You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Authorities warn against flying foreign flags by Nigerian protesters

Protest today in Nigeria: Planned protest by Nigerians set to continue into day five

Summary

  • Nigerians still dey streets on Day five of di protests across di kontri
  • President Bola Tinubu asks protesters to suspend protests and create room for dialogue
  • Plateau State goment impose 24-hour curfew for Jos/Bukuru metropolis

Live Coverage

Helen Oyibo, Faith Oshoko

  1. Bye-bye!

    Na here we go match break for dis live update.

    Bye-bye, see you anoda time.

  2. 'Flying foreign flags for Nigeria dey totally unacceptable' - Chief of Defence Staff

    Di Chief of Defence Staff (CDS) General Chris Musa tok say to dey fly foreign flags within Nigeria dey unacceptable.

    General Musa tok say di President don instruct dem not to allow anyone wey go scata di peace of Nigeria.

    Dis tok na afta President Bola Tinubu bin meet wit security chiefs for Nigeria, including wit di Vice President Kashim Shettima on Monday 5 August.

    General Musa tok say di meeting dey necessary to update di President on how di situation for di kontri be since di protest begin.

    E add say some pipo dey hide under di protest to cause wahala for di kontri.

    "Wen di riot start dem say na peaceful riot but we see say e get individuals wey dey willing to take advantage to cause wahala. Criminals don take ova, plenti looting dey take place and stealing.

    “All of us don see wia foreign flags dey fly within di sovereignty of Nigeria, and dat dey totally unacceptable," General Musa tok.

    Di CDS tok say dem dey send ‘warning in clear terms’ say dem no go accept make “any individual fly any foreign flag for Nigeria, dat na treasonable offense".

    Di meeting bin happun for di chambers of Presidential Villa Abuja in connection wit di ongoing development for di kontri especially di nationwide protest, wey dey call for end to wetin dem describe as bad governance and oda economic issues.

  3. President Tinubu hold security meeting wit VP, odas

    President Bola Tinubu currently dey hold one security meeting wit di Vice President Kashim Shettima, all service chiefs, di inspector general of police, comptroller generals of di Custom Service and Immigration, and di Chief of staff to di president.

    Di meeting dey happun for di chambers of Presidential Villa Abuja.

    Di meeting fit get connect wit di ongoing development for di kontri especially di nationwide protest, wey dey call for end to wetin dem describe as bad governance and oda economic issues.

  4. DSS gbab tailors wey dey make Russian flags for Kano state, deny say Michael Lenin dey dia custody

    Di Department of State Services (DSS) don gbab some tailors wey dey make Russian flags for Kano State.

    DSS announce today say dem don also arrest some of di sponsors wey dey behind di making of di Russian flags for di area during protest.

    Tok-tok pesin for di DSS Peter Afunanya write for in X page for Monday evening say investigation dey go on ontop di mata of di Russian flags for protest in Kano state.

    E also tok say Adaramoye Michael aka Michael Lenin wey be one of di organisers of di EndBadGovernanceinNigeria protest, no dey dia custody.

    Dis dey come afta local media report say DSS gbab Lenin for Abuja.

  5. Lagos pipo return to dia businesses despite ongoing protest

    Some business pipo for Lagos wey lock dia shops bifor don return to knotinue wit dia daily businesses, despite di nationwide protest.

    For 1 August, different business pipo bin put dia shops under lock sake of di EndBadGovernanceinNigeria protest wey start across di nation.

    Many of di shops and markets dey locked as pipo bin dey fear wetin go be di outcome of di protest.

    For Monday 5 August, we monitor how plenti shops wey bin dey closed bifor don open back and road wey dry don dey witness traffic.

    From Berger to Ketu and Mile 12, di markets bin dey closed bifor as sellers and buyers no come to buy anytin but for dis Monday, e don dey busy again.

    Markets and shops for Ikorodu, Owode, Ketu, Magodo and oda areas for Lagos State don resume business.

    Meanwhile, day five of di protest still dey go on and protesters say President Bola Tinubu gatz meet dia demands and attend to dem.

    BBC News Pidgin monitor say evri junction get police wey dey keep di place safe. Many of dem fully armed and still wearing di 'red alert' band.

    For Akure, di Ondo State capital, we gada say di protest march bin start from around Nepa office go di govnor office.

