You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Nigeria qualify for Africa 2026 World Cup playoffs

Di Super Eagles win wit three goals from Victor Osimhen.

Summary

  • Nigeria host Benin for Godswill Akpabio International stadium
  • South Africa go jam Rwanda for di Mbombela Stadium
  • Nigeria need win by two goals, South Africa need win and hope Benin draw
  • Benin just need a point to qualify

Live Coverage

Victor Ezeama and Adesola Ikulajulo

  1. Una bye-bye

    Na for hia we go march break for our coverage of di 2026 World Cup Qualifiers.

    We go meet una again at di end of dis year for di African Cup of Nations wey dey happun for Morocco.

  2. Nigeria knack Benin 4-0 to secure 2026 World Cup playoff position

    Di Super Eagles of Nigeria don beat di Cheetahs of Benin Republic to put one leg for dia World Cup qualification.

    Di Eaglesshow superiority wit ogbonge 4-0 win to humble dia visitors for Uyo, Akwa Ibom state.

    Na Galatasaray forward Victor Osimhen score three goals to secure dat spot for Nigeria. Frank Onyeka score di last goal.

    South Africa top di group wit 18 points, while Nigeria follow for second place wit 17 points.

    With 17 points, Nigeria stand chance of qualifying as one of di best runners-up.

  3. FULL-TIME, South Africa through to Fifa World Cup

    South Africa 3 - 0 Rwanda

    And South Africa don qualify for di 2026 FIFA World Cup, afta dem beat Rwanda 3-0

  4. GOAL, Nigeria 4-0 Benin

    90’ Moses Simon pass di ball give Onyema wey fire long shot inside di net.

  5. , Nigeria 3-0 Benin

    90’ Benin Head Coach, Gernot Rohr wey be former Super Eagles Coach no happy at all.

  6. , Nigeria 3-0 Benin

    89’ Goal attempt for Nigeria but Calvin Bassy play di ball go side net.

  7. YELLOW CARD, Nigeria 3-0 Benin

    87’ Benin dey play short short passes but don just collect anoda yellow card now.

  8. , Nigeria 2-0 Benin

    85’ Benin make goal attempt for Nigeria area but Nigeria defence no allow dem pass.

  9. , Nigeria 3-0 Benin

    83’ Nigeria try to score anoda goal wit very long passes but e land for Benin goalkeeper hand.

  10. SUBSTITUTION, Nigeria 3-0 Benin

    81’ Victor Osimhen don comot as Orugundare enta

  11. , Nigeria 3-0 Benin

    80’ Benin dey use dia last strength to try hustle sometime from dis match wit dia long long passes.

  12. , Nigeria 3-0 Benin

    78’ Opportunity for di Super Eagles wit Victor Osimhen again but e miss di target.

  13. YELLOW CARD, Nigeria 3-0 Benin

    77’ Benin collect dia second yellow card for di match.

  14. , Nigeria 3-0 Benin

    76’Alex Iwobi of Nigeria bin try to score as e play do ball for Benin goal area but e land for goalkeeper hand.

  15. , Nigeria 3-0 Benin

    75’ Nigeria dey play long passes now sake of say dem don Dey relaxed.

  16. GOAL, South Africa 3 - 0 Rwanda

    Makgopa score di third goal for South Africa for di 71st minute!!

    Bafana Bafana 3-0 Rwanda wit 17 minutes to go

  17. SUBSTITUTION, Nigeria 3-0 Benin

    74’ Onyekachi don enta as Zaidu Sanusi comot.

  18. , Nigeria 3-0 Benin

    73’ Nigeria player Zaidu Sanusi don comot from field sake of injury. Dem carry am for stretcher comot.

  19. Rwanda neva equalise against South Africa, South Africa 3 - 0 Rwanda

    Di large crowd for Mbombela dey give South Africa some veri brilliant atmosphere, and rwanda neva equalise.

    Bafana Bafana still dey lead wit two goals afta dia goals come from di first half.

    Mudau come wit one opportunity to score third goal for South Africa, but di shot go wide!

    If Rwanda lose dis game, e go mean say Benin and Nigeria go dey disappointed.

    E go give South Africa straight hope to qualify for di 2026 World Cup.

  20. , Nigeria 3-0 Benin

    70’ Freekick for Benin dem

    Play am but na small tin di ball use pass top of di net.