Visual Guide to the Women’s Africa Cup of Nations in Morocco (COPY) (COPY) (COPY)


Visual Guide to di Women’s Africa Cup of Nations for Morocco


Dis go be di 15th time wey African women go battle am out to be crowned continental champions.
However, di history and formats of previous competitions no dey straightforward like dat.
Di 2024 Women’s Africa Cup of Nations (Wafcon) - wey Caf postpone until dis year becos of problems wit scheduling - go see 12 nations compete for di title for Morocco, wia 26 games go take place for six venues wey spread across five cities.
Di HISTORY
Di first African Women’s Championship take place for 1991 to determine who go be di continent representative for Fifa first ever Women’s World Cup. Eight teams bin suppose take part for knockout format using home-and-away ties, but four nations withdraw and Cameroon reach di final without playing a game.
Nigeria thrash di Indomitable Lionesses 6-0 on aggregate to become di first champions of Africa. Four years later, di Super Falcons triumph again as dem waya South Africa 11-2 over two legs for di final.
However, those first two competitions no traditionally dey considered part of Wafcon history (and therefore dem no dey included for di statistics inside dis article). We begin from 1998 wen di tournament become eight-team event wey one country go host every oda year, wit di introduction of group stages.
Nigeria welcome di continent for di first edition and reign supreme - and no-one else fit topple di West Africans for 2000, 2002, 2004 and 2006 either. Na for 2008 wia hosts, Equatorial Guinea, finally dethrone di Super Falcons.
Na for 2016 di tournament name change to di Women’s Africa Cup of Nations, to rhyme wit di men’s competition.
Di 2020 edition no ever take place becos of di coronavirus pandemic. Wen Wafcon return for 2022 Caf expand di tournament, now wey e dey feature 12 teams, new winner appear in di form of South Africa, wey beat hosts Morocco to wipe away di pain of four previous defeats for di final.

WINNERS AND RECORDS


Only three nations don ever win Wafcon. Nigeria go hope to win dia 10th title for Morocco, while Equatorial Guinea don lift di trophy twice (both times as hosts) and South Africa once.
Cameroon, Ghana and Morocco na dem be di only other teams wey don reach final.
South Africa don finish as runners-up on four occasions, Cameroon and Ghana don lose three finals.



Wit 34 goals, Perpetua Nkwocha from Nigeria na im be di all-time leading scorer for Wafcon. A four-time golden boot winner, her 11 goals for 2010 still stand as di record for a single tournament.


HOST NATIONS
Caf cancel di 2020 tournament because of Covid-19 pandemic.


MATCH VENUES AND HOST CITIES



Di FORMAT
Di group stage go see 12 teams drawn into three groups of four.
Di top two go advance to di quarter-finals along wit di two best third-placed teams.
PLAYERS TO WATCH
Asisat Oshoala (Nigeria)
Now she dey play for Bay FC for USA National Women Soccer League (NWSL), di 30-year-old striker go bring experience and a winning mentalitity for wetin go be her sixth Wafcon finals.
Di six-time African women footballer of di year bin help di Super Falcons win di continental title for 2014, 2016 and 2018, and since den she also don lift di European Champions League twice wit Barcelona.
Although she no dey score like bifor since she move to United States,Oshoala still bin ogbonge player and she go likely be di for Nigeria to reclaim di Wafcon crown.
Clara Luvanga (Tanzania)
Luvanga dey think big, she bin tell BBC say she want to be di best player for Africa, and already she don win dit title two times for Saudi Arabia wit Al-Nassr.
Di 20-year- old striker certainly get di opportunity to learn from di best, both Cristiano Ronaldo and Sadio Mane dey di roster for her club men team. Luvanga score 19 goals last season, wey put her forth for di Saudi Pro League charts.
She score for all four of Tanzania Wafcon warm-up matches to prove say she get eye for goal plus her pace and power. Defenders go know about her ability to run in behind, but di kwesion na if dem fit stop her.
Sanaa Mssoudy (Morocco)
Di forward form for 2024 see her collect di most valuable player for African Women Champions League and pick up di award for di best inter- club player for Africa.
Di 25-year-old also collect di best player award for Moroccan league last season, afta she play key role to help AS FARwin dia 12th domestic title.
Masoudy score for both di quarter- and semi-finals for di last Wafcon, Wit her skill wit di ball, Di kwesion na if she fit give di Atlas Lionesses di ginger to end dia wait for continental glory?
Jermaine Seoposenwe (South Africa)
South Africa go look up to di highly- experienced Seopoenwe for goals - especially afta Thembi Kgatlana wey bin win di golden for di 2018 Wafcon, pull out of di squad sake of personal reasons.
Like Kgatlana, Seoposenwe wey dey born for Cape Town dey play her club football for Mexico. Di 31-year-old Monterrrey forward na one of di senior players for Bayana Bayana, wey make her debut against Zimbabwe back for 2021.
Wit more dan 100 caps to her name, Seoposenwe don tok say she go retire from international football afta Wafcon. She go need to score regularly for her sixth finals if South Africa hope to defend dia title.
Aissata Traore (Mali)
She bin score four times for di qualifiers as di West Africans breeze past Central African Republic and Guinea to return to di finals for di first since 2018.
Di 27-year-old na di joint-top scorer for Fleury for France Premiere Ligue for 2024-25, wit nine goals as di club finish just outside di European qualification places.
Part of di Mali squad wey finish fourth for di most recent Wafcon apperance. Na Traore and her strike partner wey dey play for Paris St- Germain both of dem dey very good form. Dem go hope to repeat dia goal scoring form wey dem show for di qualifiers.
Barbra Banda (Zambia)
Banda na goal machine.
Wit 10 goals wey spread across di Tokyo and Paris games, she be Africa all- time leading scorer - male or female - for Olympic football, while di reigning BBC Women Footballer of di Year finish second for di NWSL standing last season, wia she score crucial goal to give Orlando Pride 1-0 victory for di Championship final.
However, di 25-year-old striker neva score for Wafcon, she been miss di 2022 finals. Second wey dey di list of Africa most expensive female players, Banda go wan fix di goal issue for Morocco.




GOALS BY TOURNAMENT



PRIZE MONEY
Last time out, total Wafcon prize money double, e increase from $975,000 (£720,000) for 2018 to $2.4m (£1.8m) for 2022. Di winner South Africa receive $500,000 (£370,000)



ATTENDANCE
More dan 50,000 fans bin watch di 2022 final between Morocco and South Africa for di Prince Moulay Abdellah stadium for Rabat- na record for Wafcon match.




WHO GO WIN?
All roads now lead to di Olympic Stadium for Rabat for di final on Saturday, 26 July.
Di new 21,000- seater facility dem construct am as part of di wider redevelopment of di historic Prince Moulay Abdellah Stadium complex. Di larger venue, wey bin host di 2022 Wafcon final, dem dey rebuild am for use during di 2025 African Cup of Nations and di 2030 World Cup.
Morocco don invest huge amounts into football, so dia women team fit do dia bit to win dia first Wafcon title? Nigeria, Zambia and holders South Africans na di oda favorites wey dey look to stop dem.
Credits
Na Ian Williams and Rob Stevens write am
Thiago Braz design am
Additional research na from Eshlin Vedan
Images: Getty Images and BackPage Pix






