Bye-bye!
Na here we go march break for our coverage of di judgement ontop di case PDP and Atiku carry go di domot of di presidential election tribunal for Nigeria.
We thank una, we hail, good night!!!
Nigeria Presidential Election Petitions Tribunal judgement live as e dey happun
Helen Oyibo, Princess Igho Williams, Daniel Semeniworima and Fiona Equere
Na here we go march break for our coverage of di judgement ontop di case PDP and Atiku carry go di domot of di presidential election tribunal for Nigeria.
We thank una, we hail, good night!!!
Nigerians don begin dey react to di tribunal judgement ontop di Atiku vs Buhari case.
Govnor of Lagos state Babajide Sanwo Olu say di victory na final lap of relay race wia di real winner dey show at di end of di finished line.
For di former Govnor of Lagos State, Akinwunmi Ambode, di ruling confam di second term mandate wey di pipo give President Buhari.
Rivers state Govnor Nyesom Wike don also congratulate Buhari. Im tell am to use di victory to work for all Nigerians.
Meanwhile for former Aviation Minister wey be strong critic of President Buhari Femi Fani-Kayode, today judgement no suppose surprise anybody.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Peoples Democratic Party (PDP) say dem completely reject di judgment of di Presidential Election Petition Tribunal wey dem describe as provocative and something wey no bring justice.
Di party release one statement afta di judgement wey dem title:
Di verdict na subversion of justice, PDP tok...We dey go Supreme Court.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria President Muhammadu Buhari say di ruling of di Presidential Election Petition Tribunal ontop di February 23, 2019 poll, na victory for Nigerians wey come out in dia numbers to elect am for a second term in office.
He dedicates the victory to God, and to Nigerians, while also commending the judiciary for “dispensing justice without fear or favour.”
President Buhari extends a hand of fellowship to those who had felt aggrieved at the outcome of the election, and went to court, noting that it was within their democratic rights.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Peoples Democratic Party say dem go meet with dia legal team to decide dia next line of action.
National Chairman of PDP Uche Secondus tell tori pipo dis wan afta di judgement wey dismiss dia petition to cancel di victory of President Muhammadu Buhari.
Di presidential election petition tribunal dismiss Atiku and PDP petition say dem no prove dia case.
Oga Garba wey lead di five man panel for di court of appeal for Abuja tok for im judgement say:
Di leading judge, Muhammed Garba say Atiku and im party accuse say security pipo dem and some APC agents do violence plus buy vote and do oda election wuru-wuru, but justice Garba say Atiku and PDP fail to call witnesses from di 11 focal states wey mainly be north.
"Di fact say dem no call any witness wey sign di form dey bad for di case and di burden of proof for sections 131 and 136 of di Evidence Act bin no clear.
Oga Garba further explain say di petitioners neva prove any of di grounds of their petition for Paragraph 15 and because of dat, di petition no fit hold ground and e dismiss am sharperly and kpata-kpata.
Di Presidential Election Petition Tribunal don dismiss Atiku petition.
Di Tribunal say di petition lack substance and Atiku and PDP no fit prove all di allegation wey dem make.
Dis wan dey come afta almost seven hours of reading judgement.
With dis judgement, di tribunal stamp di election wey give Buhari victory.
Di court of di Appeal venue wia Justice Muhammed Garba dey give im judgement full yakata.
Lawyers, politicians and supporters of di two major pipo, President Muhammadu Buhari and Atiku Abubakar also join for court to hear dis ogbonge judgement.
Di leading Justice, Muhammed Garba build im judgement on top five issue wey come up during di hearing for tribunal.
Out of dis five issue dem, di tribunal don give im answer to three already and e remain two for di tribunal to finish di case and pass judgement.
Nigerians don enta inside social media to tok dia mind on top di election Tribunal judgement concerning President Muhammadu Buhari and Atiku Abubakar.
Dis na some of di tins dem dey tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Tribunal don uphold say President Muhammadu Buhari qualify to contest and dat no evidence dey to show say e no go school .
One of di major issue wey Atiku and im party PDP bin cari go election tribunal na say president Buhari no get qualification- dat is im no go school and dat e no qualify to contest.
Atiku also bin tell court say di President give false information to INEC concerning im educational qualification.
Di tribunal say di candidate no dey required by di Electoral Act to attach im certificate to im Form CF001 before di candidate go show say im dey qualify to contest di election.
Oga Garba argue say Atiku and im party fail to show say di affidavit wey Buhari submit no correct.
Di Presidential Election Tribunal don resume.
Nigerians dey wait to hear how di mata go end today, wetin di judgement go be?
Di Presidential Election Tribunal don conclude di first leg to announce im judgement for di 2019 Presidential Election.
Di court go give ruling on top all di pre-election mata.
Justice Muhammed Garba wey be di lead judge of di five panel of judges spend nearly 3 hours to give di ruling before e march break to give di court time to rest.
On Electronic voting, di court dismiss dat one and say Suprem court don chook mouth on top di mata.
Di Tribunal say di court no get hand for di mata and so w dismiss di mata And security involvement in aiding rig election.
E say since all dis security formation no join bodi for di case, di court no fit judge di mata as dem no dey part of di case.

