Ahmed Lawan, Femi Gbajabiamila go lead Nigeria 9th National Assembly

Nigeria national lawmakers on Tuesday elect those wey go lead dem for di Senate and House of Representatives.

Live Coverage

Helen Oyibo and Fiona Equere

  1. Di president and di speaker

    Lawan Ahmed and Gbajabiamila Femi

    Wia dis foto come from, Lawan/Femi Twitter

    Na hia we go match break ontop dis Live Page wey don bring you all di tori since morning, as federal lawmakers for Nigeria elect dia leadership.

    For senate, Ahmed Lawan and Ovie Omo-Agege na di presido and deputy presido.

    For di House of Reps, Femi Gbajabiamila and Ahmed Wase na di speaker and deputy speaker.

    Until anoda time, e go be.

  2. Breaking, New beginning wey dey different from di immediate past - Buhari

    Presido Muhammadu Buhari don congratulate di newly elected leaders of di 9th National Assembly.

    Di president describe di election by lawmakers as "new beginning wey dey different from di immediate past."

    Im still add say make di pipo wey lose join hands wit di winners and make dem no dey attack demselves.

  3. Who be Femi Gbajabiamila?

    Femi Gbajabiamila

    Wia dis foto come from, Femi Gbajabiamila

    Wetin we call dis foto, Nigeria number four man

    On Tuesday, lawmakers for Nigeria House of Representatives elect Femi Gbajabiamila as di speaker of dia from 2019 to 2023.

    Abdulmumin Jibrin, nominate Di former Majority Leader of di eight House of Representatives wey dey represent Surulere constituency and im go up against Umar Bago wey also dey im party.

    Di candidate of di All Progressives Congress (APC) get 281 votes to defeat Umaru Bago wey contest against am. Oga Bago get 76 votes.

    Gbajabiamila declare im intention to be speaker for March wit di support of im party.

    Who be Femi Gbajabiamila?

    Dem born am on 25 June 1962 and oga Gbajabiamila na lawyer wey come from Lagos State.

    For 1984, dem call am to di Nigerian Bar afta im graduate from University of Lagos for 1983 wit law degree.

    Im work for Bentley Edu & Co, wey be di first law firm for Nigeria before im open im own wey im call Femi Gbaja and Co. Im go America wia im go John Marshall Law School for Atlanta, Georgia and afta im get degree to practice law.

    Tori bin comot say dem suspend am from practicing law for di state over magomago accuse but Gbajabiamila say no be true and say im go take legal action on top di tori.

    Political Career

    Femi Gbajabiamila enta politics under di platform of Alliance for Democracy (AD).

    Im don dey di House of Representatives since 2003 and im dey represent di Surulere Federal Constituency of Lagos State.

    For 2011, dem nominate am for National Honour but im turn am down. Im don also push for major bills for di house like di Employee Rights Bill, Central Bank of Nigeria (Amendment) Bill and di Bill for Electric Power Reform Act wey go stop and criminalise estimated billing by Electricity Distribution Companies. Im also head di House of Representatives Committee on Ajaokuta Steel Company Limited.

  4. Ahmed Wase na deputy speaker for Nigeria House of Representatives

    Ahmed Wase from Plateau State na im Deputy Speaker for Nigeria House of Representatives.

    Oga Wase get di position unopposed, as dem no do election for di position.

    Di Plateau State lawmaker na member of di majority All Progressives Congress (APC) wey campaign wit di speaker, Femi Gbajabiamila.

  5. Breaking, Femi Gbajabiamila na Speaker, Nigeria House of Representatives

    Femi Gbajabiamila

    Wia dis foto come from, @femigbaja

    Members of Nigeria House of Representatives don finish voting to elect dia speaker.

    Femi Gbajabiamila wey dey represent im pipo from Lagos State, get 281 votes while Umaru Bago wey contest against am get 76 votes.

    Earlier, senators bin elect Ahmed Lawan as Nigeria Senate Presido.

  6. Breaking, Voting don end

    Dem dey count di votes for di two candidates wey contest for di position of speaker of Nigeria House of Representatives.

    Once dem finish counting, di clerk of di house go announce di winner.

  7. Breaking, Who be Ahmed Lawan, Nigeria Senate Presido?

    Ahmed Lawan

    Wia dis foto come from, @nass

    On Tuesday 11 June 2019, Senator Ahmed Lawan become di presido of Nigeria Senate to di 9th National Assembly. Dis position im dey occupy make am di number three man for di kontri afta di president and vice.

    By di morning of Tuesday, Senator Lawan na just one of di oda 109 members wey dey di red chamber, but im go go house as Nigeria Senate President.

    So who be Ahmed Lawan?

