List of clubs wey go lose dia players to Afcon 2025

Mbeumo, Osihmen, Traore and Iwobi

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Some teams dey lose as many as six players
Read am in 6 mins

Di 35th edition of di Africa cup of nations (Afcon) dey around di corner.

All di teams don name dia final squads – in fact most teams already land for Morocco to prepare for di tournament.

Di tournament go begin wit group A clash between di hosts and Comoros wey e go last for four weeks.

During dat time, some teams for Europe go lose some of dia players wey go dey di championship.

Dis go affect teams wey get plenty call-ups or teams wey dia key players dey go fight for dia national teams for Africa.

Dis be some of di teams wey go lose dia top players to continental tournament.

Afcon trophy

Wia dis foto come from, FAREED KOTB/ANADOLU VIA GETTY

Wetin we call dis foto, Di kontris go battle to win di trophy wey Ivory Coast currently dey hold as defending champions

Clubs wey go lose plenty players

  • Manchester United

Di red devils still dey struggle to string three to four straight wins for di league. Dia coach Ruben Amorim dey under pressure to deliver afta he fail last season. Manchester United dey sixth for di league table but dem now go lose three of dia key players for di Afcon.

  • Bryan Mbeumo (di Cameroon forward be di top scorer for Manchester United wey he play almost every game for dem so far)
  • Amad Diallo (Ivory Coast go need di form of di winger wey be one of di creative players for United.)
  • Noussair Mazraoui (di Moroccan go hope to help his kontri keep do Afcon for dia home – at a time United dey struggle wit defensive options.)

Ruben Amorim tok afta dia team play 4-4 draw wit Bournemouth say "Amad and Mbeumo go lerf for di Afcon now – we gatz to try and find solution wit di players we get." "We det ready to cope, we go try to find a way to score di goals in a different way."

  • Sunderland

Sunderland wey surprise many fans dis season wit dia performances – go lose up to six players for di Afcon. Di team wey currently dey eighth position for di league table, spend plenty money to gather players afta dem get promotion to di premier league.

Out of di six players wey dey go di Afcon, some be key players wey play most of dia games so far dis season.

  • Noah Sadiki (di DR Congo midfielder wey dem nickname 'mini Kante' play almost every game for Sunderland so far)
  • Arthur Masuaku (di DR Congo player feature three times so far for di club)
  • Reinildo Mandava (di Mozambique defender play almost three-quarters of Sunderland games)
  • Bertrand Traore (Burkina Faso call-up di experienced forward for dia Afcon campaign)
  • Chemsdine Talbi (host Morocco go count of di forward to boost dia chances as he be regular for di black cats)
  • Habib Diarra (di most expensive summer signing for Sunderland go help Senegal for di Afcon even though he no play regular football for Sunderland sake of groin injury for September)
salah, hakimi and aubameyang

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Salah be di only player for liverpool, Hakimi wey dey injured be one of two players from PSG; Aubameyang also be one of two players from Marseille wey dey go di Afcon
  • Galatasaray

For Turkey, Galatasaray dey lose four players for di Afcon including in-form striker Victor Osimhen. During di time of di tournament, di club go play two super league matches and one or two super cup matches. Di club dey top of di league wit only three points above Fenerbahçe wey dey second.

  • Victor Osimhen (di Nigerian striker be di lifeblood of di super eagles team wey dem go count on am to lead from di front at di tournament at a time dia captain Troost-Ekong don retire from international football. Di striker be key player form Galatasaray wit six goals dis season.
  • Wilfried Singo – (di Ivorian play at least 10 official games for Galatasaray dis season. Di defender go try to help di defending Afcon champions to retain dia cup.
  • Mario Lemina – (for di Gabon star, dis be di time for national duty, even though he don play 19 games so far for Galatasaray; meaning he be key player for di Turkish club. Gabon go hope di central midfielder go bring his club form to di Afcon.)
  • Ismael Jakobs – (di Senegalese defender since he join Galatasaray from Monaco on loan play many games. He be one of di key players for di club.)
  • Fulham

Fulham dey try to climb into di top half of di premier league table – but dem gtaz to do dat without three of dia key players wey dey go di Afcon. Marco Silva go dey without three Nigerian players.

  • Alex Iwobi – (one of di key players for di Fulham midfield wey also dey contribute goals)
  • Samuel Chukwueze (di attacker togeda wit Iwobi don contribute more than one-third of Fulham goals dis season.)
  • Calvin Bassey (di defender play every single game for Fulham dis season; di team go miss am for di Afcon).

For di French league,

Paris FC (5) - Samir Chergui (Algeria), IIan Kebbal (Algeria), Hamari Traore (Mali), Moses Simon (Nigeria), Jean-Philippe Krasso (Ivory Coast)

FC Lorient (5) – Aiyegun Tosin (Benin), Montassar Talbi (Tunisia), Arsene Kouassi (Burkina Faso), Darlin Yongwa (Cameroon), Arthur Avom Ebong (Cameroon).

OGC Nice (4) – Hicham Boudaoui (Algeria), Yehvann Diouf (Senegal), Antoine Mendy (Senegal), Ali Abdi (Tunisia).

Lille (4) – Aissa Mandi (Algeria), Hamza Igamane (Morocco), Chancel Mbemba (DR Congo), Ngal'Ayel Makau (DR Congo).

Angers SCO (4) – Ousmane Camara (Mali), Jacques Ekomie (Gabon), Jim Allevinah (Gabon), Harve Koffi (Burkina Faso)

FC Metz (4) – Habib Diallo (Senegal), Cheikh Tidiane Sabaly (Senegal), Jean-Philippe Gbamin (Ivory Coast), Uriel-Michel Mboula (Gabon)

Le Havre (3), Stade Rennais (3) and Paris Saint German (2) also go lose players.

Depending on di performance of dia national teams for di tournament, dis players go dey away from 21 December 2025 to 18 January 2026.