How day one of End bad governance protest waka across Nigeria

Summary

  • Kano state government partially relax curfew to allow for prayers
  • Day two of di protests dey on across states of di federation
  • Di protests na against wetin dem describe as hunger and bad governance
  • For Abuja, Nyesom Wike wey be di Minister of di Federal Capital Territory say make demonstrators limit dia activities to di Moshood Abiola Stadium
  • Lagos, Rivers, Oyo, and some oda places dey peaceful for day two of di protest

Live Coverage

Tunde Ososanya, Annette Arotiba, Helen Oyibo and Kareemot Salami

  1. Una bye-bye!

    protester hold placard for hand

    We go use dis picture take end our live coverage of di protests for Nigeria today.

    You fit scroll down di page to see how di day waka across di kontri.

    Join us again tomorrow for Day 2 of di protests.

    Bye-bye.

  2. Round up of Nigeria protests on day one

    In case you just dey join us, dis na some of di tins wey happun today as protests kick off for Nigeria on 1 August.

    • Protesters turn up for Lagos, Kano, Oyo, Rivers, FCT, Jigawa, Sokoto, Zamfara and oda states across di kontri against di nationwide economic hardship protest.
    • #Endbadgovernance protesters and pro-goment protesters jam for Lagos state.
    • Plenty security operatives mount and full ground across di kontri to beef up security for di protest.
    • Di peaceful protest turn violent for Kano state northcentral Nigeria as police open teargas on some protesters and reports dey ground say at least on eperson die afta police allegedly shoot am.
    • Govnor Abba Kabir Yusuf of Kano declare curfew afta looting and shooting happun for di state.
    • Police use teargas disperse Abuja protesters wey wan protest for Eagles Square against court ruling wey limit dem to di Abuja National Stadium.
    • For places like Enugu state and Kwara state, di protest no hold.
  3. 'Nyanya division no burn down' - FCT Police

    Contyainer wey don burn

    Wia dis foto come from, FCT police

    FCT police don debunk tori wey dey go round say Nyanya division dey burnt down by violent protesters.

    Di federal capital police say na police container compartment for Nyanya checkpoint wey some hoodlums set fire to.

    Dem add say dem don arrest di four suspects wey bin vandalize di Tipper garage police post.

    Commissioner of police, FCT, Benneth Igweh, psc, say pipo get right to protest but say to destroy public or police property no dey allowed.

    Oga Benneth add say any violent protester wey dem arrest for destroying public property go face di wrath of the law.

  4. Why protest no happun for south east Nigeria

    Empty street for Enugu wia pipo no come out to protest
    Wetin we call dis foto, Empty streets for Enugu wia pipo no come out to protest

    Endbadgovernance protest happun for different parts of Nigeria on Thursday. For some areas e peaceful, for odas e end up for looting and shooting.

    But for di south east of Nigeria, di home of di Igbo pipo, BBC Pidgin see say streets dey empty as pipo for di five states wey dey dis region, dey dia house dey either observe sit-at-home, or no just send di protest.

    From Enugu, Imo, Abia, Anambra reach Ebonyi, di tori na di same. All di streets dey empty like say pipo don run comot from di state.

    Different kains of reasons dey wey fit to explain di position of di south east not to protest. But one stand out pass any oda.

    Since Nigerians don dey threaten to do hunger protest for some months now, Igbo groups don dey tok say dem no wan follow protest, as dem believe say dia waka and di waka of oda parts of di kontri no be di same.

    Ohanaeze ndi Igbo bin don dey announce say Igbo pipo no want any protest, instead wetin dem want na make goment release leader of di proscribed Indigenous Pipo od Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, create more states for di east region, create jobs for youths and allow Igbos hold leadership positions.

    For state like Imo state wia Ipob dey reign, di five days sit-at-home wey dem bin declare from 29 July to 2 August, make am compulsory for everybody wey dey live for di state sidon for house.

    Inside di first three days, Ipob carry out deadly attacks wey kill four policemen plus two civilians, to pass dia message across say make pipo siddon for house.

    Still, even without di criminal act of Ipob members, di pipo of south east for still no follow do di I-no-go-gree waka, becos different groups for di states get collective agreement say, dis no be wetin di Igbos want at dis time.

  5. Lagos day one protest end, Road don dey empty

    Di day one protest for Lagos state don end as di organisers say dem go return for di second day.

    Many of di protesters begin dey comot as police dey monitor dem.

    According to the organisers, di protest go continue early morning for Friday 2 August 2024.

    Di police begin dey parade di road to see say di protesters dey comot di venue for Ojota.

    Di protest for Lagos dey peaceful for di day one and casualties no dey.

  6. ‘Dis economy no make me get pikin’- Protester,

    One of di protesters wey show face for di #EndBadGovernance march wey happun for Lagos today, Mr Abiola say di current economic situation dey really affect am.

