Goment say flooding for Nigeria don kill more dan 600 pipo

Authorities for Nigeria say di number of pipo wey don die as a result of flooding across di kontri don rise to at least 603 and more than 1.3 million odas dey displaced.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Scroll down to check out di latest on flooding for Nigeria, We go dey update una on di mata as e dey happen

    Na for here we go pause our reporting on flooding wey dey occur for Nigeria. As new updates dey come we go dey give una.

  2. Declare Bayelsa 'state of disaster emergency'-Bayelsa caucus tell Buhari

    One group, Bayelsa Caucus don joinbodi wit Bayelsa State Govnor Douye Diri to beg Nigeria President Muhammadu Buhari to declare state of disaster emergency for Bayelsa state, Southern Nigeria.

    For one statement wey dem release, di group say di satate don dey completely cut-off from di rest of di kontri , as di major road wey di link di dem to oda parts of kontri, di East-West Road don dey washed off sake of di erosion from di flood.

    Dem decribe wetin dem dey face as "multi-faceted and perilous times".

    Di group dey beg for sharp sharp intervention from goment and private agencies to support di state to reduce di duffering of di displaced pipo.

    Former Bayelsa State Govnor Seriake Dickson and six oda pipo na im signed di statement.

    @Bayelsa State Goment

    Wia dis foto come from, @Bayelsa State Goment

  3. Fuel scarcity kontinu to hit Abuja capital sake of flood, E don pass one week now and fuel still dey scare,

    Motorists for Abuja, di Nigerian capital dey queue for hours to buy petrol sake of fuel scarcity since last week and di situation neva improve.

    Authorities say di cause of scarcity na sake of di flooding for Kogi state wey don leave may trucks trapped.

    Di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) for one advisory statement blame di massive flooding for Lokoja, Kogi state as e don disorganise supply.

    “Di Authority wish to tok say na unprecedented flooding for Lokoja dey cause di fuel queues wey don submerged a greater part of di ity and grounded all vehicular movements.

    "Dis unfortunately don affecte di distribution of petroleum products to di Federal Capital Territory, Abuja and environs,”

    Many filling stations dey closed and di few wey dey sell fill up wit queues as black marketers business dey boom.

    Some dey sell 10 litres gallon between N3,500 to 4,000 naira and fuel price increase for some areas.

    BBC
    BBC
  4. Flood take ova school for Lagos community

    Two school boys dey walk on wooden bridge

    Community primary school na popular school for di Itowolo Ikorodu axis of Lagos state southwest of Nigeria, most residents of di area dey send dia pikins to di school.

    But di school na victim of yearly flooding wey dey lead to closure of di school evri year.

    Wen di floods come, di school children and dia teachers dey waka through di flood water into dia classrooms and do same wen dem close in di afternoon. Di water no dey enter di classrooms.

    Wen di flood water increase, di teachers go direct di school kids to stay home until di floods dry.

    Since September dis year, flood take over di school

    Tori be say di school don make efforts plenti times to get help from goment so di flood no go dey disrupt dia academic activities, but goment no do anytin year in year out.

    Di school leadership approach di community leadership wey bring money for di construction of di wooden partial bridge.

    Lagos Sate Commissioner for Education, Folasade Adefisayo no gree comment on di mata give BBC Pidgin say, "I dey in charge of 1,700 schools for di state".

  5. Taskforce visit IDP camps for Rivers

    Flood victims

    Wia dis foto come from, Rivers State 2022 Flood Rescue Taskforce

    Wetin we call dis foto, Di Taskforce use boat boat oda IDP camps for Ndoni wey dey close to di Rivers Niger

    Rivers State Taskforce on di 2022 Flood Disaster Management, don begin provide relief materials and support to victims of ravaging flood for Rivers State.

    Rivers State Governor Nyesom Wike bin don relase one billion naira and set up a six man taskforce wey go help victims of di flood disaster for di Orashi region wey dey worst affected.

    Di team visit Erema primary school I and II, for Ogba/Egbema/Ndoni Local Goent Area of Rivers State, wia some Internally Displaced people dey camp.Dis IDP camp get a total of 1200 pipo and a few of dem dey sick and di team provide medical treatments for dem.