Also on di issue say Muhammadu Buhari lie on top INEC form to fit contest, INEC say na pre- election mata and di court say true true pre- election mata.
Afta e address INEC application, di Court begin chook mouth on top Buhari application and di court say di issue wey Buhari dey bring say Atiku Abubakar no qualify to contest sake of say e be Cameroonian, no hold water and dat Buhari supposed don file anoda case for dat one before
Before Justice Mohammed Garba go pass judgement, e say e go first give rulings on top all di pre-hearing session Di first issue wey im chook mouth na di issues raised by INEC wey be di first respondent for di mata.
INEC bin say di Court gatz join Vice President Yemi Osinbajo for di mata if not di court no get power to listen to di mata.
But say dat one no hold water as both im party di APC and di Presidential candidate wey select dey ably represented for di mata and anytin wey affect dem, go affect am.
And so im no need to join body for di mata. INEC also say PDP lawyer, Livy Uzoukwu wey sign dis witness document no fit practice law for Nigeria but di court say dat one no be true and dat im qualify to practice law for di kontri

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Nigeria Presidential Election Petitions Tribunal don begin deliver judgement, ontop di petition wey di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar carry go dia domot to challenge di victory of President Muhammadu Buhari for di 2019 elections.
Na for August 21 2019, all di parties dem make dia final statement ontop di mata and di tribunal bin tok den say dem go decide wen dem go judge di case later.
Di PDP and dia candidate wan make di tribunal cancel di election of President Muhammadu Buhari for di February election, come declare Atiku winner ontop accuse say wuru-wuru full di election.
Inside di petition wey dem submit for di presidential election petition tribunal for Abuja, PDP and Atiku claim say: "Di data from INEC server, from result wey dem collate from state to state show say Atiku get 18,356,732 votes to defeat Buhari who dem say score 16,741,430 votes.
With dis one, dem claim say Atiku win Buhari wit 1,615,302 votes.
INEC bin declare President Buhari winner say im get 15,191,847 votes, to defeat Atiku, who dem say get 11,262,978 votes.
Di opposition also base dia petition ontop oda tins.
Dem say Buhari no qualify to run for di office of di president ontop say im no get di minimum qualification of school certificate.
PDP and Atiku dey ask di tribunal to return Atiku as president of Nigeria, as na im win, or make dem cancel di presidential election of February 23 and conduct anoda one.
Di loser for dis case still get chance to appeal di case for Supreme Court.

Adams Oshiomhole and Ministers from President Muhammadu Buhari cabinet dey court dey await di judgement.
Uche Secondus di National Chairmo of di main opposition Peoples democratic party PDP. dey court too.

Security don tight for Court of Appeal venue of wia election tribunal go deliver judgement on top di presidential election for Nigeria