    Di man wey dey im 40s say di condition wey e find imsef no allow am get pikin say di kontri ‘hard’.

    “As I dey, I get plenty challenges. I no get any pikin and na me be di second for for my family. I get plenty tins to do.

    Mr Abiola say im plea for di goment na to make fuel prices come down so e no go too affect pipo.

    “Any president wey dey now make e bring fuel price come down,” e tok

    Howeva, some oda protesters wey BBC Pidgin follow tok agree say dem want make di protest send message to di govment and politicians to make kontri betta.

  7. Breaking, Kano state government declare 24 hours curfew

    Govnor Abba Kabir Yusuf don declare 24-hour curfew for Kano State.

    Dis one dey inside statement wey Sanusi Bature Dawakin Tofa, di Govnor spokesperson, sign, wey tok say di govnor don direct all security agencies for di state to ensure say pipo comply.

    Dis dey come after di EndBadGovernment peaceful protest turn to violence for Kano wia one person die and oda sustain critical injury

  8. Small gbege between police and protesters happun for Ojota,

    Police dey move back from di protesters
    Wetin we call dis foto, Men of di Nigeria police comot for middle of protesters

    Small gbege happun between di police and protesters for Ojota.

    Di police bin wan use force enta di protesters but dem no gree as dem stand say dia march don dey peaceful since.

    Some pipo begin dey throw water to di police but di officers no do anytin back.

    Afta small tok, di police bin begin move back in group.

  9. ‘I know say una dey hungry’ - Siminalayi Fubara

    Governor Fubara

    Wia dis foto come from, Government, Rivers state

    Rivers state Govnor, Siminalayi Fubara tok say goment dey work to address di hunger issue wey dey di kontri.

    Di govnor ask di protesters for Port Harcourt, to support di goment on Thursday wen dem go di goment state house.

    Govnor Fubara explain say dem no fit address di issues in one day but make di youths give dem time make di policies take positive effect.

    “I understand your feelings, cost of living, cost of food, rent and medical. We understand wetin dey happun but we dey come fom somewia veri bad. And the gomnet dey try to address some of dis tins,” di govnor tok.

    “Wetin we need na to support di goment and support di policy, in di beginning of di policy e fit dey harsh but e go dey fine. Our youth I know say una dey hungry, we go support una. I no dey against any protest, but I no go support violent protests.”

    “I wan to thank una for being peaceful. I already know your problem, and we go communicate am to di federal goment. E no dey easy but we know wit time, e go dey alright. Starting from our own state, everitin go, go well.”

  10. Police allegedly shoot man dead for Kano protest

    Pipo dey run during Kano protests

    Reports say one man don die and anoda one sustain serious Injury for di protests for Kano state.

    A local reporter tell BBC Pidgin say di man die after police allegedly shoot am for di Audu Bako road, close to government house for Kano state, wia di protest bin turn to violence.

    In di morning, di protest for Kano start peaceful but later e become violent.

    Di protesters clash wit security near Kano government house for Audu Bako road, wey make dem fire tear gas.

    Some pipo begin burn tins and loot shops, dey thief goods. Later, police use live bullets, kill one person and leave anoda for critical condition.

  11. 'Protect di rights of pipo' - Amnesty International

    Amnesty International don tell authorities for Nigeria say dey gatz urgently put measures in place to protect di rights of pipo wey dey affected by di current economic policies.

    Di human rights join bodi for social media add say goment need make important need to address widespread hunger, higher unemployment and di standard of living wey dey fall sharpaly.

    screenshot of post for social media

    Wia dis foto come from, SCREEN SHOT/ X

  12. Hoodlums allegedly loot shops for Kano State

    Hoodlums hijack Kano protest tiff NCC property

    Wia dis foto come from, BCC

    Suspected hoodlums don hijack di protest for Kano State, northwest Nigeria, as dem allegedly loot shops for di state.

    BBC observe say di hoodlums begin loot shops and move valuables from dem on a day wen End bad governance protest happun for Nigeria.

    Some of di tins dem pack na mattresses, gallons of oil, indomie, among odas.

    Dis dey come as di protest don turn violent for di state and police authorities dey try calm down di situation.

    Hoodlums hijack Kano protest tiff NCC property
    Hoodlums hijack Kano protest tiff NCC property
  13. Pro-Tinubu supporters march for streets of Yola

    pipo wey carry placard

    Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/ X

    One group wey call demsefs Pro-Tinubu supporters don enta street for Yola Adamawa state capital.

    Di supporters say dem march out to show support to President Tinubu mandate.

    Video wey Tinubu aide Bayo Onanuga share for social media show as plenti pipo including those wey dey live wit disability dey move around wit banners wey carry President Tinubu foto and dey dance to music.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  14. Massive crowd turn up for burial of Hamas leader Ismail Haniyeh wey dem kill for Iran

  15. Just in...Police declare curfew for Borno state

    Police for Borno State, northeast Nigeria don declare 24 hour curfew for di state wit immediate effect.