    Some businesses too don begin open for Ondo State.

  6. Why some protesters for Nigeria dey wave Russia flags?

    BBC don observe as some of di pipo wey dey take part for di ongoing hunger protest for Nigeria dey wave Russian flags.

    Dis happun for mostly di north-western States of Zamfara, Kaduna and Kano.

    One of di protesters wey follow BBC tok for Zamfara State say dem no feel like dem dey part of Nigeria sake of di way goment abandon dem.

    "We no consider wia we live as part of Nigeria. We no tink say we be Nigerians. Dat na why we carry Russian flags. None of us hia don eva go to Russia and we no know anybody wey get links to Russia. Di only reason we dey fly Russian flags na to draw dia attention to our plight so dat dem fit at least intervene and reconcile us wit di Nigeria goment," di protester wey im name na Saadu Musa Abdullahi tok.

    Abdullahi tok say tins hard for di pipo of Zamfara state sotey some pipo no dey charge for moni again to do work, just plate of food don do dem.

    But how dem tink say Russia fit help dem in any way, Abudlahhi tok say: "We see Russia as a global power. So if di kontris wey bin colonise us like UK and US just dey watch and no do anything, sake of say our leaders dey loyal to dem, why we di ordinary citizens no go turn to anoda country wey we believe say dem fit come to our aid?"

    E give example wit Nigeria neighbour, Niger Republic and Mali. Both kontris dey under military rule and dem don turn away from dia bifor bifor Western allies to embrace Russia.

    According to Abdullahi, pipo for di two kontris "dey enjoy more dan Nigerians".

    "For our state Zamfara, almost all rural community hia dey under di control of terrorist. I swear to God you no fit drive for twenty minutes safely dia. Di situation dey beyond di control our security agents," Abdullahi tok.

    However, Abubakar notion of enjoyment for di citizens of Niger fit no be di reality bicos according to di Africa Centre for Strategic Studies, di military takeover for Niger wey happen just ova one year ago don lead to "deterioration in security, economic well-being for Niger’s citizens".

    Meanwhile di Nigerian police don also begin arrest some of di pipo wey BBC see inside di video wey fly di Russian flag.

    Russia don dey increase relations wit kontris for West and Central Africa.

    Di Wagner group, wey bi mercenary fighters from Russia, dey very popular for di Central African Republic, and dem follow for di personal security to di kontri President Faustin Archange Touadera.

    Also, di military junta for Mali, Burkina Faso and Niger don strengthen ties wit Moscow afta dem take ova power and cut ties wit dia former colonial oga, France.

  7. Atedo Peterside beg Nigerians to end di Protests

    Ogbonge businessman, Atedo Peterside don beg Nigerians to end dia I no gree waka ova di harsh living conditions for di kontri.

    Oga Peterside wey be di owner of Anap Foundation tok dis one for im official X account.

    Di businessman praise di protesters wey enta street since August 1 for dia ginger to demand for good governance.

    ‘’I beg una in di name of God to end di protest today. Poor Nigerians no go fit endure protest for more dan a few days’’. Oga Atedo tok

    ‘’Una turnout don make many pipo fear. Federal goment no deaf. Oga Atedo add put.

    Atedo tok dey come afta President Bola Tinubu address di nation on top dis mata.

  8. We go hold goment accountable for negative outcome of dis protests - CSOs

    A join bodi of plenty Civil Society Organisations for Nigeria don tok say dem go hold di Nigeria goment responsible and accountable for di negative outcome wey follow di nationwide protest wey dey happun for Nigeria.

    Dem issue one statement on Monday wey about 55 CSOs join sign, to tok say "di blame dey with di federal, state, and local goments, as dem don fail to provide security and welfare to di pipo".

    BBC Pidgin bin don report how police use teargas to try to scatter protesters for Abuja, Lagos, Kano and oda parts of di kontri.

    Some local tori pipo also report say di police bin use live bullets for some places, and even President Bola Tinubu for im broadcast on Sunday, bin gree say some protesters die for Kano, Kaduna, Borno, and oda places.

    "We dey tok am again say peaceful protest na legitimate form of expression wey dey inside international human rights instruments, including di Universal Declaration of Human Rights (UDHR), di International Covenant on Civil and Political Rights, di African Charter on Human and Peoples' Rights, and Nigeria’s 1999 Constitution (as amended)," di statement tok.

