Di governorship Candidate of African Action Congress AAC Biokpomabo Awara say make Nigeria election office INEC declare am di winner of di governorship election for Rivers State.
Dis dis tok dey come one day afta Independent National Electoral Commission, INEC suspend evritin wey concern election mata inside di state wey dey for south-southern Nigeria.
Awara tell BBC News Pidgin say because from result wey dem get, im dey lead for 15 local goment areas before INEC come suspend di election say di reason wey dem give say violence dey no hold water.
Di AAC Candidate come demand say make INEC also redeploy di INEC Resident Electoral Commissioner Obo Effanga comot because im allege say di REC and oda INEC Staff and Adhoc staff dem dey biased to favour PDP.
E claim say because dem carry pipo wey be card carrying members of PDP to be Returning Officers and because say di REC no fit conduct any election successfully for Rivers State.
INEC reply Rivers AAC candidate tok say e no hold water
BBC News Pidgin ask di INEC Resident Electoral Officer for Rivers State Obo Effanga say di allegations no dey true and e no get any substance because di Commission don set up fact finding team to audit di electoral process as e dey now.
Effanga wey dey respond to all all dis accuse for Biokpomabo Awara say e better to allow di INEC audit committee from Abuja to finish dia work.
Di INEC Oga for Rivers State say dem follow due process to appoint returning officers so if pipo wey get political interest dey inside, no be dia intention because for di training and recruitment time, dem tell each pesin say dem no go fit serve as electoral officials if dem get any partisan interest.