WHO dey trace 65 passengers wey enta plane wit Italian man
Lagos State Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi say World Health Organisation don dey trace passengers wey enta di Turkish Airlines flight wit di Italian man wey carry Coronavirus enta di kontri.
Prof. Abayomi tok dis one wen im follow tori pipo tok, e say out of di 84 passengers wey dey live for Lagos, dem don find 49 but 35 still no dey reachable.
He say 35 pipo wey fit don get contact wit di Italian man still dey under 14 day quarantine. So far none of dem don develop symptom of di virus.
Di oga of health add join say dem dey monitor six pipo from di hotel di oyinbo man lodge and drivers wey carry am. For now dem neva separate anybody. Four pipo don dey tested, three dey negative and one positive.
On top why dem neva mention di Italian man name, Prof. Abayomi say e dey against medical ethics.
Di oyinbo man enta Lagos from Milan for February 24th and still dey collect treatment for di Infectious Disease Centre, for Yaba.

Wia dis foto come from, Prof. Akin Abayomi/FACEBOOK
















