You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Evritin wey happun as Nigerians enta street to protest on her 64th Independence Day

Reactions from across Nigeria as pipo enter street to protest on October 1st Nigeria Independence Day anniversary.

Summary

Live Coverage

Helen Oyibo, Annette Arotiba, Victor Ezeama

  1. Una bye bye

    Na hia we end our coverage of Nigeria 64th independence coverage.

    We thank you as you tanda wit us since morning.

    Kontinu to enjoy BBC News Pidgin

  2. Police no attack protesters for Abuja

    Abuja police command say police officers no attack protesters for Utako Market in Abuja earlier today.

    Police tok-tok pesin for Abuja, Josephine Adeh tok say na fake news and e dey misleading becos wetin police do na to stop jaguda pipo wey wan use di protest to begin steal from pipo shops and na so dem intervene.

    She took say make pipo stop to dey circulate di misleading information as dem dey committed into ensuring di safety of di pipo wey dey perform dia civil rights.

    "Di command wish to categorically deny di narrative, say e dey completely false and misleading. Acting on intelligence, di operatives only take measures to stop some miscreants wey wan take advantage of di protest to loot shops in di market and as result, we extend focus to dem." she took.

  3. GEJ call for good democratic culture and unity

    Former President Goodluck Jonathan don call for unity and transparency in Nigeria democracy to mark di 64th anniversary of Nigeria Independence.

    Inside one statement ontop im X Oga Jonathan congratulate di nation for sustaining democracy for di past 25 years and overcoming so many challenges.

    Di former president tok say Nigeria still dey face challenges wey dey test di pipo strength and dis challenges include di kontri inability to meet our goals “security, economic growth, national cohesion and infrastructure development”

    E explain say Nigeria must strengthen dia institution and develop democratic culture wey go support, peace, transparency, free, and fair elections becos dis na di foundation of good governance, sustainable democracy, national unity, and peaceful coexistence.

    “As nation, we must recommit to di principles of justice, equity, and inclusion. Make we embrace our diversity, tap into di potential of our youth, and leverage our natural resources for di benefit of all,”Oga Jonathan tok.

  4. ‘October 1 protest na to carry Nigeria go promise land’ - Sowore

    Activist and former presidential candidate of di African Action Congress for di 2023 election, Omoyele Sowore join di protest wey happun for Lagos today.

    Sowore follow for di pipo wey ginger pipo to come out come protest.

    E tell tori pipo say di protest dey important to carry Nigeria go di “promised land”.

    Oga Sowore say, for pipo to turn-up for di we-no-go-gree waka mean say pipo don reject dis goment Independence Day celebration

    E remember say Nigerians don too dey patient, say dem give former president Muhammadu Buhari plenty time but e no fit use am do anytin.

  5. Main reason why Lawmakers wan impeach di Deputy president of Kenya

  6. Pro-goment group come out to celebrate Independence Day for Abuja

    Some youth groups led by di National Association of Nigerians Students (NANS) gada for di Unity Fountain for Abuja to celebrate Nigeria 64th independence.

    Di location of di Unity Fountain no dey far from Eagle Square wey be di venue wia protesters bin don agree to gada for dia protest, but police no gree dem.

    Di youth groups carry drum and trumpets and dancing as dem dey jolly. Many of dem carry placards wit words of support for di President Bola Tinubu administration.

    One of di leaders of di group wey speak to tori pipo tok say Nigeria get plenty to celebrate at 64, even though things neva dey perfect.

    BBC Pidgin also notice say vehicle carrying some of di pro-goment support groups dey run around di Abuja city centre wit loud speakers playing jolly-jolly songs.

  7. No protest across northern Nigeria

    Many states across northern Nigeria dey quiet and no protest don dey observed.

    BBC tori pesin for Kano notice say pipo dey go about dia business and no pipo gada to protest.

    Di situation na di same for Plateau, Sokoto, Benue and Kaduna states wia our checks show say no protest happen.

    For Maiduguri, di capital of Borno State, area also dey calm. Di city still dey recover gradually from di flood disaster wey bin affect more dan half of di metropolis.

  8. Oyo state govnor extend transportation subsidy

    Oyo state Govnor Seyi Makinde say di small scale loans wey goment bin dey give no longer go dey limited to only civil servants for di state.

    Di govnor announce dis development for one broadcast address to celebrate Nigeria 64th Independence Day anniversary.

    E say community development association, farmers association and artisans go now benefit from di loan.

    Di govnor also say im don extend di subsidy on transportation for anoda six months.

    Di subsidy go now include subsidy on trucks for produce evacuation, e add.

    E also add say dis no be di time to focus on wetin divide Nigerians but make dem hold on to wetin unite dem through dia shared identity, culture and history.

