump fans dey hold rallies

    Supporters of Donald Trump stay out on di streets long afta di announcement wey say Biden don win di election.

    Trump neva agree say dem win am and e neva speak publicly since dem announce im defeat while e dey play golf.

    Many of those wey enta streets support Trump claim of voter fraud (of course no be all Trump supporters believe say dem rig di election)

  9. How Trump react and wetin e bin dey do as dem announce say e lost di US election

  10. How world leaders reacted to Biden win

    Since dem announce Joe Biden as US election winner, messages from world leaders don poured in - most of dem na positive message. Here na wetin some of dem get to tok;

    • Muhammadu Buhari, Nigeria President, tok say "Biden election na reminder say democracy na di best form of goment because e dey offer pipo di opportunity to change dia goment by peaceful means.
    • Nana Akufo Addo, President of Ghana, tok say "Na my sincere hope say di president-elect Biden tenure of office go dey mark by di delivery of unity, security, progress and prosperity to all Americans." E say im hope say during Biden tenure di relationship between Ghana and US go continue to grow strength to strength
    • Boris Johnson, UK, tok say US "na our most important ally and I look forward to working closely togeda on our shared priorities, from climate change to trade and security"
    • Narendra Modi, India, call am "spectacular victory", and add big congratulations give to Kamala Harris, wey be half Indian: "Your success na pathbreaking, and mata of big pride not just for your chittis, but also for all Indian-Americans"
    • Angela Merkel, Germany, tok say "our transatlantic friendship dey indispensable if we are to deal with di major challenges of our times"
    • Nicolás Maduro, Venezuela, say im kontri "go always dey ready for dialogue and understanding with di pipo and goment of US"
    • But Ayatollah Ali Khamenei, Iran, tok say di election na" spectacle", adding say: "Dis na example of di ugly face of liberal democracy insideUS. Regardless of di outcome, one tin dey absolutely clear, di definite political, civil, & moral decline of di US regime"
    • And Alexander Lukashenko, Belarus - wey im own election, im kontri dey view am as rigged, sotey e cause nationwide unrest - condemn US election result as " travesty of democracy"
  11. Three tins Joe Biden tok for im victory speech as US president-elect

  12. Biden ‘vow’ to unify America for im first speech as president-elect

    Joe Biden say "time to heal" di US for im first speech as president-elect, and promise "not to divide but to unify" di kontri.

    "Make we give each oda chance," oga Biden tok for one event inside Delaware, as e dey address those who vote against im.

    Oga Biden defeat incumbent President Donald Trump afta Tuesday election.

    Trump neva agree say dem win am and e neva speak publicly since dem announce im defeat wen e go play golf.

    Di result make oga Trump di first one-term president since di 1990s. Im campaign don file plenti-plenti lawsuits for various states but election officials say no evidence show say dem rig di vote against am, as e dey claim.

    Huge celebrations na im happun for major cities afta tori pipo announce Joe Biden victory on Saturday. Trump supporters wey dey disappointed protest for some cities but no reports of incidents.

    Biden Speech

    During one address to cheering supporters inside parking lot for im hometown of Wilmington, Joe Biden tok say:

    "I pledge to be president wey go seeks not to divide, but to unify; who no dey see red states and blue states, but only sees di United States."

    "Time don reach to put away di harsh rhetoric, lower di temperature, see each oda again, listen to each oda again and to make progress, we need to stop treating our opponents as enemies."

  13. Wetin you need to know about Jill, wife to US president-elect Joe Biden

  14. Who be Kamala Harris, Joe Biden Vice President-elect

  15. So how many votes Kanye West finally get?

  16. See di times presidential election results delay don shake America

  17. 'Peaceful transfer of power go dey if Joe Biden win'- Mitch McConnell

    Top Republican Mitch McConnell don tok say peaceful transfer of power go definitely dey if Joe Biden win di presidential election.

    "Of course," McConnell respond to questions from reporters inside Kentucky, wia e seat as senator.

    "We don get peaceful transfer of power going back to 1792, every four years, we dey move on to new administration."

    McConnell comments dey come afta di different messages from Donald Trump.

    Di president bin don refuse to accept such handover early dis year, then last month, e tok say e go support smooth transition.

    "Peaceful transfer ... I absolutely want dat, but ideally, I no want transfer because I want to win," Trump tok for dat time.

    Since 3 November, President Trump don repeatedly accuse Democrats say dem dey try to "steal" di election, without offering evidence, and promise to challenge vote counts for key states.

  18. White House chief of staff don test positive for Covid-19

    White House Chief of Staff Mark Meadows don test positive for Covid-19.

    Oga Mark Meadows don become di latest member of Donald Trump inner circle to get coronavirus.

    E no dey clear for now how oga Meadows -wey dey always appeared for public events without face mask - take get di virus.

    Di disease don kill about 230,000 Americans. US set third straight daily record for new cases on Friday, with more than 127,000 infections.

    Di kontri coronavirus outbreak na serious policy battleground for di election run-up, and contribute to di increase in postal and early in-pesin voting.

  19. Joe Biden lead dey increase inside Georgia

    E dey good for Joe Biden for di battleground state of Georgia as e continue to lead di vote count - and im lead dey increase more-more.

    Overnight Biden dey ahead by more than 4,000 votes with 99% of di ballots wey dem don count.

    Now di Democratic challenger dey 7,248 votes ahead, according to BBC data.

    Georgia (with 16 electoral college votes) na traditionally Republican state, and Democrat neva win for presidential race since 1992.

  20. Dem don extend flight restrictions ova Biden house

    Temporary flight restrictions na im authorities don extend ova Joe Biden house wey dey Wilmington, Delaware.

    Before now, one-mile radius Temporary Flight Restriction (TFR) na im bin dey around oga Biden home since e become Democratic nominee, base on di request of di Secret Service.

    But on 4 November, dem expand di radius to three miles, and on Friday, dem extend di order until at least 11 November.

    Anybody wey disobey di order go face up to 12 months inside federal prison or fines up to $100,000 (£76,000), in addition dem go suspend or revoke dia pilot licence.