    Di team also go Ndoni with boat to see some displace pesins and houses wey dey submerged by di flood and dem visit di IDP Camp close to River Niger wia dem dey camp for one sand filled area.

    Chairman of di taskforce George Nwaeke say dem dey plan mobile Clinic cos of di special concern for women and pikins for di IDP camps amd dem go hoin bodi wit di local goment chairmen for immediate evacuation from any place wey dey completely flooded.

    Di team also visit Ibocha and Egbema community to see di level of flood and devastation for di area.

    Flood victims

    Wia dis foto come from, Rivers State 2022 Flood Rescue Taskforce

    Wetin we call dis foto, Di Flood Taskforce dey plan mobile clinic for women and pikins wey dey suffer sake of di flood for di interior communities
    Flooding in Onelga

    Wia dis foto come from, Rivers State 2022 Flood Rescue Taskforce

    Wetin we call dis foto, Many communities dey submerged by di flood
  6. UK to help provide assistance to di victims of flood

    Minister for Africa for di Foreign Commonwealth & Development Office, Gillian Keegan say di UK dey ready to support Nigeria to provide assistance to pipo wey dey affected by di flood wey dey ravage states for di kontri.

    She tok am for tweet wia she say di UK goment go also 'help Nigeria make progress towards longer term climate adaptation and resilience.'

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    So far Nigerian goment say ova 600 pipo don die sake of di flod and Ova two million pipo dey affected.

  7. ‘Give all help to Bayelsa’ - President Buhari order emergency agencies

    President Buhari

    Wia dis foto come from, Garba Shehu

    Wetin we call dis foto, President Buhari don direct agencies wey dey concerned to work to restore normalcy after di flood

    President Muhammadu Buhari don express sadness for di devastation wey flooding dey cause for Bayelsa State.

    For statement wey im media aide, Garba Shehu sign, di President tok sorry to all di families of victims and all those wey dey affected by dis natural disaster.

    According to reports by di State Goment, over 700,000 pesins dey displaced by di flood in about 300 communities and villages in five of di eight local goment areas as dem dey submerged in water due to rains wey dey cause di floods.

    While authorities for di State dey take steps to help pipo wey dey suffer di floods, di President don direct all federal agencies wey dey deal with rescue and disaster management to offer all needed assistance to Bayelsa.

    President Buhari blame building on water channels, disregard for early warning by di National Emergency Management Agency, NEMA, and changes to weather caused by climate change as di cause of di floods wey so far don hit 33 of di 36 states of di kontri as well as di Federal Capital Territory wey also dey affected.

    Di President also direct all agencies wey dey concerned to work to restore normalcy throughout di affected parts of di federation.

  8. Pipo dey use canoe go dia house sake of flood for Kogi

    Nigeria Flood
    Wetin we call dis foto, Mohammed Sani Gambo use canoe to get around im neighbourhood

    Nigeria dey suffer dia worst flooding in ten years and dis don force 1.4 million pipo from dia homes.

    Di central city of Lokoja, Kogi state dey for one of di worst-affected areas and residents here dey do dia best to cope with di flood.

    For di past three weeks, Mohammed Sani Gambo dey use canoe to get to im home.

    Di fisherman and father of 11 na one of di lucky few for im neighbourhood of Gadumu.

    E dey live for one two-storey building and e gatz to move im family and belongings to di top floor, away from di flood water.

    "Wen di water first start to dey rise, we think say e no go dey dat serious", e tok.

    "But by di next day, di whole place dey flooded."

    Nigeria Flood

    Now, na 27 pipo dey live for two rooms for di op of im house.

    Dem left to with mattresses, sofas, pots and pans - anything dem fit carry away from di rapidly rising water.

    "Not everyone wey dey live here right now be my family," e add.

    "I also take in some neighbours wey get no places to go. I no fit leave dem out there, so I take dem in."

    E don live for dis area for over 10 years and dey used to di flooding, but dis year dey different.

    "Di volume of di water dis year dey higher than for before years. Di water dey higher. Because of di volume of si water, we don see snakes and oda rodents."