  9. ‘Anti-protesters attack us for Rumuokwuta'

    One of di organisers of di End Bad Governance protest for Port Harcourt, Rivers state Deemua Dumkar, allege say some anti-protesters and some security personnel attack some leaders of di movement for Rumuokwuta axis of Obio Akpor LGA early morning of Tuesday 1 October, 2024.

    Dumkar, wey also be di State Chairman of di Civil Rights Council, tell BBC Pidgin say im and di leader of di Take It Back Movement, Adeyemi Ademola, bin dey among those wey bin dey attacked.

    E dismiss rumors say some protesters, including Ademola, bin dey arrested during di incident but add say dem go continue with di protests until dia demands dey met.

    “Beating protesters no stop di fact say hunger dey di land. E no stop di fact say hike in di price of food dey worry pipo. Beating protesters no stop di fact say we no fit buy fuel anymore. Beating protesters no stop di fact say di president no address wen fuel production for di refinery go begin so dat di price of fuel go come down.” E tok.

    Dumkar also criticise President Bola Tinubu say e fail to address key issues such as di operational status of di refinery, instead e focus on awarding presidential honours to Senate President Godswill Akpabio and odas, sometin wey no concern di general welfare of Nigerians.

    “We bin expect Mr President to tell us wen di refinery go start to work but e no do so. So we go continue to speak as civil rights organization. We go continue to tok, we no go close mouth,” e tok.

  10. Ondo state Govnor Lucky Aiyedatiwa grant State pardon to 117 convicts

    Ondo state Govnor Lucky Aiyedatiwa don grant state pardon to one hundred and seventeen convicts for di state.

    Di move na based on advise of di Council on Prerogative of Mercy wey di state Attorney General, Dr Olukayode Ajulo dey head.

    For statement by im tok-tok pesin, di govnor say di "nineteen convicts go dey released, while odas go get dia death sentences commuted to life imprisonment or receive reduced sentences."

    Dem say di gesture go provide renewed hope and opportunities for di convicts to fit go back into di society.

    Di release order go take effect today, 1 October, 2024, Nigeria Independence Day.

  11. More fotos from across Lagos

    More fotos of how di protest and Independence Day waka around Lagos.

  12. US, UK wish Nigeria Happy 64th Independence Day

    Di United States of America don send dia congratulations to Nigerians on dia 64th Independence Day anniversary.

    Di Secretary of State, Anthony Blinken for inside statement say Nigeria na example of “dynamism and resilience for Africa” and di kontri na key contributor to regional peace and stability."

    “We dey committed to deepening our cooperation for areas wey include advancing inclusive economic development, energy access, democracy and human rights, and environmental sustainability,” e add.

    Also, di United Kingdom for statement also don congratulate di nation.

    UK goment for one post on X say UK and Nigeria share special bond along wit di Commonwealth and dem wish all Nigerians plus those wey dey UK Happy Independence Day.

    Di two kontris add say dia embassy for Nigeria go dey closed to observe di anniversary.

  13. Abuja roads dey empty as police tanda for ground

    Major roads and streets dey empty for di Federal Capital Territory, Abuja as many pipo dey observe di public holiday.

    Organisers of di 'Fearless in October' protest bin tell BBC Pidgin say dem go gada for di Eagle Square to start dia protest waka, but dat one no happen.

    BBC Pidgin tori pesin observe say police and oda security pipo don block all di roads wey lead to di Three Arm Zone wia di Eagle Square dey located.

    Dem dey turn drivers back and direct dem to follow oda routes, so even tori pipo no fit gain access to dat area.

    Also, plenty police pipo dey for major streets and districts for di city centre, like Wuse, Garki, Utako, Jabi, etc.

    One 14-minute video bin spread on social media platform, X, wey show some protesters as dem gada dey chant "what are we saying, we are hungry".

    Tori be say di area wia dem gada na di Utako district of Abuja, but wen our tori pesin reach dia e no see anybody.

    Pipo around dia tok say police pursue di pipo comot. Anoda video by tori pipo News Central show as police shoot teargas to pursue di few protesters wey bin gada.

    However, wen our tori pesin reach dia, e see plenty police pipo wey gada for di area.

    Also, a security task team wey include men of di Nigeria Security and Civil Defense Corps (NSCDC), di police and army, dey patrol for major roads across Abuja.

    See some photos of how Abuja dey on dis Independence Day:

  14. Agriculture minister Aliyu Sabi ask Nigerians to stand united

    Nigeria Minister of state Agriculture Aliyu Sabi Abdullahi don ask Nigerians to continue to stand united for efforts to transform di kontri.

    Oga Aliyu for im 64th Independence anniversary message tok say “we reflect on our journey as a nation. Despite di challenges we face, we remain resilient and committed to creating a better future. Under the leadership of Mr. President Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, we dey renew hope and drive positive change”.

    Di Agric minister add say, "togeda wit our shared determination and hard work, we go overcome obstacles and build one brighter tomorrow for all."

