Una bye-bye
Na hia we go match break for our coverage of di govnorhip election for Osun State, southwest Nigeria.
Below na summary of di election wey see di return of Ademola Adeleke as govnor of Osun State. E beat 14 oda candidates including Bola Oyebamiji of APC, wey be im main challenger.
- President Bola Tinubu, Atiku Abubakar, Bukola Saraki, odas congratulate Adeleke
- Afrobeats singer Davido react to di election victory of im uncle
- Breakdown of Osun State govnorship election results by local govments afta Adeleke re-election
- Osun State get 30 LGAs wit over 3000 polling units
Me and oda tori pipo Tunde Ososanya, Adesola Ikulajulo, Annette Arotiba, Tamara Ebiwei, Mobolaji Olatunde, Adebola Ajayi and Chukwunaeme Obiejesi dey tell una bye-bye.
We go meet again for our next election coverage wey be di 2027 general elections.


