    Dem born am for 1959 and oga Lawan na graduate of University of Maiduguri wia im study Geography for 1984. Di senator wey dey represent Yobe North also get Masters Degree and Doctorate Degree for Remote Sensing from Cranfied University for UK. Before im enta politics, oga Lawan bin work as Education Officer for Yobe State Ministry of Education as civil servant.

    Im also lecture for 10 years from 1987 to 1997 for University of Maiduguri. Road to National Assembly Oga Lawan waka enta politics for 1999 wen im contest for seat for House of Representatives to represent Bade/Jakusko Federal Constituency for Yobe State.

    Di lawmaker win re-election into di Green House again for 2003 and serve as chairman of di house committee on Agriculture and also as head of Education Committee for 2005.

    For 2007, Ahmed Lawan contest and win election to be senator wey go represent Yobe North Constituency for Senate. Since den, senator Lawan don win re-election three times to stay for di senate wia im don serve as chairman of Senate committee on Public Accounts and sponsor di Desertification Control Commission Bill.

    For 2015 Ahmed Lawan na one of di favourites to become di Senate President under di All Progressives Congress (APC) but Senator Bukola Saraki beat am to di position. But on Tuesday 11 June 2019, senators wey reach 79 vote in favour of Senator Ahmed Lawan to be di Senate President over Ali Ndume wey score only 28 votes.

    Di Senator wey dey represent Yobe North Constituency go now serve as Senate President of di ninth assembly for di next four years.

  8. Who e go be?

    Dis na di face of di two men dem don nominate to be speaker of Nigeria House of Representatives.

    As e be so, lawmakers dey vote for which of di two go lead dem and occupy di number four position for Nigeria.

    Both of dem no be JJC for lawmaking bizness, as dem be returning members of di House of Reps.

    Femi Gbajabiamila wey dey left from Lagos State while Umaru Bago wey dey right, dey represent im pipo for Niger State.

    Gbajabiamila and Bago

    Wia dis foto come from, Gbajabiamila/Bago Twitter

    Wetin we call dis foto, One of dis men go be Nigeria next speaker of di lower chamber
  9. Breaking, , WATCH LIVE as members of Nigeria House of Reps dey elect dia speaker.

  10. Voting don start

    House of Representatives

    Di 360 members elect dey vote who dem want to be Speaker of di House of Representatives.

  11. Dem don nominate Hon. Umaru Bago

    Hon. Abubakar Ahmad move di motion and Hon. Mark Terseer second am for Umaru Bago to become di Speaker of House of Representatives.

  12. Dem don nominate Hon. Femi Gbajabiamila

    Hon. Abdulmumini Jubril move di motion wey Hon. Lynda Chuba-Ikpeazu second for Femi Gbajabiamila to become Speaker of House of Representatives.

  13. As e dey happun

    Watch di Inauguration of di House of Reps as e dey happun live.

  14. Dem don begin Inaugurate House of Reps members

    House of Representatives
    Wetin we call dis foto, Members of house of reprensatives

    Roll call for di 360 members of di House of Representatives don start.

  15. Former govnor of Osun State don congratulate Senator Ovie Omo-Agege

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  16. Senator Ovie Omo-Agege na deputy senate president

    OVIE OMO-AGEGE/FACEBOOK

    Wia dis foto come from, OVIE OMO-AGEGE/FACEBOOK

    Wetin we call dis foto, Senator OVIE OMO-AGEGE

    Senator Ovie Omo-Agege,don become di deputy senate president of Nigeria. Omo Agege defeat former deputy Senate president Ike Ekweremadu of di People’s Democratic party with 68 votes. Ekweremadu poll 37 votes.

  17. House of Reps still dey wait for dia turn, 360 House of Reps.members go vote to elect who go lead dem for di next four years.

  18. Voting don start

    Di Senator elect dem dey go round again for di second time to vote dia choice for di position of di Deputy Senate President.

  19. Who go be di Deputy Senate President?

    Senator Ovie Omo-Agege and Ike Ekweremadu dey lock horn for di position of di seat of di Deputy President of di Ninth National Assembly.

    While Omo-Agege na di ruling APC choice, Ike Ekweremadu nad di immediate past Deputy Senator of di Eight Assembly.

  20. Ahmed Lawan na di new Senate President

    Ahmed Lawan

    Wia dis foto come from, Facebook

    Wetin we call dis foto, Ahmed Lawan

    Wetin happun for 2015 no happun today.

    Di candidate wey di ruling All Progressives Congress endorse don win.

    Ahmed Lawan win im rival Ali Ndume with 79 votes against 28 wey Ndume get to become di Senate President of di Ninth Assembly.