  15. Why some Nigerians dey protest on October 1st?

    As Nigeria bin dey gear up to celebrate im 64th independence anniversary on Tuesday 1 October, some human rights groups also bin dey plan to hold protest across di kontri.

    Di aim of di protest wey di organisers say go dey peaceful na to end bad governance and di hardship wey Nigerians dey face.

    Nigeria dey experience im worst economic crisis ever, wey dey show for di rise in food prices and petrol hike too.

    One recent survey wey di kontri Central Bank of Nigeria, CBN, conduct from July 22 to 26, 2024 show say di rising inflation rate go force Nigerian households to spend di largest amounts of dia earnings on food for di next six months.

    Dis na as di most recent report by di National Bureau of Statistics (NBS) put di inflation rate at 33.40 per cent, and food inflation at over 40 per cent.

    Di reason why we dey go back na to enforce di 15 demands and make sure say we protect di dignity of di pipo of dis kontri". Sowore tok.

    “I sabi say di protest for August bin get 15 demands, non of dem dey met. And afta di protest bin end, di goment arrest, detain and charge some protesters for treason, some still dey detention across di kontri.

    We also sabi say for di economic side of tins, di price of goods and services don go up again sake of say goment decide to increase di price of petrol.

    We dey effectively suspend dia own independence day in favour of our new request for Independence”. Sowore tok.

  16. More from Rivers state wia security and anti protesters dey ground for Port Harcourt,

    Anti-protesters with cane gada for strategic points for Port Harcourt to stop any form of protest.

    See more pictures from Port Harcourt.

  17. Security operatives full ground for Lagos as protesters gada on Independence Day

    Heavy security operatives wey include di police, military, civil defence and Lagos State Transport Management Agency (LASTMA) dey for Lagos state, Nigeria commercial centre as di #FearlessInOctober protesters gada for Ikeja area.

    Earlier, di Lagos state commissioner of police Olarenwaju Ishola bin meet wit di Lagos state protesters and e assure dem say police don perfect arrangements wit sister security agencies to provide dem wit maximum protection during dia protest.

    E say im don order di deployment of correct human and operational resources go strategic locations for di state.

    Oga Ishola bin advise di deployed officers to dey professional, civil but firm.

    See some pictures of security operatives from di protest ground.

  18. Anti-protesters stop protest for Port Harcourt,

    Di end bad governance protests never hold for Port Harcourt di Rivers State capital becos some anti-protesters don first go occupy di usual protest gathering points to prevent any kain of gathering for di protest.

    Dis dey happun as di state dey prepare for local goment election on Saturday 5 October, 2024.

    In spite of dis, police and oda security agents dey ground while some of dem dey patrol round di city to monitor di situation.

    Di anti-protesters gada for di Port Harcourt Pleasure Park and opposite di Federal Secretariat complex along di Port Harcourt- Aba expressway.

  19. Protesters gada for Lagos state to demand for reversal of fuel and electricity tariff

    Protesters gada on Tuesday morning for Ikeja Underbridge for Lagos state Nigeria, as di kontri dey celebrate im 64th Independence Day anniversary.

    Di October 1, 2024 protest, wey dem tag “FearlessInOctober” dey come two months afta di August #EndBadGovernance protests.

    Di two protests dey similar as young pipo dey demand for reversal of petrol subsidy removal and electricity tariff increase.

    Di protesters carry placards wey dem write things like, "reverse fuel and electricity tariff now, drop di false charges against end bad governance protesters, No to IMF/World Bank policies," among odas.

    Former presidential candidate of di African Action Congress and activist Omoyele Sowore also join for di Lagos protest ground.

  20. Former Nigeria President Goodluck Jonathan independence day message

    Former Nigeria President Goodluck Jonathan don ask di goment to strengthen institutions and develop good democratic culture wey go support peaceful, transparent, free and fair elections.

    E say dat na di basis for good governance, sustainable democracy, national unity plus peaceful coexistence.

    Di former presido wey give dis informate as Nigeria dey celebrate im 64th Independence anniversary, say di kontri don come a long way and although e don record modest progress, yet some challenges still dey.

    “Ova time, we don indeed make modest progress for our hopes and shared dreams as citizens or our nations. We don get sustained democracy for dis 4th Republic for 25 years, afta di end of military rule for 1999.

    We don record noticeable growth for our economy and our gross domestic products (GDP). We don continue to sustain our unity and belief for di social fabric of our nation.”

    Oga Jonathan add say Nigeria still dey face ogbonge challenges for areas wey include security, economic growth, national cohesion and general infrastructure development.

    E say kontri pipo must recommit to di principles of justice, equity and inclusion.

    “We must harness our diversity, tap into our youth potential, and leverage our natural resources for di benefit of all,” Jonathan tok.

    Oga Jonathan encourage Nigerians to remain optimistic, resilient and committed to di kontri greatness, despite odds.