    Nigeria Flood
    Nigeria Flood

    Kogi state no be stranger to seasonal flooding.

    Di capital, Lokoja, dey for di confluence of two of West Africa's biggest rivers - di river Benue and di river Niger.

    During di rainy season di rivers dey overflow dia banks, causing flooding.

    Local authorities say poor building practices also dey partly to blame.

    Nigeria flood
  9. NEMA don flag off distribution of grains to flood victims

    Grains Sokoto

    Wia dis foto come from, NEMA

    Wetin we call dis foto, NEMA oga Habib Mustapha as e dey inspect di bag of grains for Sokoto

    Di Director General of National Emergency Management Agency NEMA Alhaji Mustapha Habib over di weekend flag off distribution of grains for victims of di 2022 flooding for Sokoto state.

    Di exercise wey happun for Kasarawa central store inside Sokoto metropolis see di NEMA oga alongside state goment officials inspect di bags of grains wey dem go distribute to pipo wey di flood render homeless and jobless.

    Di NEMA boss say dem go continue to support and helep pipo wey dey suffer because of di worst foooding wey Nigeria don see in many years.

  10. Water dey come! FG draw ear give dis states goments to begin evacuate pipo,

    Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq meet wit stakeholders for Abuja

    Wia dis foto come from, @FMHDSD/Twitter

    Humanitarian Minister don warn State Governments, LGAs on more floods wey still dey come.

    Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouq warn state governments, local government areas and community leaders especially for Anambra, Delta, Cross River, Rivers, and Bayelsa states, of di floods wey go come in di coming weeks.

    Dem call on state governments to begin evacuation of psins wey dey live along water channels and oda areas wey dey block di flow of water.

    Di Minister tok am for one press briefing on Sunday for Abuja as she dey emphasize goment efforts to reduce d disaster for di kontri.

    She say di number of pipo wey don die and di property wey don damage don increase.

    Ova 600 pipo don die and ova two million don dey affected.

  11. Explainer: Wetin dey cause flood for Nigeria?

    Some states inside Nigeria like Kogi, Jigawa, Kebbi and Bayelsa and more than 20 odas dey experience wetin authorities don describe as di worst flood to hit di kontri in ova a decade.

    BBC Pidgin torchlight wetin dey cause dis devastating flood wey don lead to ova 600 deaths and affect millions of pipo and di next step goments dey take.

    Skip Instagram post
    Allow Instagram content?

    Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of Instagram post

  12. 'Wait till flood reduce before you travel go Bayelsa' - Bayelsa CP, Flooding don cut off di roads wey dey lead into Bayelsa from Rivers and Delta State

    Commissioner of Police, Bayelsa State Command, Ben Okolo don advise pipo wey wan travel to Bayelsa State to wait till after di Floods before dem travel.

    Dis na beos di heavy flooding don cut of di roads wey dey lead into Bayelsa State from di two neighbouring States of Rivers and Delta States.

    Di CP tok dis one for di security meeting wey hold for Goment House Yenagoa say di State security council don resolve to add all heads of security agencies for di state into di state flood committee to ensure say di relief materials get to di victims, even as dem dey provide security for displaced pesins for dia camps.

    E say di council don advise petroleum marketers not to take undue advantage of di situation to make unnecessary increase in di price of petroleum products and also cut warning to criminal elements not to cause more pain for pipo wey already dey displaced from dia homes.

    Road wey flood cut

    Wia dis foto come from, BYSEMA

    Wetin we call dis foto, Flood don cut di Amassoma road
    Flooding for Bayelsa state

    Wia dis foto come from, BYSEMA

    Wetin we call dis foto, Many roads and communities dey covered by di flood wey get very strong current wey don sweep away many farmlands
  13. Fotos: Pipo for IDP camps as flood sack communities for Delta

    Many villages don move to IDP camps sake of di flooding for Burutu

    Wia dis foto come from, Flooding in Delta StateWIA DIS FOTO COME FROM,DESOPADEC MEDIA

    Many villages dey covered with di flood for Bomadi

    Wia dis foto come from, DESOPADEC MEDIA

    Wetin we call dis foto, Many villages dey covered with di flood for Bomadi
    Pipo wey dey pack comot form dia house sake of di flood

    Wia dis foto come from, DESOPADEC MEDIA

    Wetin we call dis foto, Pipo wey dey pack comot form dia house sake of di flood
  14. Nigeria ‘overwhelming’ flood don kill more dan 600 pipo

    Nigeria flood

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Nigerian authorities say di number of pipo wey don die sake of di flooding across don kontri don rise to at least six-hundred and three (603) and more than 1.3 million odas dey displaced.

    Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouk give di update for one press conference for di capital Abuja on Sunday.

    Di minister tok say more than 200,000 houses don dey destroyed.

    And di flood don also seep plenti farmland away.

    Dis year flooding na di worst in many years. She describe di disaster as ‘’overwhelming’’ adding say di kontri no dey ‘’completely out of di woods’’ yet because more flooding dey expected to worry in di coming weeks.

    Nigeria meteorological agency don warn say di disaster fit continue to happen until di end of November for some states like Anambra, Delta, Rivers, Cross River and Bayelsa for di south of di kontri.

    Madam Farouk call on di authorities for di states at risk of more floods to evacuate pipo wey dey live in vulnerable areas.

    She tok say upon effort and earlier warning to avoid di effect of dis year floods, ‘’many state goments no prepare’’ for di disaster wey cause di death toll and destruction to rise well-well.

    Di humanitarian affairs minister tok say di authorities now dey provide relief materials - including food and non-food items to di victims of di floods.

    Di floods na as a result of usually heavy rains, emergency release of excess water from dams inside Nigeria and for neighboring Cameroon and di impact of climate change.

    Experts also say poor infrastructure and lack of proper planning dey worsen di destruction wwey di flood cause.

    Water don cover most of di communities wey dey affected for di north and di south of di kontri. Many families dey struggle to cope.

  15. Medical doctors start medical outreach for victims

    Di Bayelsa State Goment don do Flood Rescue Medical Outreach, through di Ministry of Health, to deliver free medical services and palliative care to displaced communities for di state.

    Di teams dey provide medical consultation and care, health education against di flood, give medication.

    Medical treatment

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Free medical outreach for IDP camps for Bayelsa State

    Dem also dey carryout COVID-19 tests and vaccination; screening for tuberculosis; distributing insecticide-treated nets and dignity packs(menstrual pad,soap, cream, toothpaste and brush, towel) as well as blankets.

    Di teams so far don visit Agbura, Igbogene, Akenfa, Etegwe, Okutukutu, Obogoro, Zarama, and Tombia, Sampou, Kalama, Adagbabiri, Kaiama, Boro-Town, Odi, Oruma, and Imiringi, Bolou-Orua and Sagbama.

    Di goment dey beg pipo to dey calm as oda teams dey come with more support and encourage all to dey hopeful cos e go soon shall pass.

    More teams dey head out to Yenagoa main town, Akenfa, Agudama, Gwegwe and Ox bow lake wia many displaced pesins dey take shelter.

    Flood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Flood victim with dignity packs wey get menstrual pads, soap, tooth paste and brush with towel
    Flood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Di medical teams dey also do Covid-19 tests for di displaced pesins
    Flood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Flood victim with her new born bay for Bayelsa State
    Flood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Di Medicak teams dey give medications to di flood victims
    Foood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Flood victims with some palliatives for Bayelsa State
    Flood victims

    Wia dis foto come from, Bayelsa Min of Health

    Wetin we call dis foto, Many flood victims for Bayelsa State dey sleep outside in di open
  16. Fotos: Flood take over houses, roads

    Pictures of how flood take scata communities Bayelsa states.

    • Nigeria Flooding 2022: Pictures of how flood take scata communities for Rivers, Delta and Bayelsa states
    Flooding for Akinima, headquarters of Ahoada West LGA of Rivers State reach roof level as many houses dey totally submerged in di flood

    Wia dis foto come from, MADU DAB MADUEKE

    Wetin we call dis foto, Flooding for Akinima, headquarters of Ahoada West LGA of Rivers State reach roof level as many houses dey totally submerged in di flood
    House inside flood

    Wia dis foto come from, MADU DAB MADUEKE

    Pipo inside canoe ontop flood water

    Wia dis foto come from, MADU DAB MADUEKE

  17. Saudi Arabia tok sorry to Nigeria over floods

    Di goment of Saudi Arabia don tok sorry to di Nigeria goment ove di flood wahala wey dey affect almost every region of di kontri.

