You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ghana vs Nigeria - How e happun live for Kumasi

Ghana dey play dia fellow West Africa neighbours Nigeria for di Baba Yara Stadium for Kumasi.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Una good night!

    Na here we go march break for our coverage of di Ghana vs Nigeria world cup qualifier play off wey happun for Kumasi, Ghana.

    Thank you for staying wit us.

    Good night!

  2. Ghana vs Nigeria WorldCup playoffs end 0-0, Di return leg go happun on Tuesday for Abuja, Nigeria capital.,

    Di ogbonde Ghana vs Nigeria WorldCup playoffs first leg end for barren draw.

    For inside di match, two pipo chop yellow cards.

    Alexander Djiku of Ghana and Oghenekaro Etebo.

    Etebo chop yellow card sake of one controversial moment wen im bin tink say referee go award penalty afta dem fowl am.

    But referee go check VAR come see say no be penalty.

    Match statistics show say Ghana get three shots on target while Nigeria get two.

    Ghana get 52 percent ball possession while Nigeria get 48.

    Ghana get nine corner kicks while Nigeria get two.

    For goalkeeper saves, Ghana get two while Nigeria get three.

    All eyes dey focused on Tuesday for di return leg for Abuja, Nigeria capital.

    Di match still open, but Nigeria get advantage as dem pick one point against Ghana for dia house.

  3. Breaking, Full Time....

    Ghana 0-0 Nigeria.

  4. Four mins extra time

    90 minutes don reach and di match don enta extra time.

  5. Calvin Bassey error almost cost Super Eagles

    Bukari run from di wing afta Bassey lose posseion. Na Emmanuel Dennis come save di situation.

  6. Di two teams don dey tire

    Na five minutes remain for dis tension game.

    Both teams dey play carefully and dem dey look for counter attack

  7. Inside di last 10mins

    Di two teams still dey play 0-0.

  8. Ghana make second substitute

    Daniel Koffi-Kyereh enta for Gyan.

  9. Ghana make first subsitution

    Osman Bukari enta for Issahaku.

  10. Ghana vs Nigeria WorldCup playoffs: How e be so far, Na still goalless draw afta seventy minutes,

    Ghana and Nigeria still dey kwanta for dis ogbobge match.

    As e be so, no side don score goal, Ghana and Nigeria don get plenti chances but dem neva convert any one.

    Pressure dey well-well for di Super Eagles defence.

    DI Ghanaian defence too don feel pressure from di Super Eagles.

    Moses Simon don comot and na Ademola Lookman replace am.

    Football fans from both kontris still dey hope say dem go win.

  11. Referee cancel Super Eagles penalty

    Oghenekaro Etebo collect yellow card afta e protest referee decision to cancel penalty.

  12. Two substitute for Nigeria

    Moses Simon comot for Lookman. Im na di Leicester forward wey just pledge im allegaince to Nigeria

    Cakvin Bassey enta for Zaidu.

    Super Eagles don make five changes.

  13. In oda news...

    We dey get reports say serious power and connectivity issues hit di stadium - to di extent say none of di broadcasters dia fit go on air.

  14. Black stars dey press

    Francis Uzoho save anoda shot from Ghana.

    Dem nearly score again from anoda corner kick

  15. Nigeria get free kick

    Kelechi kick hit Ghana wall. Di ball go corner.

    Nigeria first corner of di game.

  16. Jordan Ayew shoot

    Crystal Palace foward shoot ball from di half go over di bar.

  17. Two substitutes for Super Eagles

    Emanuel Dennis enta for Samuel Chukwueze.

    Oghenekaro Etebo enta for Innocent Bonke.

  18. First Yellow card

    Ghana defender Alexander Djiku get di first yellow card of di game afta e use hand stop Osimhen.

  19. Substitute for Super Eagles

    Frank Onyeka enta for Joe Aribo.

  20. Wollacott save Simon shot

    Black stars goalkeeper save shot from Simon Moses