Ivory Coast begin Afcon 2023 wit victory over Guinea Bissau

Hosts Ivory Coast begin di 2023 Africa Cup of Nations wit comfortable 2-0 victory over Guinea-Bissau.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Bye!, FT: Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Ivory Coast celebrate

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Afcon 2023 don kick-off as hosts Ivory Coast begin di tournament wit 2-0 victory over Guinea-Bissau.

    On Sunday, three more games go take place

    • Nigeria vs Equatorial Guinea (14:00 GMT)
    • Egypt vs Mozambique (17:00 GMT)
    • Ghana vs Cape Verde (20:00 GMT)

    You fit check out all di fixtures and group table for here.

    Scroll down to read how di opening match of Afcon 2023 go.

  2. , FT: Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Even though some football fans say di match bin dey boring , dem happy say Ivory Coast collect maximum points.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2

    End of X post, 2

  3. Guinea-Bissau still dey wait for Afcon goal, FT: Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Guinea-Bissau don fail to score for dia last eight matches for Africa Cup of Nations, dis match see dem exten dia own record for any team in di history of di competition.

    E don pass more than 13 hours since dem last find di net (797 minutes), Piqueti score against Cameroon on 18 January 2017.

    Only Benin (14) and Mozambique (12) don play more matches than Guinea-Bissau (10) for di tournament without winning one.

  4. Ivory Coast begin Afcon 2023 wit victory over Guinea Bissau, FT: Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Ivory Coast players celebrate

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ivory Coast open di 2023 Africa Cup of Nations wit a comfortable 2-0 victory over Guinea-Bissau.

    Di hosts take early lead through Seko Fofana inside di opening five minutes to increas di party-like atmosphere inside di Alassane Ouattara stadium.

    Despite containing di threats from Guinea Bissau, Ivory Coast double dia lead early in the second half through Philippe Krasso on 58 minutes.

    Fofana also hit di crossbar for Ivory Coast and na dem go happy pass as dem bag di three points in front of over 60,000 pipo.

  5. FULL-TIME, FT: Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Afta 90 minutes of action, di hosts fit celebrate now.

    Di Elephants don open dia Afcon campaign wit comfortable 2-0 victory over Guinea Bissau.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. , 90+1 mins

    Nicolas Pepe show some tricks as im make e way to di penalty box.

    Di former Arsenal man blast a left foot shoot well over di bar.

    On di other end Semedo try im luck from distance but na weak shoot im produce.

  7. SUBSTITUTION, 90 mins

    Ivory Coast use dia last window for substitution.

    Doumbia don enter di match in place of Sangare.

  8. , 89 mins

    Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Dis game look like e go end in di favour of di hosts wit only one minute remaining before injury time.

    Ze Turbo try im luck again from outside di box. E be like e lack compossure as e rush di shot, di ball go out for goal-kick

  9. , 85 mins

    Ze Turbo rise high inside di box and connect wit a left wing cross.

    Di ball dey too high to trouble di goalkeeper.

    Meanwhile Daicio don take di place of Mama Balde for Guinea-Bissau.

  10. SUBSTITUTION, 77 mins

    Surprise change here from Ivory Coast.

    Coach Jean-Louis Gasset don take off centre-back Ousmane Diomande. Im replace am with Wily Boly.

    Di hosts firmly dey in di lead here.

  11. SUBSTITUTION, 76 mins

    Guinea-Bissau make anoda change to freshen tins up.

    Ze Turbo don enter di game and e replace Mauro Rodrigues wey look like e don taya.

    Meanwhile Ivory Coast midfielder Franck Kessie fire shot wey di Guinea-Bissau goalkeeper save well go out for corner-kick.

  12. , 73 mins

    Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Franculino break free down di left before im shoot left footed shot straight into goalkeeper Fofana.

    Guinea-Bissau dey try to get at least a goal for dis game.

  13. SUBSTITUTION, 65 mins

    Franculino and Carlos Gomes don replace Carlos Mane and Cassama for Guinea-Bissau

  14. SUBSTITUTION, 61 mins

    Karim Konate and Nicolas Pepe don come on for Ivory Coast.

    Dem replace Jonathan Bamba and di goalscorer Krasso.

  15. GOAL, 58 mins

    Krasso celebrate

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Krasso (L) double Ivory Coast lead

    Ivory Coast 2-0 Guinea-Bissau

    Phillipe Krasso double Ivory Coast lead!

    Di forward produce some good jugging skills before im volley di ball beyond di goalkeeper.

  16. , 50 mins

    Ivory Coast 1-0 Guinea-Bissau

    Ivory Coast defender, Aurier wey just enter fail to pick im marker as Rodrigues run free wit di ball.

    Di forward try to pick out Carlos Mane but Konan track back to clear di ball out for corner.

    From di corner-kick, Bikel head di cross over.

  17. SUBSTITUTION, 46 mins

    Ivory Coast make change to dia side.

    Right back, Serge Aurier don replace Wilfried Singo

    Di second half don begim

  18. First half reactions

    Football lovers don begin react to dat first 45 minutes of di 2023 Afcon.

    While some pipo dey happy say hosts Ivory Coast dey lead 1-0, odas say di match no too make sense.

    While some oda pipo dey tok about di opening ceremony.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3

    End of X post, 3

  19. , Ivory Coast 1-0 Guinea-Bissau

    Group A

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ivory Coast dey boss tins so far for dis opening match of di Afcon.

    But dem go fit boss group A?

    Nigeria and Equatorial Guinea also dey for di group and both teams go play dia first match tomorrow.

  20. HALF-TIME

    Ivory Coast celebrate

    Wia dis foto come from, Caf_Online

    Wetin we call dis foto, Seko Fofana goal na im first for Afcon and e sixth for Ivory Coast

    Ivory Coast 1-0 Guinea-Bissau

    Afta four minutes of added time, referee Amin Mohammed don blow for half-time.

    Di fans inside di stadium still dey cheer on dia teams.

    So far Seko Fofana early strike na im separate di two side.