Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. BBC Pidgin Minute

  2. Good night!

    Na here we go end our live updates of tori across Nigeria, Africa and di world today.

    You fit scroll down to read today tori dem.

    Join us again on Monday by 9:00am.

    Bye -bye!

  3. Zimbabwe inflation rise to 250%

    Zimbabwe annual inflation done rise to more dan 250%.

    Dis na di highest level e don reach in one and a half year.

    Wit inflation wey dey rise since February, many Zimbabweans dey struggle to cope.

    Authorities blame coronavirus pandemic for di inflation and di high global prices on fuel, grain and fertiliser.

    Local shortage of American dollars to pay for imports don also contribute to di rising cost of basic goods and services.

    On Monday, di central bank release gold coins to di market as attempt to cushion inflation by reducing di appetite for US dollars.

  4. Meet di African wey be di first official Photo Editor for America Vice President Kamala Harris

  5. Kenya Salaries and Remuneration Commission scrap allowances for new lawmakers

    Kenyan lawmakers dey among di best paid for di world

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Kenyan lawmakers dey among di best paid for di world

    Incoming Kenya members of parliament no go enjoy di sitting allowance wey previous lawmakers wey dey attend plenary sessions dey collect.

    Di Salaries and Remuneration Commission wey dey arrange state workers salaries say di new members no go enjoy dis sitting allowance.

    Di body say dem go save 382m Kenya shillings per year from di cuts wey go affect 416 members of di lower and upper parliament houses.

    Kenyan lawmakers na some of di best paid for di world as dem dey collect monthly taxable pay of about $5,000 plus generous allowances.

    SRC also reverse di $17,000 car grant for county representatives – wey dem controversially approve last year.

    Di body no touch di president and deputy president salary.

  6. Atiku lie against me - Wike

  7. ‘Atiku never reach out to me’ - Wike,

    Governor Nyesom Wike

    Wia dis foto come from, RVGH PRESS

    Wetin we call dis foto, Governor Wike say wen go soon tok about wetin really happen for di PDP presidential primaries

    Rivers State Govnor, Nyesom Ezenwo Wike say e dey unfortunate di comments wey some members of di People’s Democratic Party PDP allegedly make against am afta di conduct of di PDP presidential primaries on 29/30 May, 2022.

    Governor Wike say di right tin such pesins suppose do, particularly di PDP presidential candidate, Alhaji Atiku Abubakar or di PDP national chairman, Senator Iyorchia Ayu, na to reach out to am, but dem never do so.

    Govnor tok dis one for di international wing of di Port Harcourt International Airport, Omagwa, afta im return from Spain.

    Govnor Wike say Alhaji Atiku Abubakar use di occasion of di unveiling of di PDP vice presidential candidate, Govnor Ifeanyi Okowa of Delta State, and im appearance for one national television to lie against am.

    Wike say e dey unfair and very soon im go let Nigerians know at di appropriate time, afta di commissioning of projects wey dem don line up wetin really happen so dat posterity and history go dey on dia side and dem go keep di records straight.

    “Make nobody dey in doubt, I go speak on di issue of PDP, issues of di primaries and oda related matters.

    Nigerians go know wetin happun, Nigerians go know those wey love dis kontri, Nigerians go know wetin happun behind and I assure you say I go tok on dat.” E tok.

  8. Ukraine dey ready for first grain ship inside Russia deal

    President Zelensky dey for Odesa ontop hope of di first shipment

    Wia dis foto come from, Telegram/Zelensky

    Wetin we call dis foto, President Zelensky show for Odesa ontop hope of di first shipment

    Di first grain ship from Ukraine since Russia invade di kontri dey ready and dey wait for di signal to comot port, according to President Volodymyr Zelensky.

    E dey speak on im visit to di port of Chornomorsk, afta di UN aid chief say di ship fit leave as soon as Friday.

    Authorities sign one UN-led deal a week ago to resume exports afta one blockade wey make food price rise.

    One source tell Russian media say e fit happun, depending on circumstances.

    With hopes say e go happun, President Zelensky join ambassadors from di G7 industrialised nations for di Black Sea coast, to stand in front of di Turkish-registered ship Polarnet.

    While dem dey load di ship with grain, officials say anoda 17 ships already dey full with 600,000 tonnes of cargo.

    Meanwhile, UN aid chief say exports fit only resume safely wen di route through di Black Sea dey finalised.

    Under di agreement signed by Russia and Ukraine, di sea corridor, convoy and inspection of di cargo dey organised by a joint co-ordination centre (JCC) for Turkey and final preparations still never dey in place according to reports.

  9. Poll show say Kenya presidential race dey tight

    One new poll show say Kenyan presidential race dey on a statistical tie.