    Tok-tok pesin for di state police command tok say di curfew na sake of di kasala wey burst on Thursday 1 August and lead to di death of 16 pipo, e leave several odas injured.

    Nahum Daso for statement explain say one improvise explosive ordinance device bin explode for Kawori, e lead to di death of di said pesins.

    “Inline wit our constitutional mandate towards di restoration of law and order, im Excellency di Govnor of Borno State Prof. Babagana Umar Zulum in consultation wit heads of security for di state, reason say e dey important to declare 24hrs curfewfor di state wit immediate effect.” Di statement read.

    E add say make residents dey calm and law abiding.

    Borno state police compulsory curfew

    Wia dis foto come from, Borno Police/X

  16. Police fire tear gas on Abuja protesters

    Protest in Abuja

    Police don fire teargas to scata hundreds of protesters for di capital Abuja.

    Di protesters bin dey chant, “end bad governance” and “hungry dey catch us,” even as security agents dey try keep dem in check.

    As dem attempt to enta Abuja main Eagle Square, police fire plenty gun shots to scare dem off. Di tear gas no stop di demonstrators as dem continue to march go di Eagles Squares.

    Meanwhile, one court ruling on Wednesday night don order say make protesters carry dia protest go di Abuja National stadium wey dey outskirt di capital, say make dem no do am for di proposed Eagle Square wey dey city centre.

    But afta dem gada for di gate of di stadium, di protesters no gree enta di stadium, instead dem march towards di centre of di city, wey be distance of about five kilometres.

    Concerns dey say d protest fit turn violence as dem disobey di court order.

    Some of di demonstrators wey follow BBC tok, say dem dey exercise dia constitutional rights of peaceful assembly and freedom of movement.

    Protest in Abuja
  17. How Nigeria goment policies lead to protest across di kontri

  18. Incase you just dey join us...

    Dis na some of di tins wey don happun as protests kick off for Nigeria on 1 August

    • #Endbadgovernance protesters for Lagos, Kano, Oyo, Rivers, FCT, Jigawa, Sokoto, Zamfara and oda states across di kontri turn up for di nationwide economic hardship protest.
    • #Endbadgovernance protesters and pro-goment protesters jam for Lagos state.
    • Plenty security operatives mount and full ground across di kontri to beef up security for di protest.
    • Di peaceful protest turn violent for Kano state northcentral Nigeria as police open teargas on some protesters and reports dey ground say three pipo dey shot.
    • Police use teargas disperse Abuja protesters wey wan protest for Eagles Square against court ruling wey limit dem to di Abuja National Stadium.
    • For places like Enugu state and Kwara state, di protest no hold.
    • Hoodlums don hijack di protest for Kano state as dem loot and cart away food from shops and equipment from di yet to be commissioned Nigeria Communication Industrial Digital Park.
  19. 'Millions of naira down di drain' - minister condemn action of hoodlums wey set fire to NCC building

    Minister of Communications, innovation and digital economy Bosun Tijani

    Wia dis foto come from, Bosun Tijani/ Instagram

    Nigeria Minister of Communications, innovation and digital economy Bosun Tijani don condemn di way hoodlums set fire for NCC digital innovation park for Kano.

    Di minister for social media tok say im dey “Sad to learn say our Digital Innovation Park for Kano wey we for launch next week to support our technical talent accelerator (3MTT) don dey on fire and protesters don loot am”.

    “Alongside #3MTT, dis building set to host our buildathon holiday maker programme for secondary school pikin dem from next week”.

    Tijani add say na one slight setback for di journey to deepen di kontri workforce for technology and create job opportunities for di youth.

    “Millions of Naira down di drain”, e tok.

    Videos show how di innovation park bin dey on fire as pipo rush in to lay dia hands on di items wey dey inside.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Youths for Ibadan join nationwide #EndBadGovernanceInNigeria protest

    Foto of secuity officials for Ibadan

    EndBadGovernance protest dey happun for Ibadan, Oyo State.

    Di protesters gada for Iwo Road early mor-mor on Thursday and dem don waka from Idi Ape to Mokola Roundabout.

    Di angry youths dey carry placards wit various demands like, “People’s power must prevail”, “Scrap Senate now”, “End Hardship”, “End Hunger and Suffering now”, among odas.

    Aside from di protesters wey gada for Iwo Road, one oda protest dey ongoing for di entrance of di University of Ibadan.

    Organizers of di protest tell tori pipo say di final point wia dem go assemble na di office of di State Govnor Seyi Makinde.

    Officials of di Nigerian Police Force and oda security agencies dey on ground to monitor di protest.

    Foto of protester wey dey address odas for di protest ground