    "Protest dey allow citizens to publicly tok dia concerns, express displeasure wit goment policies, challenge injustices, and participate actively for di democratic process. E dey undemocratic to unduly restrict di right of citizens to protest."

    Di CSO's list 10 tins wey dem allege say goment don do to increase di vex of di protesters instead of to calm dem down.

    For instance, dem tok say di president speech dey "woefully underwhelming" and e no address di demands of di protesters; di Vice president call di protesters "bandits and idiots"; di Secretary to di Goment of di federation say di protesters dey "useless"; di Senate President tok say protests fit dey go on, as long as dem (politicians) continue to dey chop; and di Minister of State for Police Affairs bin join anti-protest protesters.

    According to di statement, since di protesters bin don give goment notice say dem go dey on di streets reach 10 days, goment suppose provide dem wit enof security instead of to dey try to break dem up.

    Also, goment must to respond to di demands of di protesters, as well as release all di journalists, activists and protesters wey dem don arrest and detain unjustly.

  9. Breaking, Kaduna put 24-hour curfew afta kasala burst for protest ground

    Kaduna State Security Counil under Govnor Uba Sani don impose 24-hour curfew for di Kaduna and Zara Metropolises.

    According to statement wey di goment put out, "sufficient evidence dey to show say criminals don hijack di protest to turn and dey loot shops and destruction of public and private property".

    Riot between di police and protesters don happun in Kaduna.

  10. Locked shops and empty roads for Jos,

    Sake of di curfew wey dey in place for Jos, north central Nigeria, shops dey locked and roads dey empty.

    BBC Pidgin visit di Yakubu Gowon way and Federal Low cost Housing area inside di capital of Plateau State for north-central Nigeria.

  11. Why di 'hunger protests' turn violent for northern Nigeria?

  12. Wia protests don hold for Nigeria?

    Much of di demonstrations wey dey go on across Nigeria dey happun for di northern, south-south and south-west area of di kontri.

    Interestingly, no state for di south-east don witness protests.

  13. Investigate killing of protesters and pay dia family compensation - Femi Falana

    Human rights activist and constitutional lawyer, Femi Falana, don demand from di federal goment make dem investigate di killing of protesters for across Nigeria and pay dia families compensation.

    Falana, wey be Senior Advocate of Nigeria, also ask goment to immediately release di pipo wey dem arrest during the protest.

    E criticise di nationwide broadcast wey Presido Bola Tinubu bin do on Sunday morning, as e tok say e no address di demands of di protesters, especially di matter of fuel subsidy.

    "If di goment go take di fight against corruption to di oil dealers, and crude oil go dey processed for goment-owned refineries, we no go get any basis for fuel subsidy," Falana tok.

    "A positive response to di key demands of di youths to review di protest fit make dem review dia actions. Insensitivity to dia demands can only provoke continued action."

    Going forward, di senior lawyer make di following demand from di Nigeria goment and security agencies:

    • Make di Federal and State goments set up commissions of inquiry to investigate di killings and prosecute "di reckless murderers in Police uniform".
    • Di family members of di pipo wey die suppose dey adequately compensated by di federal goment.
    • Make dem identify di victims of police killings and celebrate dem as heroes and heroines
    • Participation for peaceful protests no go eva be criminalise offence for Nigeria.
  14. Fela songs fill di air as protesters gada for Lagos

    Nigerians don start to dey gada again for di MKO Abiola gardens area in Ojota for di commercial hub of Lagos State.

    Dis one dey come even afta President Bola Ahmed speech yesterday wia e call for di suspension of di protests.

    Freedom songs from di likes of Fela fill di air as protesters tok say dem need change and not promises.

    Nigerians like Oby Ezekwesili and opposition party candidate for 2023 Nigeria election, Atiku Abubakar don comot to hala say di speech wey Tinubu make no be am at all, at all.

  15. Protesters for Port Harcourt say dem go continue until day 10,

    A handful of protesters come out to protest against bad governance for Port Harcourt, di Rivers State capital as di protests enter day five.

    Di number of pipo wey come out to protest no plenti like e bin be for day one and two, and di protesters bin dey around di UTC Junction area of old Port Harcourt township, few meters to di Rivers State Goment House.

    Many businesses and markets don resume business even though some of dem like banks and some offices no open sake of di protests.

