Newcastle draw for Milan on dia return to Champions League

Among all di English teams, na Newcastle dey wetin many pipo believe say na di toughest group wit di likes of Paris St-Germain, Italian giants AC Milan and former Champions League winners Borussia Dortmund.

Live Coverage

Tunde Ososanya and Victor Ezeama

  1. Una goodnight

    Our coverage of Champions League go kontinu tomorrow wit di game between Bayen Munich and Manchester United

  2. Dis return no dey spectacular, but na reasons for encouragement

    AC Milan vs Newcastle

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Nick Pope make several important saves for Newcastle

    Newcastle fans bin travel in dia thousands to Italy, as dem wan be part of history as dia side make di a return to di top table.

    Initially, di Magpies bin no look overawed by di occasion as dem pass di ball around well and attack wit numbers, but e no take long for seven-time European champions Milan to take control.

    Newcastle perhaps show dia opponents too much respect for di first half, and e look like a matter of time before Howe side go fall behind, but dem find dia feet and dia confidence in a much more even second half.

    Aside from Longstaff late effort, di visitors bin fail to create much but dem defend resolutely. If dem show more bravery in attack in future games, di Newcastle fans go believe dia side fit compete wit some of Europe's best for dis season Champions League.

  3. Newcastle draw for Milan on dia return to Champions League

    Newcastle draw for Milan on dia return to Champions League

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Newcastle mark don mark dia return to di Champions League afta a 20-year absence wit creditable draw for AC Milan.

    Eddie Howe side don come back to Europe elite club competition afta finishing fourth for di Premier League last season, and dis na dia first match for a tough Group F wey also contains French champions Paris St-Germain and German giants Borussia Dortmund.

    Dem give dem reminder of di difficulty of games for dis competition as Milan dominate di first half, wit Nick Pope saving well from Olivier Giroud and Theo Hernandez.

    Rafael Leao bin waste golden chance to score as im fluff im backheel afta one fine solo run, and Newcastle dey fortunate to go into di break level.

    But di game bin dey much more even for di second half. Former Milan midfielder Sandro Tonali see a shot blocked for di visitors, while Tijjani Reijnders bin force a decent save out of Pope wit a low drive.

    Leao really suppose win am for di closing stages wen e get between Newcastle defenders to meet a cross, but im bin head just ova.

    For di end, no breakthrough dey forthcoming, wit a point at di San Siro, na encouraging result for Newcastle.

  4. FULL-TIME, 90+7 mins

    Nope. Na one point each.

    Newcastle go gladly take am, Milan no go too take am.

  5. 90+6 mins

    Ohhhh. Marco Sportiello rise and tip di ball away to di oda side. Shey we get time for anoda corner?

  6. 90+6 mins

    Oh my! Newcastle almost nick am!

    Sean Longstaff dey set up on di edge of di box for one rising shot wey Marco Sportiello tip ova.

    Imagine di scenes if dat one hit di net? Na corner, wit seconds left...

  7. 90+4 mins

    Into di final of di added five minutes. Newcastle almost get one point.

  8. 90+3 mins

    Men don go forward but di first head to di delivery na Milan get am. E send dem away on di break before Kieran Trippier get back to slide in and win di ball.

  9. 90+3 mins

    Newcastle get free-kick just inside di Milan half. Dem fit commit men forward to try and win dis?

  10. 90+2 mins

    Christian Pulisic corner dey ova evri one and Harvey Barnes poke di ball away. Milan still dey on di attack but dem no fit make anytin happun as Tijjani Reijnders fire ova from range.

  11. 90+1 mins

    We dey into added time. Five minutes of am. Milan get one corner.

  12. YELLOW CARD, 90 mins

    Harvey Barnes dey on for Newcastle, as im take di place of Alexander Isak.

  13. 90 mins

    Di final minute of di 90. Shey either of di team nick a big win? Milan look like say na dem fit do am.

  14. 89 mins

    Rade Krunic of AC Milan gatz dey veri careful for di rest of di match afta im receive yellow card from di referee for bad tackle on one opponent.

  15. SUBSTITUTION, 81 mins

    One blow for di home side. Not just tonight but beyond.

    Mike Maignan gatz go off. Im spend a lot of last season wit injury and na big player for Rossoneri. Morco Sportiello enta for im Milan debut.

  16. 88 mins

    Anoda great opening for Milan stuffed up by Rafael Leao, wey im control let am down as im try to set up a team-mate.

    Christian Pulisic get one shot away but e enta crowd and dem block am.

  17. 86 mins

    Elliott Anderson gatz make well-timed tackle to stop Rafael Leao breaking through and in on goal.

  18. YELLOW CARD, 84 mins

    Now Olivier Giroud dey booked for im reaction afta dem judge am say im aerial challenge for Dan Burn na foul. Dis just dey help Newcastle, wey get six minutes of normal time followed by di rest to see out.

  19. RED CARD, 82 mins

    Great work from Bruno Guimaraes, wey carri di ball up di field, draw foul from Yunus Musah wey get di Milan sub booked.

    Di resulting free-kick dey pumped into di box but dey headed down by Dan Burn for di new Milan keeper to gada.

  20. 80 mins

    Mike Maignan, di Milan keeper, don go down off di ball and im need treatment. E give Newcastle a breather wey dem need.