All di serenren from AMVCA awards as e dey happun

Dis na we live coverage of di seventh edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards wey dey go down for Lagos, Nigeria.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Tuale to everybody wey read dis page, Scroll down to see all di winners

    AMVCA

    Tuale to everybody wey tanda here dey read our updates on dis year Africa Magic Viewers Choice Awards.

    Dis year edition of di AMVCA don come and e don end. All di winners don carry dia award dey go house.

    Na hia we too go begin find our house address.

    You fit still see more of our coverage of di seventh AMVCA for our pages.

    We dey for:

    • Instagram
    • Twitter
    • Facebook
  2. Best overall movie

    One more time, Living in Bondage na im win dis category.

  3. Best Director

    Ramsey Noah wey direct Living in Bondage na im win dis category.

    Ramsey Noah AMVCA Best Director

    Wia dis foto come from, Ramsey Noah/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Ramsey Noah AMVCA Best Director
  4. Best Actor in a Drama

    Timini Egbuson!

    Timini Egbuson AMVCA Best Actor in a Drama

    Wia dis foto come from, Timini Egbuson/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Timini Egbuson AMVCA Best Actor in a Drama
  5. Best Actress in a Drama

    Toyin Abraham!

    Di actress carry di award for her role inside di movie Elevator baby.

    Toyin Abraham AMVCA Winner Best Actress in a Drama

    Wia dis foto come from, Toyin Abraham/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Toyin Abraham AMVCA Winner Best Actress in a Drama
  6. Best dressed male

    Mike Edwards of Big Brother Naija season four na im win Best dressed male.

    Dis category of award for both male and female bin dey open to fans to vote on social media.

    Big Brother Naija 2019 first runner-up, Mike Edwards
    Wetin we call dis foto, Big Brother Naija 2019 first runner-up, Mike Edwards
  7. Winner best dressed female

    Mercy Eke
    Wetin we call dis foto, mercy Eke also win di 2019 edition of reality TV show Big Brother Naija
  8. Best Actor in a comedy (Movie/TV series)

    Chibunna 'Funny Bone' Stanley
    Wetin we call dis foto, Funnybone for Red carpet

    Di winner of dis award go to Chibunna 'Funny Bone' Stanley for di role wey im play for di movie Smash.

  9. Best Actress in a Comedy (Movie/TV series)

    And di winner na Funke Akindele aka Jenifer for di movie Moms at war.

    Funke don win dis category for di fourth time now

    Funke Akindele AMVCA Best Acress in Comedy (Movie/TV Series)

    Wia dis foto come from, Funke Akindele/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Funke Akindele AMVCA Best Acress in Comedy (Movie/TV Series)
  10. Best Supporting Actor (Movie or TV series)

    Pascal Tokodi na di winner for di movie Disconnect.

  11. Best Supporting Actress (Movie or TV series)

    Gloria Sarfo

    And di winner na...Gloria Sarfo for her role for di movie Perfect Picture: 10 years later.

  12. Industry Merit Award

    Dis award go to Peter Igho, papa of Tosin Igho wey follow win Best Picture Editor.

  13. Best Movie West Africa

    First released for 1992 and 1993 and later for 2019 dis movie star Kenneth Okonkwo, Ramsey Noah and many odas.

    Living in Bondage na di winner of dis category.

  14. Best Movie East Africa

    Sarah Hassan na di winner for dis category.

  15. Best Movie Southern Africa

    Di winner for dis category na Abraham Kabwe from Zambia for di movie Dalitso

    Abraham Kabwe from Zambia
  16. Best Multichoice Talent Factory film Award - East Africa Movie

    And di winner na...Promises

  17. Best TV series Drama/Comedy

    Anis Halloway from Sierra Leone don collect dis category.

    Anis Halloway
  18. Best Short Film or Online Video

    Bola Akanbi na di winner for dis category.

    Dis na im first film and im first nomination ever.

    Bola Akanbi AMVCA Best Short Film or Online Video

    Wia dis foto come from, BOLA AKANBI/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Bola Akanbi AMVCA Best Short Film or Online Video
  19. Best Indigenous Language Movie/TV Series - Igbo

    Di award go to...Victor Iyke for di movie Nne

    Dis na im first award as filmmaker ever for im career

    Yewande Famakin AMVCA Best Indigenous Language Movie/TV Series - Yoruba

    Wia dis foto come from, YEWANDE FAMAKIN/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Yewande Famakin AMVCA Best Indigenous Language Movie/TV Series - Yoruba
  20. Best Indigenous Language Movie/TV Series - Yoruba

    Yewande Famakin na di winner for di movie Alubarika

    Yewande Famakin AMVCA Best Indigenous Language Movie/TV Series - Yoruba

    Wia dis foto come from, Yewande Famakin/INSTAGRAM

    Wetin we call dis foto, Yewande Famakin AMVCA Best Indigenous Language Movie/TV Series - Yoruba