    Di State secretariat complex dey open as some civil servants come work but e no dey as e suppose day on a normal working day.

    Di protests also bin hold on Saturday and Sunday with very few pipo coming out to participate for Port Harcourt and some of dem say dem go continue to protest till day 10.

  16. ‘Wear media cloth’ - FCT Police tell Journalists,

    Di Commissioner of Police FCT Command, Benneth Igweh don ask Tori pipo wey dey cover di ongoing National protests for Nigeria capital to wear dia media outfit so dem go fit identify dem.

    E also tok say make dem carry valid means of identification.

    For inside statement on Sunday, FCT Police tok-tok pesin Josephine Adeh, also deny allegations say police dey shoot journalists.

    “Di police no go eva shoot at journalists. For which reason? Di ones wey dey cover us know how much we value our relationship with dem.

    Di Commissioner of Police, FCT specifically order make dem protect journalists for di ongoing protest.

    E no dey possible say we go single dem out and start to attack dem.” Di statement conclude.

  17. Normalcy don dey return to Abuja small small,

    Some workers for Abuja resume work on Monday afta di capital city bin shutdown sake of di End bad governance and hunger protests last week.

    BBC Pidgin see some workers and business pipo stand for road dey wait for vehicles to go work and dia business places.

    Vehicles to carry passengers dey scarce sake of fuel scarcity and some private car owners leave dia vehicles for house sake of fear make jaguda pipo no destroy am as dem bin do bifor.

    BBC Pidgin also see as few pipo dey enta dia office buildings on Monday morning. Some business places don begin open small small too.

    Major roads also dey busy small but security vehicles tanda for strategic positions.

  18. Plateau state impose 24 hours curfew

    Plateau State Governor, Barr. Caleb Manasseh Mutfwang don sama 24 hour curfew for Jos/Buruku Metropolis.

    Di curfew start from 12 midnight on Sunday, August 4, 2024.

    E say dis move dey come afta some criminals use di national protest as opportunity to break into shops and restaurants and tiff food items and oda valuables.

    E also call on police and oda security operatives to chook eye put so dat tins no go turn violent again.

  19. Police use of live bullets to scatter protesters take us back to colonial era - Wole Soyinka

    Wole Soyinka, di first African to win a Nobel Prize for literature, don hala about how Nigeria law enforcement agencies dey use live bullet to try to scatter pipo wey dey do protests, as e tok say na reminder of "di pre-Independence – dat is, colonial – acts of disdain".

    Tori pipo Channels say Soyinka also criticise President Bola Tinubu as im no address dis issue of “lethal responses against civil society” for im nationwide broadcast on Sunday.

    Tinubu, for im speech bin send condolences to di families and relations of di pipo wey die during di protests and tok say “we must stop further bloodshed, violence and destruction”.

    But Soyinka tok say im primary concern na di “continuing deterioration of di state seizure of protest management” and Tinubu speech “bin fall conspicuously short” to address dat

    “Di tragic response to di ongoing hunger marches for parts of di nation…constitute a retrogression wey don take di nation even further back dan di watershed ENDSARS protests,” Soyinka write.

    “Di serving of bullets wia dem dey beg for bread na serious retrogression, and we know wetin e eventually prove – a step to more kasala, not excluding revolutions.”

    Soyinka tok say time don reach for Nigeria security pipo “to abandon, permanently, di old way to dey use lethal means”.

    So far, di exact number of pipo wey don die for di ongoing hunger protest neva too dey clear but Amnesty International tok say di number dey 13 now.

    According to President Tinubu, pipo die for Borno, Jigawa, Kaduna, Kano, and oda states.

  20. Tinubu ask protesters to suspend di protests and look towards dialogue

    Nigeria President Bola Ahmed Tinubu on Sunday do a nation wide broadcast wey chook mouth ontop di mata of di protests wey dey happun across di kontri..

    For im speech, di president tok wetin im administration don dey do, to quench hunger and transport wahala bicos of di price of fuel now.

    E also say make pipo stop to dey protest sake of di kasala wey dey burst and call for dialogue to make di kontri beta.

    Howeva, some protesters don say e no touch on di main issues wey protesters dey demonstrate against.

    Check out di key points of Tinubu speech here:

    • 'Suspend further protests and create room for dialogue' - Tinubu tell protesters