Queen Elizabeth II funeral service for Westminster Abbey dey attended by 2,000 pipo, wey include foreign royals, world leaders and UK public figures.
Live Coverage
Jelilat Olawale and Helen Oyibo
Una bye-bye!
Na here we go end our live updates of di funeral of Her Majesty Queen Elizabeth di II today.
We thank una wey stay wit us.
But before we go, we leave una wit dis info say later on dis evening, for private family service, dem go bury di Queen togeda with her late husband, di Duke of Edinburgh, for di King George VI memorial chapel wey dey located inside St George's Chapel.
Her marble slab go dey engraved with ELIZABETH II 1926-2022.
Di Royal Family go return to di chapel around19:30 for di private event.
Meanwhile, you fit scroll down again to catch up with how di burial waka today.
Una goodnight!
Some personal moments for di Queen burial
Wetin we call dis foto, Di Princess of Wales wear one necklace wey once belonged to di Queen and diamond earrings wey di Queen bin give her
Di Queen funeral dey full of tradition, but some personal touches dey too.
Corgis: Two of di Queen beloved corgis - dogs - Muick and Sandy wait for di procession wey dey carry her coffin to St George's Chapel inside Windsor Castle.
Jewellery: Di Princess of Wales wear one four-row Japanese pearl choker necklace wit diamond clasp, wey bin once belong to di Queen. Di Queen, wey commission di design using cultured pearls from di Japanese goment, bin wear am regularly for di 1980s and 1990s.
A lone piper: Di service for Westminster Abbey end to di sound of bagpipes, wey di Queen personal piper play. For 70 years, largely without exception, di Piper to di Queen go play each morning for 15 minutes under di Queen window, whenever she dey dia.
Flowers: At King Charles III request, di wreath for Her Majesty funeral contain flowers and foliage wey dem cut from di gardens of Buckingham Palace and Clarence House for London - and Highgrove House for Gloucestershire.
A favourite hymn: Di Lord My Shepherd be one of di hymns wey di 2,000 mourners sing for Westminster Abbey. Dem say na personal favourite of di Queen, and dem bin also sing am for her wedding to di Duke of Edinburgh for 1947 for Westminster Abbey.
Highlights of di events wey happun today
Wia dis foto come from, PA Media
Wetin we call dis foto, Dem comot di Sceptre and crown from di Queen for di final time
Dis na di highlights
of di events wey happun:
Di day start
wit di end of di Queen lying-in-state period, and di procession of her coffin
to Westminster Abbey
Around 2,000
pipo attend di funeral service including many heads of state
Den a larger
procession march wit di coffin of Elizabeth II to Wellington Arch: na landmark
wit triumphal significance for British history
Afta dat dem
place di late sovereign for one car and drive her go Windsor
Di third procession
of di day see di King and oda royals waka behind di Queen car as dem take her to
St George’s Chapel for a committal service wey 800 pipo attend
Later - by
19:30 - di Royal Family go return to di chapel for one private event wey go see
Elizabeth buried alongside her late husband, di Duke of Edinburgh
A period of
royal mourning go continue for anoda week - until September 26
Who attend di Queen funeral - and who no go?
Service of committal for Queen Elizabeth II don end
Wia dis foto come from, EPA
Di committal service for Queen Elizabeth II don end for St George Chapel inside Windsor Castle, west of London.
Towards di conclusion of di ceremony, di Dean of Windsor remove di royal crown, orb and sceptre, from di Queen coffin and place dem on di altar.
Dem come lower her casket into di Royal Vault for St George Chapel for Windsor Castle, ahead of private burial service later.
Pictures inside St George's Chapel
Wia dis foto come from, PA Media
Wia dis foto come from, PA Media
Wia dis foto come from, PA Media
Wia dis foto come from, PA Media
Wetin we call dis foto, Di Lord Chamberlain ceremonially break im wand of office and place on di coffin
Committal service for Windsor Castle don start
Dem don place di Queen
coffin wia e go rest for di service. Di bearer party don comot and di Royal
Family don take dia seat.