    Inside one statemen wey dem share ontop dis verified Twitter handle, di Arab kontri through di Ministry of Foreign Affairs ''expresse Saudi Arabia condolences to di Federal Republic of #Nigeria over di recent rains and floods wey don hit di kontri.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. 'Universities no go fit resume for Bayelsa sake of flood' - Douye Diri,

    Governor Douye Diri

    Wia dis foto come from, Bayelsa Goment New Media

    Wetin we call dis foto, Schools for Bayelsa State don clause sake of di flooding

    Baylesa State Governor Douye Diri say even though di di Academic Staff Union of Universities ASUU don call of dia strike action, universities for di State no go fit resume academic work becos of di flood disaster di State dey suffer.

    Six out of di 8 local goments for di State dey suffer di flood disaster wey don sack many communities and disaplce many families.

    Dis local goment areas wia di universities dey sited like Ogbia wia di Federal University Otuoke dey, Amassoma wia di Niger Delta University dey and Sagbama wia di University of Africa dey for Tori-Orua, all dey suffer di devastation of di flooding.

    "As we speak, di Academic Staff Union of Universities (ASUU) don call off dia strike but as universities dey open, our own state university no go fit open becos di only road wey link di university dey broken into three parts.

    Di only road wey link Opokuma and Sabagreia for Kolokuma/Opokuma Local Goment Area and di only one wey also connect Sagbama to Ekeremor wey still dey under construction don break. There is hunger and palpable tension in the state."

    Also primary and secondary schools for di State don also close sake of di flooding.

    Raid wey flood don destroy for Bayelsa State

    Wia dis foto come from, Bayelsa Goment New Media

    Wetin we call dis foto, Di flood don destroy roads wey dey link to places wia universities dey sited for Bayelsa State
  19. APC govnors chairman donate N50m to Jigawa flood victims

    Govnor of Kebbi and Jigawa

    Wia dis foto come from, Jigawa govt

    Wetin we call dis foto, Govnor Atiku Bagudu and im Jigawa state counterpart Abubakar Badaru

    Govnor Atiku Bagudu of Kebbi state wey also be chairmo of ruling APC govnors for Nigeria don donate N50 million to victims of flooding for Jigawa state wey dey northwest Nigeria.

    Govnor Bagudu visit Dutse capital of Jigawa to condole with di pipo over di flooding wey don destroy plenty homes and farmlands across di state.

    “As a businessman i believe Jigawa govnor go helep im pipo bounce back from dis problem especially farmers wey don lose dia farmlands to dis floods.” Govnor Bagudu yan.

  20. 'Declare flooding In Bayelsa, oda States as national emergency' - Douye Diri, Flood don cover six out of di eight LGAs of Bayelsa State,

    Douye dey inspect impact of Flooding

    Wia dis foto come from, Bayelsa Goment New Media

    Wetin we call dis foto, Six out of di eight local goments for Bayelsa State dey suffer serious flooding

    Bayelsa State Governor, Senator Douye Diri, don ask di Federal Goment to declare national emergency on di flood wey don damage lives and property for di state and oda states for di kontri.

    Governor Douye Diri tok dis one for one emergency security council meeting wey hold for Goment House, Yenagoa with heads of various security agencies to assess di flood situation and see ways dem go take address di impact of di natural disaster.

    Governor Diri lament di magnitude of dis flooding say, "Dis year flooding don pass dat of 2012, wey bin be di highest we don witness so far. E don become a security emergency.

    Bayelsa dey below sea level and wen di flood come, almost evriwia dey flooded. Even di Goment House dey threatened."

    Diri add say di flooding don seriously impact communities, homes and road infrastructure, and dis don cut off Bayelsa from neighboring states of Rivers and Delta states as di roads don cut sake of di flood." E tok.