Court of Appeal grant Tinubu application to access election materials
Govnorship election go hold for 28 of di 36 states in Nigeria on Saturday 11 March , 2023.
Live Coverage
Jelilat Olawale and Helen Oyibo
Una goodnight!
Na here we go march break today.
Join us again tomorrow for our coverage of di build up to di govnorship election.
Bye-bye!
Jandor: Di opposition candidate wey want Lagos to breathe fresh air
IGP direct CPs and strategic commanders to protect electoral process

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force
Wetin we call dis foto, IGP Usman Alkali-Baba direct police ogas dem to protect electoral process Di Inspector General of Police Usman Alkali-Baba don direct all di police ogas dem wey go work for di Gubernatorial and State Houses of Assembly election duties say make dem mobilize all resources wey dey dia disposal to defend electorates, Inec officials plus sensitive materials during di 11 March elections.
Di police boss also order make maximum protection dey against intimidation, harassment and assault on law-abiding citizens as dem go di polls on Saturday.
E also charge all election commanders for various states to take up complaints of intimidation, harassment and assaults wey individuals or groups report for proper investigation.
Court give INEC go ahead to reconfigure BVAS dem use for presidential election
Police arraign lawmaker Chinyere Igwe for money laundering

Wia dis foto come from, Chinyere Igwe
Wetin we call dis foto, Federal lawmaker Chinyere Igwe dey face money laundering charge before Fedeal High Court Police for Rivers State don arraign federal lawmaker, Chinyere Igwe, before a federal high court for Port Harcourt on one count charge of money laundering.
Chinyere Igwe dey represent Port Harcourt federal constituency 2 for di House of Representatives.
Police say dem arrest am with $498,100 dollars with a list for di distribution of di money during a stop and search operation at about 2am on 24 February 2023 before di Presidential and National Assembly elections.
For im trial for di Federal High Court, im plead not guilty to di money laundering charge against am.
Di Court adjourn to 14 March, 2023 for bail application.
Breaking, Court of Appeal grant Tinubu application to access election materials
Di Court of Appeal for Abuja don grant an exparte application by di Presidential candidate of the All Progressives Congress, APC Bola Tinubu to give dem access to election materials wey dem use for di 25 February Presidential elections.
For di ruling of di three-member panel wey Justice Joseph Ikwegh lead, di Appeal Court grant di APC presidential candidate access to di electoral materials and to make photocopies of dem.
APC presidential candidate Tinubu bin request to get access to di electoral materials, so dat e go help di legal team to prepare for dia defence during hearing of di suit wey Atiku Abubakar of di PDP and Labour Party file, sake of say dem no like di way dem do di presidential election.
Atiku and Obi bin don file suit make court grant dia request to get access to di sensitive electoral materials and di Bimodal Voter Accreditation System BVAS to prove say di Presidential election get mago-mago.
Di govnor wey dey hope to consolidate im work to wake up a greater Lagos
Atiku inaugurate legal team wey go helep am fight for court

Wia dis foto come from, Paul IB
Wetin we call dis foto, Atiku ask di lawyers to reclaim mandate of Nigerians for court Di Peoples Democratic Party, PDP presidential candidate Atiku Abubakar on Wednesday inaugurate a team of lawyers wey go challenge last month presidential election for court.
According to di former vice president, di job of di team of lawyers na to reclaim mandate of di Nigerian pipo as di elections no be di will of Nigerians.
Di lawyers headed by Chief J.K Gadzama (SAN) include Chief Chris Uche (SAN), Mr. Paul Usoro (SAN), Tayo Jegede (SAN), Ken Mozia (SAN), Chief Mike Ozekhome (SAN) and Mahmood Magaji (SAN).
According to di Nigeria Independent Electoral Commission, Inec, Atiku come second behind President-elect Bola Ahmed Tinubu of di ruling APC for di recent polls.
Peter Obi don arrive Court of Appeal

