How Man City hold Real Madrid to draw first leg of Champions League semifinal

Two heavyweight clubs meet each oda for di first leg of di Champions League Semifinal.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Man City hold Real Madrid to draw for first leg of Champions League semifinal, Real Madrid 1-1 Man City

    Kevin de Bruyne celebrate

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Man City dig deep to earn 1-1 draw wit Real Madrid for di first leg of dia Champions League semifinal meeting.

    Second half strike from Kevin De Bruyne cancel out di goal wey Vinicius Junior score minutes afta di half hour mark to see di game end all square.

    Everitin still dey to play for di tie as both Real Madrid and Man City go hope to progress to di final for Istanbul wen dem meet again in a week time.

  2. Full time, Real Madrid 1-1 Man City

    All to play for now for di second leg as referee Artur Soares don blow im final whitsle to end dis first leg encounter.

  3. , 90 mins

    Ederson produce anoda good save to deny Tchouameni from scoring.

    Referee don add three more minutes.

  4. , 89 mins

    Jack Grealish almost play di ball through to Erling Haaland but Antonio Rudiger makes crucial interception.

    Back with Real Madrid. Only minutes remain now before added time.

  5. , 86 mins

    Bernado Silva receive yellow card for foul wey im commit.

    Meanwhile Real don send on Nacho in place of Luka Modric.

  6. , 84 mins

    Real introduce more fresh legs as Aurelien Tchouameni don come on in place of Toni Kroos.

    Real Madrid 1-1 Man City

  7. , 81 mins

    Substitution for Real - Marco Asensio don come on to replace Rodrygo Goes.

  8. , 77 mins

    Karim Benzema find imsef free for di back post of City defense.

    Im connect well wit Kroos freekick but Ederson stretch out im hand to save di header.

    Real Madrid 1-1 Man City

  9. , 72 mins

    Ilkay Gundogan don collect yellow card for im foul on Carvajal

  10. , 70 mins

    Moments afta di goal, Real coach Carlo Ancelotti receive yellow for di way im protest against di City goal.

  11. Breaking, De Bruyne equalise for City, Real Madrid 1-1 Man City

    Kevin De Bruyne long range shot draw City level!

    Real Madrid players want di ref to disallow di goal as dem believe say di ball go don go out before Bernado Silva keep am in.

    Im pass to Gundogan wey later give di ball to De Bruyne. Di Belgian waya better shot past Courtois to equalise for City.

  12. , 65 mins

    Good feet from Rodrygo wey dance past Manuel Akanji and win corner.

    Antonio Rudiger get im head on di ball but City clear di ball.

    Real Madrid 1-0 Man City

  13. , 60 mins

    Valverde try im luck from outside di area, di midfielder shot rise high and continue to dey rise as e go out for goalkick.

  14. , 58 mins

    Vinicius Junior and Real Madrid now dey press Man City.

    Firstly di Brazilian see Stones deflect im shot out for corner before Rodrygo send anoda shot into Man City defender go out for anoda corner.

    Real Madrid 1-0 Man City

  15. , 55 mins

    Man City again test Courtois wit low shot wey im save easily.

    Moments later, Haaland race towards goal but Rudiger block im shot well go out for cornerkick.

    Real Madrid players clear di cornerkick.

  16. , 52 mins

    What a save by Courtois!

    De Bruyne tin say im don beat Real offside trap as im race down di goal come shoot fine shot towards goal.

    Di goalkeeper save im shot well before linesman raise im flag for offside.

  17. , 50 mins

    Camavinga, Benzema and Vinicius work di ball well to produce good chance for di striker to take quick shot wey Ederson palm wide for cornerkick.

    Di cross from di corner no meet any City player

    Real Madrid 1-0 Man City

  18. , 46 mins

    Both teams don return to di pitch.

    Real madrid go resume play wit di first kick of di second half.

    Real Madrid 1-0 Man City

  19. Half time, Real Madrid 1-0 Man City

    Referee Artur Manuel Soares Dias don blow for half time.

    Very entertaining first half wey see di hosts take di lead through Vinicius Junior wonder strike from outside di box.

  20. , 44 mins

    Dani Carvajal and Jack Grealish get involve in tins wey no dey necessary.

    Di defender jam di midfielder into di advertisement board.

    Carvajal later go down as im claim say Grealish retaliate.

    Di referee no see any reason why im go dey involve as im ask for di game to kontinu.

    Real Madrid 1-0 Man City.