Nigerian Army react to claims of alleged oppression by senior officers

Wia dis foto come from, Nigeria Army/Facebook
Di Nigerian Army don react to one video wey dey make di rounds on social media.
For one post on X (former Twitter), di Nigerian Army tok say dem don begin investigate di tori of one young female soja wey allege say her superiors dey oppress her.
Di army say dem go take appropriate actions based on di findings of di investigation.
Dia reaction dey come afta one video wey show as one young female soja lay serious allegations against some senior army officers begin trend on social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin di female soja tok for di video
Di female soja wey no mention her name but wey go by di name @Ogunleyeruthsavage1 on TikTok, bin recently share her distressing experience on di platform.
She lament how Senior Army officers wey she identify as Col. IB Abdulkareem, Col. GS Ogor and Brig. Gen. IB Solebo – bin don dey oppress her since she dem post her go Cantonment Medical Centre, Ojo, Lagos for 2022, sake of say she refuse dia sexual advances.
She say if anything do her, na di officers dey responsible.
For inside di video, di female soja claim say one of di senior officers, Abdulkareem bin make repeated attempts to assault her, give her injections against her will, forcefully eject her from her apartment, lock her up for psychiatric hospital.
End of Di one wey oda users dey read well well
She add say di officer bin hinder her career advancement as e no allow her take promotional courses because she allegedly reject im advances.
Dis article contain content wey TikTok provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di TikTok cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of TikTok post
“For 2022, dem post me go Cantonment Medical Centre, Ojo, where I meet Col IB Abdulkareem wey ask me out but I no gree. Ever since then, dis man don become my nightmare for di Army as e dey threaten to dismiss me each time.
“He come my room to eject me from my apartment. E send some boys to my house. If I dey lie, I get all di evidences. I get evidence against am and I get witnesses.
“He also stigmatise me say I get mental illness. Each time I try to expose him or each time any senior pesin or any senior officer try to intervene, he will tell them I have ae go tell dem say I get mental illness.
“He freeze my account for one year. February last year till date, no salary.” She tok for di video.
According to her, her father don try to intervene for di mata but Col. IB Abdulkareem no gree.
She tok say di colonel tell her father say she gatz obey di “last order”.
She add say she know di consequences of her action before she come out make di video.
“I know definitely dem go come for me. Dem go lock me up and dem go dismiss me but I no care. I no fit endure again. Before coming out to make dis video, I no fit endure again. I no wan die young.” She tok for di video as she beg Nigerians for dia support.
How di Nigerian Army react
Di Nigerian Army post on X assure Nigerians say dem as institution dey committed to upholding di integrity and morals of dia personnel.
And on top dis mata, dem go take appropriate actions based on di findings of dia investigation.
Dem ask Nigerians to allow di investigative process take its course and no rush make judgements.
Meanwhile on Friday, 12 January, di Director of Army Public Relations, Maj. Gen. Nwachukwu Onyema for inside one statement tok say di female soja no inform relevant bodies and institutions about her predicament before she release di video.
However, dem don take up di mata and don begin investigation to confam di extent of her claims, e tok.