Labour Party Presidential candidate Peter Obi don show face for di Presidential Election Petition Court of Appeal for Abuja.
Di Appeal Court dey expected to give judgement today on di BVAS inspection wey Inec no allow Labour Party do and di configuration of di BVAs machines wey Inec request di court to grant dem sake of di upcoming govnorship election on 11 March, 2023.
Oda matas wey di Appeal Court dey expected to rule on today na di election matas wey concern Labour Party, Peter Obi, Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, All Progressives Congress, Bola Ahmed Tinubu and di Independent National Electoral Commission (INEC) for seven different suits.
INEC begin distribute sensitive materials to 10 LGAS for Rivers,

Wetin we call dis foto, Di sensitive materials dey labelled according to di LGAs wey dem dey intended for. Di Independent National Electoral Commission INEC Rivers State don begin di Inspection and distribution of Sensitive materials for di Governorship & State House of Assembly Elections for di CBN headquarters Port Harcourt.
Ds sensitive materials include ballot papers and results sheets for di Governorship and House of Assembly electuons for all di 23 local goment areas of di State.
Dem dey begin with distribution of materials to 10 local goment areas wey include: Asari-Toru, Akuku-Toru, Ahoada-East, Ahoada-West, Abua/Odual, Bonny, Degema, Port-Harcourt, Obio-Akpor, and Ogba/Egbema/Ndoni.
Dem go continue di distribution with di remaining 13 LGAs will on Thursday March 9, 2023.

Wetin we call dis foto, Di sensitive materials na di ballot papers and results sheets for each of di elections wey go hold on Saturday 
Wetin we call dis foto, INEC normally dey keep sensitive election materials for di strong room for CBN Distribution of material for Kaduna ahead of govnorship election

Wia dis foto come from, INEC
Di Independent National Electoral Commission, Inec don begin deploy men and materials to local goment areas for Kaduna state.
“Di commission deem am as a mata of necessity to prepare early.
“Na against dis back drop we dey start di distribution of di sensitive materials for di CBN to di respective LGAs2, di electoral body tok.

Wia dis foto come from, INEC
No bring pet come polling unit on election day - Police
Di Nigerian Police Force don draw voters ear say make dem no carry dia dogs go polling units as dem fit dey seen as weapons for intimidation.
Dem tok dis one for inside statement wia dem say some pipo bin dey plan to carry dia pets go polling unit and say e dey against di law.
Dis dey come as govnorship elections dey set to happun for most states of di kontri on March 11, 2023.
Some fotos memories from di 25 February polls

Wetin we call dis foto, Reports of late election and Inec officials wey no show make pipo para for Amuwo Odofin Lagos area of di kontri. 
Wetin we call dis foto, Voter dey para for polling unit for Amuwo Odofin 
Wetin we call dis foto, One elderly woman dey put her thumb-printed ballot inside di box for her polling unit in Lagos. 
Wetin we call dis foto, But even with all the tension wey dis kain period dey bring fordi kontri, silver lining day, no traffic, as such major road networks dey turn football fields to take coole bodi for young pipo. 
Wetin we call dis foto, Police dey calm di kasala wey wan start sake of lack of voting 
Wetin we call dis foto, Many pipo come early enuf to carry out dia civic duty. Here some dey check dia names for di voters register Police react to viral video wey show pipo dey plan violence on election day