    Raila Odinga, di opposition leader wey dey run for a fifth time, dey lead with 46.7%, im challenger William Ruto, di current deputy president, dey on 44.4%.

    Support for di oda two presidential candidates don drop, both of dem dey poll below 2%.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    As e stand, di two candidates go enta a rerun 30 days afta di 9 August election.

    According to Kenya constitution to win for di presidency for di first round, a candidate require:

    More dan half of all di votes cast for di election and at least 25% of di votes cast in each of more dan half of di 47 counties.

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  10. Man City vs Liverpool Community Shield match prediction

  11. Our minds don ease now after di death sentence - Hanifa father

  12. Abuja residents hear gunshots near Zuma rock Thursday evening

    ZUMA ROCK

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Abuja residents say dem hear sound of gunshots around Zuma rock on Thursday evening.

    Eye witnesses tell BBC say di attackers attack one military checkpoint on Thursday evening and open fire.

    But police and security agencies never tok on dis mata wey happun for di kontri political capital, at di time of dis tori.

    Abuja dey on high alert since dis month attack on Kuje prison.

    One eyewitness say, di shooting make dem run leave dia car for road to di forest for shelter.

    "We leave our cars unlocked and run into di forest, we go there near Madallah u-turn, we come from Abuja to go to Suleja, afta about 15 to 30 minutes, we dey lucky say we turn around and we go carry our car and turn ," di eye witness tok.

    E further explain say even wen dem comot di place, di gunmen continue to open fire.

    Efforts to hear from security officials about wetin truely happun still dey on.

    Dis attack dey happun less than one month afta Boko Haram group attack Kuje Prison for Abuja, Nigeria capital, wia many prisoners escape.

  13. 2022 Commonwealth Games open for Birmingham with style

    Dia Animatronic Bull

    Wia dis foto come from, Getty Images

    2022 Commonwealth Games open for Birmingham with style of ceremony ey dey both captivating and hopeful for Alexander Stadium.

    Nobel Peace Prize laureate Malala Yousafzai shock pipo for surprise to tok about di importance of education while diver Tom Daley show im support for di LGBTQ+ rights afta di baton relay finish.

    But di biggest shock na di 10m tall animatronic bull wey just run enta di stadium as part of di ceremony to honour di multiculturalism of Birmingham and di Commonwealth.

    Nigeria, Ghana and Cameroon na some of di African kontris wey rep for di opening ceremony, dis na how dem tanda demselves

    Team Nigeria for di Commonwealth Games

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Team Ghana for di Commonwealth Games

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Team Cameroon for di Commonwealth Games

    Wia dis foto come from, Getty Images

  14. Stray Ostrich die afta six-hour highway drama for South Africa

    Stray Ostrich

    Wia dis foto come from, Ostrich Rescue Centre

    One stray ostrich wey pipo see dey run for highway for South Africa commercial capital, Johannesburg, don die on Thursday morning hours afta wildlife protection group gbab am.

    Di Owl Rescue Centre say efforts to bring back di 70kg (154lbs) ostrich afta e collapse no dey successful.

    "Di stress to dey for dat highway for six hours and di stress of di rescue just dey too much for her,"it said.

    Videos wey pipo share for social media show di bird dey run for highway as cars dey pass.

    Di Owl Rescue Centre say attempts by dia staff to mobilise police officers for one roadblock near N14 highway and take di bird to safer area dey ignored.

    "Dey no gree to assist and say make we no let our animals run freely for main roads," dem tok for statement.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. How President Akufo-Addo sack Ghana 'absentee' Gender Minister

  16. Nigeria Army change top ogas as security threat worse

  17. Ugandan tok-tok pesin confront mayor on live TV

    Di mayor of Uganda capital, Kampala, on Thursday enta kwanta wit di goment tok-tok pesin on live TV before di debate turn confrontational and di talk show stop prematurely.

    Lord Mayor Erias Lukwago, of di opposition FDC party, and goment tok-tok pesin Ofwono Opondo dey among four panellists for di show to debate about dia just-concluded by-election.

    Di debate turn hot and clips shared on Twitter show Oga Opondo dey tell di mayor "I fit push you out of here".

    Oga Opondo later stand over di mayor inside exchange of angry words before dem take di programme off-air.

    Di NBS station say all panellists commot di studio safely and apologise to viewers.

    Mayor Lukwago bin tweet say di experience dey "horrible" and despicable".

    "My only prayer be make I get out of dis place safely," e add.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. Welcome to Friday reports

    Good Morning!

    Welcome to awa live reports for today.

  19. Barca dey eye Reguillon, Marseille enter talks with Sanchez

  20. Nine steps to impeach a Nigerian President - Simple guide