Di Choir dey
sing Psalm 121, music by Sir Henry Walford Davies, who be former Organist of
di Chapel.
We go also hear di
Russian Contakion of di Departed, dem sing am for di funeral of di Duke of
Edinburgh.
Wia dis foto come from, PA Media
Wetin we call dis foto, Di moment dem carry Queen Elizabeth II coffin into St George's Chapel for Windsor Castle, Berkshire
King and senior royals join di procession
Senior members of di Royal Family join di procession as di state hearse approach St George Chapel.
King Charles III, Princess Anne, Princes Andrew and Edward, as well as Princes William and Harry dey waka behind di hearse.
Procession don reach Windsor Castle
See di procession as e pass into di Quadrangle of Windsor Castle into Engine Court.
E go now pass di Norman Arch, Chapel Hill, Parade Ground and di Horseshoe Cloister Arch - wia one guard of honour dey wait di funeral party.
King Charles III and oda senior royals dey expected to join di procession.
Wia dis foto come from, bb
Committal service go feel smaller and more intimate
Around 800 guests go
dey St George Chapel for di Committal Service.
E dey smaller and
more intimate dan di funeral service for Westminster Abbey dis morning.
Dis na di
equivalent of di Queen parish church during di years she live for di castle. Na
wia she worship for Easter and celebrate baptisms, confirmations and weddings
during her reign.
Na wia she say
her own final farewell to her husband Prince Philip.
Dem go lay di
family flowers for di foot of di altar – e go provide flashes of colour on di chapel
floor.
Tori be say dem
discuss di details of di Committal Service wit di Queen ova di years.
But di final hymn no
be her choice. Dat one dem leave am to di Dean of Windsor and di King. Dem choose
Christ Is Made di Sure Foundation.
Royal corgis wait for di Queen
Wia dis foto come from, Reuter
E no go be tribute to di Queen without di presence of her beloved corgis.
Camera snap Muick and Sandy as dem dey await di procession wey carry di Queen coffin to St George's Chapel.
Now, dem dey under di care of Prince Andrew and im former wife, Sarah Ferguson
Final moments for pipo to see di coffin
Dis na di final moments for di public to see di hearse - di vehicle wey dey carri di coffin becos once e enta inside di gates of Windsor Castle, members of di public no go fit see am.
E go only be those wey don come to di chapel to take part in di service.
So dis na like di last sighting of di of di Queen coffin wey her subjects go see, except of course if dem watch am for television.
In pictures: State hearse dey travel di Long Walk for Windsor
Wia dis foto come from, Reuter
Wia dis foto come from, Reuters
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin go happun dis afternoon?
Di Queen coffin go
arrive for Windsor shortly.
Dis na wetin we dey
expect to happen next
15:06 BST– Di state hearse - vehicle wey dey carri di coffin go
arrive for Windsor and join di awaiting procession
15:10 – Di procession up di Long Walk
go begin
15:40 – Di King and oda members of di
Royal Family wey dey walk in di procession go join for di Quadrangle for di
North side as e pass into Engine Court
16:00 – Di Committal Service for di Queen go
take place for St George's Chapel for Windsor Castle. E go end wit wen dem
lower di coffin inside di Royal Vault.
19:30 – For a private family service,
dem go bury di Queen togeda wit her late husband, di Duke of Edinburgh, for
King George VI memorial chapel, wey dey inside St George's Chapel.
Checkout some of di uniforms on display for Queen funeral procession
Di
Queen coffin dey escorted by bearer party from di Grenadier Guards, di King
Body Guards of di Honourable Corps of Gentlemen at Arms, di Yeomen of di Guard
and di Royal Company of Archers.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, GettyUK/MoD/BBC Images
Crowd dey throw bouquets of flowers
Di vehicle wey dey carri di coffin now dey move alongside two lines of pipo on either side as e dey drive towards Windsor Castle.
Di crowd dey throw bouquets of flowers towards di vehicles.