Wia dis foto come from, Kano state police
Kano Police Command say dem dey aware of one video wey go viral wia some pipo siddon dey discuss how to cause kata kata for di govnorship elections wey go happun on Saturday 11 March 2023.
Inside di video. one unknown man bin dey address some group of young pipo for Hausa language wia e dey tell dem to rise up and make sure dia party win di elections by all means.
Tok-tok pesin for Kano Police Command SP Abdullahi Haruna Kiyawa respond to di video afta one journalist post am for im whatsapp group with journalists.
E tok say dem don take note and efforts dey underway to do di needful on di mata.
Across di state, some pipo wey see di video tok say e don dey make dem tink about dia safety regarding Saturday.
Police say dem dey ready to combat any pesin wey plan to cause palava for di elections and dem go arrest dem and dia sponsors before charging dem to court to face wetin dem do.
INEC release senators-elect list afta general elections
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don release di list of senatorial-elect for di Nigeria election wey hold on Saturday 25, 2023.
Out of di 109 seat, 8 still dey vacant sake of death of one of di candidate and supplementary election wey go hold for seven constituencies.
APC win majority of di Senate wit 54 seat while di PDP gbab 33 seats, LP gbab 7 seats,
INEC Chairman, Mahmood Yakubu, for im remark during one meeting wit Resident Electoral Commissioner (RECs) for Abuja na say eight political parties produce lawmakers for di election.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
You want read about di 25 February presidential election?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria 2023 presidential elections don come and go but mata still dey rise after INEC declaration of Bola Ahmed Tinubu of di All Progressives Congress as di president-elect.
Dis na some of di tori wey fit bring give una all di informate:
- Nigeria presidential elections results 2023: Bola Tinubu win Peter Obi, Atiku Abubakar
- Breakdown of Nigeria presidential election results wey show who win wia
- 'We win di 2023 presidential election and we go prove am to Nigerians'
- 'Nigeria 2023 presidential election no be di legacy wey Buhari promise'
Nigerians prepare for guber polls on Saturday: Simple explainer on how to vote,

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerians dey head to di polls again on Saturday 11 March, 2023 to vote for gubernatorial and state assembly elections.
For dis explainer, we break down how to vote on election day into seven simple steps to guide you.
Step 1:
For di polling unit, join di queue. INEC official go check if you dey di correct polling unit and confam say di PVC wey you present, na you get am.
Step 2:
INEC official go use di card reader to confam and check say your PVC na original. Dem go ask you to put your finger ontop di card reader.
Make we enta step 3
Di official go ask you for your PVC and confam say you dey for di Voters Register. Dem go tick your name and put ink for your finger to show say you don vote. If dem no see your name. You no go fit vote.
Step 4:
Di Presiding officer go stamp, sign and endorse your ballot paper. Dem go give you di ballot paper wey dem fold small, di area wey dem print ontop go dey inside and dem go direct you go di voting cubicle.
Step 5:
Stain your finger wit di ink wey dem give and mark di box for your preferred candidate/party. Roll di ballot paper back just like dem give you and make am flat.
Step 6:
Now comot from di voting cubicle and drop di ballot paper inside di ballot box.
Step 7:
Leave di Polling Unit or you fit even wait if you want, to watch di process until dem declare di result.
Remember say e dey illegal to take foto of your ballot paper or allow anybody to take di foto. If you do am, you fit land inside gbege wit security agencies.
Five things INEC wan do for Govnorship election

Wia dis foto come from, INEC
Di Independent national electoral commission don promise say ‘’BVAS go work well’’ for di Govnorship and state house of assembly election wey go hold on Saturday 11 March
Prof Mahmood Yakubu give di assurance afta e meet wit official of di commission for di kontri capital, Abuja.
Dis dey come days afta di commission declare Bola Tinubu of di ruling APC party winner, wit 37% of di votes for presidential election.
According to di election join body 28 states go hold Governorship elections in di coming days and Prof Yakubu say ‘’Di Commission don intensify di review of di technology to ensure say di wahala wey we experience, particularly wit uploading of results during di presidential election dey sorted.’’
‘’We dey confident say going forward di system go work well.’’ E add.
Oda tins INEC say dem go do ahead of di guber polls:
- INEC go do refresher training for ad hoc staff wey take part for di last election.
- On election day, INEC go use di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).
- INEC say di (BVAS). Na for voter accreditation and result management.
- All staff wey dem catch say e dey careless, whether dem be regular or ad hoc officials, including Collation and Returning Officers, no go dey involved for di forthcoming elections.
- RECs go take disciplinary action against anybody wey dem get evidence say e do wrong.
Una welcome!
We welcome una to di BBC live coverage of events around di 2023 Nigeria elections as 31 out of di 36 states of di federation go decide who lead dem for di 11 March govnorship and house of Assembly election.
Follow us hia for all updates from di Independent National Electoral Commission (INEC) , plotical parties and candidates plus all oda stakeholders for di elections.
