Una goodnight!
Na here we go march break ontop our live coverage of di grand finale of di BBNaija 2020 show.
Before we go, we go leave una with dis picture of di winner and di host.
Bye-bye!
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Laycon, Dorathy, Nengi, Neo and Vee go know dia fate today for di final of Big Brother Naija lockdown house.
Helen Oyibo and Princess Igho Williams
Na here we go march break ontop our live coverage of di grand finale of di BBNaija 2020 show.
Before we go, we go leave una with dis picture of di winner and di host.
Bye-bye!
Laycon, winner of di BBNaija lockdown season 5 show don say thank you to im fans and family wey help am win di show.
See Dorathy thank you message to her fans and everybody weu get hand for her journey.
Celebrities and notable pipo also join who throway salute and hail Laycon victory.
One woman wey claim to be di Ex girlfriend of Big brother season 5 winner, Laycon don write long episode for her instagram page wey she title "Open confession, letter to Laycon my Ex Lover."
Di lady say she dey heart broken and shattered as she no know say Laycon go blow like dis in future.
She claim say two of dem date for five years and she hustle and suffer with am.
Di lady claim say afta di long suffering with Laycon to help im career, she finally marry anoda pesin.
She add say her husband understand her love for Laycon and she go always love am.
Pipo don enta social media to congratulate Laycon, di winner of di BBNaija Season 5 lockdown show.
See some of di reactions.
Laycon na di winner of Big brother season five (5) afta 10 weeks wey e don dey for lockdown house.
E beat di 20 housemates wey enta di house to claim di grand prize of N85M
Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos. E be graduate of philosophy from University of Lagos. E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata.
Laycon say im experience with e fellow housemate, Erica na lesson learnt
Dorathy don confess who be di housemate wey she like.
She tell Ebuka say na Brighto afta Ebuka remind her of her promise to tok whoe di pesin be if she make am to 71 days..
Laycon and Dorathy don make dia ke their final exit out of di Big Bother Lockdown House
Na dream come true for dem.
Dorathy say she dey surprise to make am to dis stage and Laycon say e only come to promote im song but now e don enta finals
Davido and mayorkun perform live for di Big brother Naija finals.
Di two ogbonge artists sing popular song 'betty butter'
Davido come later perform im latest song titled 'Fem'
Nengi wey be third pesin to leave di lockdown house say she get di feeling say she go be di next to leave di house.
She say although she enta di house to win but tins happun.
She say she go see how her friendship with Ozo go waka. plus how her plans go waka too
See how pipo gada for Lagos, Nigeria to watch di finals of di Big Brother Naija 2020 season 5 show.
Nengi don carry her kaya comot from di Big Brother House afta she struggle to dey among di five finalist.
Rebecca Hampson na 22 years old entrepreneur from Bayelsa State, Nigeria. She be former model and MBGN Top 5 contestant wey love learning new things, having fun, travelling, taking on new adventures.
Ogbonge Nigeria musician, fireboy don show back for stage to perform one of im popular songs like 'Eli' and two odas.
Neo say e no be d kind of guy wey dey rush into relationship and so e go take am slow with Vee as dem don leave di Big brother Naija House. E ass say e dey open to relationship with her and di next relationship wey e go enta need to dey sound and strong.
Neo tell host of di show, Ebuka say e go keep im plans for di future broad.
E say e dey open to any hustle and anyone wey come e way e go dive.
Neo wey make am to di finals don leave di Big brother Naija house.
Emuobonuvie Akpofure na 26 year old ride-hailing app driver from Delta State . E describe imsef as fun, tolerant, loving and smart. E also dey secretive.
Nigeria popular musician trill fans of Big brother Naija with im song
Di singer perform popular songs Beamer and woman.
Vee don tell di host of di show Ebuka say as dem go comot di house now na im go show if she and Neo relationship go last.
Vee tell Ebuka wen e ask am about di plenti break-ups she and Neo bin dey get for di house.
As per future works, Vee say she dey open to plenti tins including entertainment and hosting.
She say she dey open to everything entertainment such like acting, singing and odas