'Tinubu for fit solve di political crisis for Rivers state before dis time'

'Tinubu for fit solve di political crisis for Rivers state before dis time'
    • Author, Helen Oyibo
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Lagos

Governorship candidate for di 2023 election for Rivers State Tonye Cole don tell BBC Pidgin say e tink say declaring a state of emergency for im state no be good tin and suppose be last card for President Bola Tinubu.

Inside exclusive interview wia e react to di latest for di Rivers State crisis, Cole say President Tinubu get di power to solve di political issue before now witout declaring a state of emergency.

Declaring a state of emergency no go solve di political issue wey be di koko of di problem, e tok.

E also add say declaring a state of emergency don take di state back plenti years and go affect di economy of di kontri as well as di pipo.

On di suspension of Govnor Siminalayi Fubara, e say dat decision fit open doors for court cases to question di legality of Tinubu decision, dis one e say go also put di state for one place.

Dis na as e add say di president decision wey declare a state of emergency for Rivers state and suspend di govnor witout tackling di oda party, imply say di fault of di two fighting parties come from di side of Govnor Fubara.

Filmed and edited by Idara Monday